Sean 'Diddy' Combs trial don start - Wetin you need to know

Sean 'Diddy' Combs trial
Read am in 4 mins

Opening statements don start for di federal Criminal trial of Sean 'Diddy' Combs for New York City.

Na jury of eight men and four women siddon and swear in early morning American time.

Hundreds of pipo line up outside a New York courthouse ahead of di start of di trial of di ogbonge musician. Authorities say di Combs trial no go dey televised, sake of di rules of federal court.

Oga Combs don plead not guilty to charges wey include racketeering conspiracy, sex trafficking and transportation to engage in prostitution.

Di music star dey face life in prison if e dey convicted convicted on all counts.

According to Prosecutors, Combs bin force at least three women to engage in sex acts wit am.

And sometimes, wit male prostitutes, during occasions wey dem sabi as "Freak Offs," wia di women dey allegedly drugged and forced to engage in sex for days.

For one statement to BBC about di federal criminal charges, im lawyer say: "Combs and im legal team get full confidence in di facts and integrity of di judicial process.

"For court, di truth go prevail: say Combs no ever sexually assault or traffic anyone - man or woman, adult or minor."

Diddy lawyers later file one motion to dismiss one part of di federal indictment wia dem accuse am of transportation to engage in prostitution.

Im team argue say e bin dey unfairly targeted sake of im race.

For one hearing for New York one week before di trial, im lawyers tell court say di rapper dey live di "lifestyle" of a "swinger" and im no be criminal.

Dem say im bin tink say e dey "appropriate" to get more dan one sex partners, including sex workers.

Who be di lawyers in dis trial?

Teny Geragos (left) and Marc Agnifilo.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Teny Geragos (left) and Marc Agnifilo.

To lead di Diddy defence na Marc Agnifilo, a lawyer wey get experience wit high-profile cases. Agnifilo bin previously defend cult leader Keith Raniere, convicted fraudster Martin Shkreli, and former Goldman Sachs banker Roger Ng.

E also dey represent Luigi Mangione, wey don dey charged wit di murder of UnitedHealthcare chief executive Brian Thompson for dia kontri there.

Also on di legal team na one Teny Geragos, di daughter of popular celebrity attorney Mark Geragos.

Days bifor di start of di trial, di prosecution bin don take issue wit di elder Geragos, sake of content wey e bin share on im podcast - 2 Angry Men.

"I dey here to support my daughter. (Combs) na friend," e tell tori pipo CNN on Tuesday.

Five oda lawyers dey wey deyrepresent Combs. Inside one court sketch from jury selection last week, Diddy dey seen as e hug one of dem, Brian Steel, di defence most recent addition -na im bin represent rapper Young Thug for Georgia recently.

On di oda side, e get eight members of di prosecution, including Maurene Ryan Comey, wey bin don get storied career in di Southern District of New York and bifor bin secure conviction for British socialite Ghislaine Maxwell.