One man describe how im six-year-old pikin escape di Catholic school kidnapping for Niger State

Father of one of di abducted children inside di dormitory of di school. E dey look some clothes wey dem hang for bed for di school.
Read am in 6 mins

Parents for Niger State, northern Nigeria, still dey inside pain and sorrow as dia pikin still dey for hand of bandits afta dem kidnap dem from St Mary's Catholic boarding school on Friday.

Di bandits invade one boarding school for Niger State wia dem gbab more dan 300 school students wey include primary and secondary school for St Mary's Catholic boarding school.

Speaking exclusively to BBC, di papa of one six-year-old child wey escape abduction from di school for Nigeria don describe how dem take reunite.

"Wen I see am," Lucas, - wey we change im name to protect am, - tok say "I just too happy."

"I call am im name, e turn, run come meet me. I hug am, hold am well."

Lucas say im pikin tell am say di children for St Mary's Catholic boarding school for Niger State, Northern Nigeria, dey sleep wen dem hear di sound of di kidnappers.

Di kidnappers break dia windows, scatter di glasses and force dem wit gun make dem open di door while dem still dey half-sleep.

While some children climb jump comot for di barbed wire fence wey dey surround di school, im own pikin small, e no fit climb, so e hide instead.

Even though Lucas don reunite wit one pikin, two of im older boys still miss.

303 students and 12 teachers na im dem carry from di school for Papiri town, even though authorities say at least 50 children later escape.

According to our sources, di 50 students wey dem say escape no come directly from di kidnappers camp, na di number of pikin wey manage escape between di hours wey dem kidnap dem reach late Sunday evening.

Di figures match di audit wey Christian Association of Nigeria publish earlier. "We fit confirm am wen we begin visit and contact some parents."

BBC Madina Maishanu say none of di parents wey she don tok to don reunite wit dia children inside di last 24 hours.

Dis announcement don cause confusion for many parents. Some don camp outside di school wia dem kidnap dia children, as dem dey worried and frustrated why nobodi tell dem di news directly.

"Why we dey see dis news for social media and govment no dey reach us direct? We never still see our children."

Niger State Govnor, Umar Bago, tok for local media interview say di total number of abducted students don dey exaggerated. "If we do headcount, e dey far below dat."

Di govnor blame di school authorities direct for opening di school afta threat from unknown gunmen four years ago and anoda threat two months ago.

"Schools for dat area don dey closed for four years now, I shock say I hear say di school still dey open."

E still insist say di attack na just 'scare' and say all di oda students go soon or later return. Some parents wey tok to di BBC no satisfy wit how authorities dey handle di matter.

Abandoned clothes from di school dormitory

Parents dey frustrated by govment response

"I no fit explain wetin dey hapun to me now," Peter, not im real name, tok "I never feel bad like dis bifor."

E dey frustrated sake of say di state govnor never visit di school wia di incident hapun, na only nearby community e go tok to security agencies and local leaders.

"So we don conclude say govment no dey concerned about us, we feel like say we no belong to dis kontri, dem don abandon us."

Nearby, Theo, not im real name, stand for di dormitory wia im pikin dey sleep bifor, and na im witness di abduction.

"Dem dey traffic di children on foot like how shepherds dey control dia animals, some children dey fall and di men go kick dem make dem stand," e tok.

"Di gunmen dey use about 50 motorcycles to control dem."

E say e feel powerless to stop di armed men from carrying di children go. E even call police but wen dem reach, e don late.

"I tink to go help, but I tink again, even if I go, wetin I fit do? I no fit do anytin."

Di pain wey di parents of di missing children dey face dey clear.

"I dey sad, my whole life don full wit sadness" one mama tok wey her son still dey miss. "Na my only son, my first born, abeg help us."

Many parents dey vex say authorities no dey do enough to stop kidnappings and abductions wey dey worry Nigeria.

"To say we dey reject or forgotten for dis kontri no even reach," Theo tok.

"Dem kidnap our pikins but govment no seem to send."

Northern part of Niger, wia Papiri dey, don turn hotspot for ransom kidnappings but security still no dey visible for dia area despite di issue.

Many blame di mata on di size of di state. Niger State in terms of landmass na di biggest state for Nigeria, even bigger dan some European kontris like Denmark and Netherlands, and bicos of dat, e get many ungoverned forests wey bandits dey use as camp and route to oda states and African kontris.

Woman dey look inside di dormitory

Di abduction for di school na di third one wey hapun for Nigeria inside one week.

On Monday, more dan 20 schoolgirls, wey BBC bin hear say dem be Muslims, bin dey kidnapped from one boarding school for neighbouring Kebbi state.

One church self suffer attack for Kwara state further south, two pipo die and dozens bin dey abducted. Dem don regain freedom.

Nigeria president don dey point to some actions wey security forces don take.

Bola Tinubu, wey cancel im trip to di G20 summit for South Africa bicos of di crisis, post for social media for Sunday say "all di 38 worshippers wey dem kidnap for Eruku, Kwara State, don dey rescued."

But many actions by authorities still dey look defensive not proactive.

Plenti boarding schools for different parts of di kontri don dey closed sake of fear of mass abductions, and parents dey rush go collect dia children.

Di insecurity wey dey many parts of Nigeria dey clear.

BBC team travel 500 km go Papiri from Niger State capital Minna and di journey get plenty danger; several times dem advise dem to avoid some routes and sometimes police escort dem.

While school and church mass abductions dey make headlines, many Nigerians dey fear ordinary street kidnapping while dem dey do dia daily activities.

Authorities self dey get criticism from outside Nigeria.

Earlier dis month, US President Donald Trump tok say e go send troops come Nigeria "guns blazing" if govment "kontinu to allow di killing of Christians" by Islamic militants.

Nigerian govment call di claim "gross misrepresentation of reality."

One official tok say "terrorists dey attack anybodi wey reject dia murderous ideology Muslims, Christians, and pipo wey no get religion."

While some kidnappings dey carried out by Islamist groups like Boko Haram wey kidnap 276 girls from Chibok school for 2014, many odas na criminal gangs wey dey do am for ransom, dem dey call dem bandits.