Four reasons why couples go stop to dey have sex

Wia dis foto come from, Getty Images/PeopleImages
Less desire to have sex, low libido, na common problem.
According to di UK National Health Service, decreased libido dey happun inside one in five men, and e fit also affect women too.
Many reasons dey for dis problem and dat no mean say na serious problem. Wetin dey cause am include stress, life stages like pregnancy, childbirth, breastfeeding.
However, continuous excessive decrease in libido dey harmful, and diafore e dey necessary to investigate di reasons for am.
"First, e dey important to know how much libido don actually reduce," Catarina de Morales, secretary of di Brazilian Association of Sexual Medicine and a psychiatrist by profession tok.
E add say, "Sometimes, big confusion dey dey between difficulty in erection, sexual performance, satisfaction and decreased libido, wey dey very different from a lack of libido."
According to endocrinologist Diego Fonseca, bifor dem fit medically diagnose pesin wit low libido, e must show say di symptoms dey for at least six months.
However, Ribeiro Marisca, one expert for di Women Hospital, believe say, "dis period fit vary from pesin to pesin. E depend on di condition of each patient."
As we tok to experts, we find out say di following four reasons fit lead to low libido.
1. Changes in routine and some stages of life
Sometimes, some common reasons dey for decrease in libido like stress, increased tension, tiredness, changes in routine lifestyle and using di time wey you suppose dey use do kerewa do oda tins fit lead to low libido. Sometimes, to take care of children fit dey part of these reasons.
According to Catarina de Moraes, "If libido reduce sake of these reasons, e no mean say you get disease. Sometimes even to dey do kerewa wit your partner fit make libido to decrease ova time."
However, e believe say even if your sexual desire reduce, no need to panic if you dey enjoy sex and you dey feel satisfied wen you do am.
"However, pesin dey get desire for sexual pleasure. If you dey sexually satisfied and your libido dey reduce, then you no need any kind of test."
2. Mental illness
Mental sicknesses like depression and anxiety fit get major effect on libido or di desire to have sex.
According to di psychiatrist, "In depressed patients, imbalance for di brain chemicals serotonin and dopamine, wey dey linked to mood and emotion, fit lead to reduction in sexual desire."
E add say, "Treatment for dos kain cases fit improve sexual desire and libido."
Also, some medications wey dey reduce depression and anxiety fit get side effects on libido.
However, many treatment options dey ground. And one specific method dey to reduce di side effects, wey be make doctors change di medication. Change di dosage of di medication. Focus on exercises wey relate to di behaviour.
Doctors warn patients say if dem experience any of these symptoms, make dem no stop di treatment midway bicos if you no treat depression, e fit affect di libido, and to stop medication for di middle fit also affect libido.
Di psychiatrist add say "make di patient openly discuss any problems related to sex wit di doctor."
3. Hormonal changes
If di patient no get any mental sickness, and e no make any changes for im lifestyle wey fit cause decrease in libido, but e still get dis condition, make di patient consider investigating hormonal changes.
Dr Caroline Castro, one endocrinologist for São Camiro Hospital, tok say na estrogens for women and testosterone for men dey regulate libido.
Estrogen dey associated wit di health of genital cells, vaginal lubrication, and emotional pleasure.
Testosterone dey linked to sperm production, sexual desire, wey dey directly affect mental health, and increase libido.
According to Diego Fonseca, to diagnose di problem for such cases dey very complicated.
"For example, in men, we dey check weda dem get low testosterone levels. We go also check weda dem get medical history of hormonal changes."
Doctors dey also check for oda causes like pregnancy, breastfeeding, and obesity wey fit cause changes in hormones.
Endocrinologist Carolina Castro say, "Dos kain patients fit or fit no need medication. Weda dem need medication or not depend on di patient mental and physical condition, e fit also vary for each patient. For some cases, dem dey give counsel regarding di changes wey dey occur for di body. Therefore, dey necessary to diagnose am very carefully."
4. Oda diseases wey present for di pesin body
Oda very common reasons wey doctors point out na say e get oda diseases and symptoms wey di patient get wey don directly or indirectly affect im libido. For example:
Brain diseases wey include conditions like multiple sclerosis, epilepsy, spinal cord injuries, or peripheral neuropathy. These diseases fit directly affect di body nerves and libido.
Patients wit these diseases fit also get problems wit maintaining arousal, achieving satisfaction, and maintaining healthy desire for sex.
Sake of hormonal changes, diabetes fit also cause low libido. Dat kain condition fit cause neuropathy or fatigue. For dat kain disease, di nerves don spoil. Dis fit lead to decrease in sensitivity. Dis condition fit directly or indirectly affect di desire for sex.
Heart patients fit also get sex-related problems. Sake of di decrease for di ability of di heart to pump blood go di body, di patient fit dey tired.
And for dat kain situation, di desire for sex fit dey low. Even di medicines to reduce heart-related problems fit get side effects. Wey fit affect libido.
Dialogue and treatment
Doctor make am clear to BBC say no melecine fit cure erectile dysfunction, and magic no dey to cure am.
Each case fit dey different, and di treatment fit also depend on di individual condition and outlook.
All doctors advise couples to tok to dia partners about di reasons behind dia low libido.
Diego Fonseca say, "E dey important to tok about dis openly. Even though e fit dey uncomfortable, to tok about low libido go help clear up any misunderstandings. E go give both of you chance to understand di situation and find solution."










