Diddy ex-girlfriend 'Jane' testify for im sex-trafficking trial

Wia dis foto come from, Reuters / Jane Rosenberg
For di fourth week of Diddy trial, we hia wetin one of im ex girlfriends "Jane" tok about dia relationship wey last from 2021 to 2024.
She be di last woman wey di rapper, Sean "Diddy" Combs date bifor dem arrest am for 2024.
According to di woman, dia relationship bin start for one girls trip wey she bin take go Miami.
Di relationship come move from "head-over-heels" love enta relationship wey be say she must to dey sex prostitutes and even sef, e make am dey abuse drugs.
Tori be say dis particular witness, fit take dis case enta Monday bifor even just di direct questioning sef go finish.
She tell di court say di relationship bin start on wetin she call "exciting whirlwind" wia Diddy go carry am go holiday, and ogbonge restaurants dem.
She later testify say Combs later ask am to do wetin prosecutors dey call "hotel nights". Dis na wen Combs go bring prostitute so e go fit to watch am dey nack anoda man.
"Jane" tell di court say she bin reason say na just one time tin but e turn dia relationship to anoda tin.
She tok say she do di oda hotel nights bicos she "really love am" and "bin wan make am happy". But she tok say she bin tell Combs say she bin no wan do again.
She say Combs bin also give am drugs like ecstasy cocaine and ketamine from wen dia relationship bin first start. She also testify say she bin use di drugs wen she dey wit Combs and also for di hotel nights.
Prosecutors bin show court text message from di both of dem for early in dia relationship wia "Jane" tok say she wan nack escort, but na bicos na Diddy fantasy.
But later in dia relationship, around dat kain September 2023, she come dey message Combs say e be like di only reason wey e want am na for "hotel nights", say she no wan do am again but still feel like she need to do am so she go get house to live.
Bicos by dat time, Combs don alreadi dey pay her $10,000 per month house rent for am for di past five months.
Combs bin reply back say, "girl, stop."
Wetin Jane say dey happun during di "hotel nights"
"Jane" start to dey cry as she tell court how di mata of di "hotel nights" bin happun.
Di jury even hear one recording wia Jane tok say she bin dey ask Combs weda she go fit use protection wit di prostitute.
She tell di court say Combs bin dey disappointed wit dat question and na im bin dey control everytin wey bin dey happun for di "hotel nights". She say na Combs dey decide how many prostitutes go take part, how long e go last and wen she go finish.
She also tok say sometimes, she go cry afta di marathon "hotel nights". She tok say she remember wen Combs call am make she come do one short one. Dat "short" one last for 18 hours.
She say Combs bin give her drugs say, "I bin dey so high".
She tell di court say Diddy look disgusted wen e see her as she dey cry and e bin wan comot but she beg am make e stay, as she explain am give court, "I bin just wan dey im arms".
She tell di court say di longest "hotel night" bin last for three and half days.
On a normal day, e fit last for 24 hours to 30 hours without any sleep.
She tell court say na combination of drugs, caffeine and protein shakes.
Jane tell court say her only rule na say make di prostitutes no take drugs bicos she bin no sure how e go affect dia control.
But she tale am so di hotel nights go dey easier and feel less real.

Wia dis foto come from, Reuters / Jane Rosenberg
"Jane" remember say na just two times wey she decide say she no go do drugs to take do "hotel night".
She tell court say na for October 2023, and she bin dey push Combs make e dey sober and healthier.
E gree but say make dem do one last sobriety party wey last 12-18 hours.
She say afta she run di "normal routine" wit two prostitutes, she go vomit for bathroom.
Na so Combs go meet am for bathroom say e good say she don dey feel beta, from wia she don finish to dey throw up, e tell am say di third guy dey wait.
As di testimony dey go on, Diddy just dey look "Jane" from im chair, sometimes e dey look di jury sha.
"Jane" also tell di court tori of di network of employees wey Combs get wey dey help am get drugs.
Dis dey come as one of di charges wey Combs dey face na racketeering. And prosecutors need to prove say e bin dey run criminal business and bin dey conspire to commit crimes.
She say one time Combs Chief of Staff Kristina Khorram bin tell her to carry package of drugs form Los Angeles go Diddy mansion for Miami.
She bin ask if e dey safe to which Khorram tell am say, "e dey fine, I dey do am all di time".
"Jane" come tell court say na so she collect di package from one member of Comb security, carry am as check-in luggage go Miami, and na afta she land she find out say e bin dey full of ecstasy.
"Jane" add for her testimony say she dey normally see Combs as e dey call im assistants and security say make dem carry drugs come di hotels wia she dey nack prostitutes.
But apart from sex wit di prostitutes, "Jane" testify say Diddy bin dey make am to message di men she go dey sexual wit dey ask dem for nudes or to FaceTime dem for im presence but she no dey do dem if Combs no dey.
She testify say na di two of dem dey arrange who go join dem for di "hotel nights".
From May 2021 wen di mata take start till October 2023 wey dem break up small, Jane tok say na almost every week dem bin dey do di hotel nights.
She say e reduce wen dem start to date again from February 2024.
She even remember say for her birthday for 2023, Combs fly am enta Miami to enta three day long "hotel night" wey she bin no wan do but she also bin no wan disappoint am. Combs bin call three different male prostitutes for am for many days afta dinner.
But she say sometimes Combs dey nice as e give her cake and birthday gifts.








