Five tins you suppose know about Nigeria contactless passport renewal

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigerain immigration authority don announce one ogbonge change for contactless passport renewal system wey dem introduce recently.
Olubunmi Tunji-Ojo for statement wey im drop on Friday say im dey pleased to announce one ogbonge advancement for dia national service delivery under President Tinubu, as dem launch di Contactless Passport Renewal System across Europe, afta di successful launch for Canada.
E say na mark of anoda achievement for immigration authority as e show say dem commit to streamline and boost govment services for Nigerians both at home and abroad in line wit di Renewed Hope agenda of dis administration.
"As wit di case in Canada, dis innovative system design go end di traditional gbege wey link to passport renewals," e tok.
Now, eligible Nigerians wey dey Europe fit renew dia passports entirely online from di comfort of dia homes and offices".
Tunji Ojo tok say no be say di initiative go help reduce di inconvenience of travel and long waiting times but e go also bring di services of di Nigeria Immigration Service (NIS) directly to user digital doorstep.
Dem say as dem introduce di system in Europe further show dia dedication to:
- Efficiency: To allow passport renewals to dey conducted without physical presence. Dis go help to cut down processing times significantly.
- Accessibility: Make sure say Nigerians wey dey abroad experience govment services wit ease, regardless of wia dem dey.
- Modernization: Embrace technology to meet di evri day need of kontri pipo in line wit di pledge to digital transformation of di kontri to di race to achieve di $1 trillion economy ambition of President Bola Tinubu.
- Access to services: Olubunmi Tunji-Ojo say e don become dia duty to make sure say dem get access to services wey match di highest standards of professionalism and efficiency.
- Transparency: E add say govment go kontinu to uphold transparency wey no go tamper wit security for all dia operations.
How to apply for contactless passport renewal process
NIS say Nigerians go fit renew dia passport by demsefs by downloading di NIS mobile app on dia phone, once di app don dey available for dia region or dem fit apply on dia website.
Once dem download di app or visit dia website, make applicants follow all di steps wey dey outlined, and e include:
- Create profile: Applicant wey wan renew dia passport go need register wit valid email.
- Eligibility check: Take one quick eligibility test to ensure say dia passport qualify for renewal.
- Identify details: Provide dia National Identification Number (NIN) plus dia current passport number for verification.
- Personal information and document upload: Enta dia bio-data and upload necessary documents like NIN, birth certificate, local goment certificate, among odas.
- Biometric capture: Applicants go now fit use dia mobile device to capture dia fingerprint biometrics.
- Make payment: complete di online payment to finalize di application process.
- Submit application and wait for processing.
Di agency explain further say dem go process di application and deliver am to di address of di applicant.







