Ronaldo go comot Man Utd wit immediate effect

Wia dis foto come from, Getty Images
Portugal striker Cristiano Ronaldo go leave Manchester United wit Immediate effect.
Dis decision dey come afta di controversial interview wia Ronaldo criticise di club and say im no get respect for manager Erik ten Hag.
Both parties say Ronaldo exit dey "mutually agreed".
"Di club thank am for im contribution across two spells for Old Trafford," Manchester United statement tok.
Dem wish "am and im family well for di future" and add "everyone for Manchester United remain focus on continuing wit di team progress under Erik ten Hag and working togeda to deliver success for di pitch".
Ronaldo dey wit Portugal for World Cup for Qatar and im dey set to captain dem for dia opening Group H game against Ghana on Thursday.
Im be get just ova seven months remaining for im £500,000-a-week contract wit United and im exit mean say im dey free to sign for anoda club wen di transfer window open for January.
"Following conversations wit Manchester United both of us agree to end our contract early," Ronaldo tok for statement.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I love Manchester United and I love di fans, dat no go ever change. But, e feel like say dis na di right time for me to find new challenge.
"I wish di team every success for di remainder of di season and for di future."
For im TalkTV interview last week, Ronaldo say im feel "betrayed by di club" and, how im feel about Ten Hag.
E add say im feel like say dem dey force am out di club.
United bin respond last Friday wit statement to say dem don "begin appropriate steps" to respond.
Ronaldo don comot for Man United
Dis na wetin former Manchester United player Rio Ferdinard tok about Ronaldo exit.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Ronaldo stats for Man United
Cristiano Ronaldo score 118 goals for 292 games for im first spell for Old Trafford before im leave for Real Madrid for 2009.
For dat six-year spell, im win three Premier League titles, one Champions League, two League Cups and one FA Cup - as well as di Fifa Club World Cup and Community Shield.
But dis 18-month spell na just 27 goals im score for 54 games - but no silverware.












