Anoda actor wey dem amputate im leg advise Mr Ibu

Popular Nollywood actor Mr Ibu dey face health challenge

Wia dis foto come from, Mr Ibu/Instagram

Wetin we call dis foto, Popular Nollywood actor Mr Ibu dey face health challenge

“I dey advise my colleague Mr Ibu to be positive sake of say too much negative tinkin fit affect im health."

Na so Sani Idris aka Moda wey be popular actor for Kannywood movie industry for northern Nigeria tok.

Like John Okafor (Mr Ibu), Moda too amputee wey doctors cut im leg few years ago sake of diabetes.

Dem don amputate di leg of popular Nollywood actor and comedian, John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu.

One of im family member, Chioma Okafor announce am for im Instagram account on Monday, 6 November.

She post say “As at 1pm today, Daddy don go through seven successful surgeries but to keep am alive and increase im chances of recovery, dem gatz amputate one of im legs.”

Chioma add say di development dey hard on di family but dem don accept dia papa new reality to keep am alive.

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Sani Idris wey act for ‘Wasila’ one of di legendary Kannywood movies for di year 2001 tell BBC News Pidgin say e dey advise Mr Ibu to dey positive about wetin happun to am.

“Wen I hear im tori e just remind me of my own case five years ago sake of say na di same tin happun to us.

“For my own case I bin no know say i get diabetes until my leg start give me problems and by di time I reach hospital di situation don worse.”

Moda wey dey use prosthetic leg at di moment recall di kain love e receive from pipo when dem announce say dem go amputate im leg.

Sani Idris

Wia dis foto come from, Sani Idris/BBC

Wetin we call dis foto, Sani Idris alias Moda

“E get many pipo and organisations wey show me love wella and I no go forget dem even former Zamfara govnor Bello Matawalle call to ask me how much be di prosthetic leg I go like use and I tell am and e buy," Moda tok.

Moda say wetin happun to Mr Ibu no suppose mean di end of im acting career.

“As I dey so notin wey I no fit do, if acting job come I dey always ready and I also dey kontinu my work as assistant director for Kaduna Arts Council.

“So na opportunity for Mr Ibu to start a new chapter wey go give am beautiful memories as I dey experience so.

“My last advise na for am to take doctors advise seriously to avoid all di tins dem tell am make e no chop or drink.”

Mr Ibu actor for sometimes now don dey struggle wit im health but di nature of im sickness no dey clear.

Recently, for one video wey di actor post on im Instagram account wey go viral, e show as e dey beg im fans to help and pray for am.

Di actor tok say im don dey hospital for sometimes now sake of one "strange and dangerous illness”.

E say doctors don recommend make dem cut im legs.

“As I dey speak to you, I still dey lie down for hospital; di medical director of dis hospital say di best solution be say, in case im new idea no work, di best idea na to cut off my leg”

"All I dey hope for na your prayers and assistance," e tok for di sick bed wit im wife and daughter dia.

E don undergo seven surgeries before doctors finally cut im leg.

Di family say dem still dey beg for di support of well meaning Nigerians as dia papa still dey fragile stage and e need all di help e fit get.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

Mr Ibu no be di first actor wey don appeal for public assistance sake of im ill health.

Several Nollywood actors don at one point or di oda need to go public about dia health so as to raise money for treatment.

Dis don raise plenty questions on why some celebrities dey result to public for money anytime dem sick to settle dia medical bills.

Some pipo argue say dem no dey too make money from acting - dis don raise eye brow as some say e dey contrary to di lavish and luxurious lifestyles wey some dey always portray.

However, according to reports, top Nollywood star actors dey collect between two million to three million depending on dia negotiation, while di minimum amount of money wey low level actors dey take home per movie na notin.

Di money actors dey earn depend on dia roles for movies and how di audiences like di characters wey dem dey portray for di movie.

E dey also depend on di actor negotiation but some low level Nollywood actors no dey collect money for dia roles becos producers fit promise dem say dem go become famous afta di production.