Croatia beat Japan on penalties to reach quarter-finals

Japan1:1 Croatia

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Japan1:1 Croatia

Dominik Livakovic send Croatic into last 8 Croatia beat Japan on penalties to qualify for di quarter-finals of di ongoing Fifa World Cup for Qatar. Croatia goalkeeper na di hero of di night, e save three penalties wey send Japan go house afta dem play 1-1 for full time. Japan first score thru Daizen Maeda for first half Croatia equalize for di second half thru Ivan Perisic. Di match drag enta extra time but nobody score. Croatia wey be di 2022 runners-up enta di last eight wit dia full chest.

Penalty shoot out

Penalties don reach o!

121+5

Croatia don qualify for di last 8!

121 min:

Na Takumi Minamino go okay di first kick for Japan

Japan miss!! goalkeeper save am!

Croatia scores! Nikola Vlasic

Japan Kaoru Mitoma miss second penalty

Marcelo Brozovic score for Croatia!

Takuma Asano score for Japan

Mario Pasalic score Di last penalty for Croatia

Extra time

120+1 Lovro Majer of Croatia bend di ball from di edge of di box wey disturb di goalkeeper but e play am go wide!

116 min:

Borna Barisic(Croatia) collect yellow card afta e tackle Japan player.

113 min:

Di ball dey behind di side line. Josip Juranovic take di throw-in

111 min:

Shuichi Gonda jump to collect ball from corner but Mislav Orsic play am go over!

106 min:

Anoda change, Ivan Perisic don comot and Mislav Orsic replace am

106 min:

Japan and Croatia start second period of extra-time wit substitutions. Ante Budimir make way for Marko Livaja (Croatia)while Ao Tanaka replace Hidemasa Morita (Japan)

First period of extra -time don end!

105 min:

Save! Kaoru Mitoma or Japan beat di pesin wey dey mark am as e fire beta shot from di edge of di box. Dominik Livakovic see di ball late but e stop am make e no enta net!

104 min:

Borna Barisic send anoda cross again but Japan clear am again!

101 min:

Ivan Perisic of Croatia fire shot but Japan defender block am

98 min:

Substitution for Croatia Luka Modric don comot Lovro Majer replace am.

Mateo Kovacic don comot too Nikola Vlasic enta

98 min:

Josko Gvardiol of Croatia cross di ball into di box but Japan defence block am

95 min:

Junya Ito of Japan dey try play fast fast wit di short corner kick.

92 min:

Japan get corner kick wey Junya play but Croatia defence clear di ball

91 min:

Extra time don start

Japan vs Croatia

Wia dis foto come from, Getty Images

Second half

Dis na di first match wey dey enta extra-time for dis FIFA World Cup for Qatar.

Second half don end, we wait for extra time to start

90+4 Di match go enta extra time as nobody win

Four minutes added time

90+1’ Japan player commit foul referee blow whistle.

Two minutes to stoppage time

90 min:

Mateo Kovacic don collect yellow card

87 min:

Substitution for Japan Takumi Minamino don replace Ritsu Doan

86 min:

Miss! Mario Pasalic of Croatia play im header wide!

82 min:

Takuma Asano of Japan dey offside

82 min:

Referee Ismail Elfath blow im whistle afta Wataru Endo of Japan play rough

78 min:

Luka Modric play di corner for Croatia.

77 min:

Ivan Perisic pass di ball from near outside of di box but e go wide off di left post

75 min:

Substitution for Japan Hiroki Sakai don enta field, e replace Daichi Kamada

73 min:

Luka Modricgive short pass to im team mate from corner instead of im to play am inside di box.

69 min:

Substitution for Croatia Andrej Kramaric don comot from di pitch, Mario Pasalic don enta.

64 min:

Substitution for Japan Yuto Nagamoto don comot and Kaoru Mitoma don replace am

63 min:

Luka Modric strike di ball to di top left corner of goal, e raise im hand to celebrate but goalkeeper save di ball.

Mateo Kovacic play di corner but notin come out

63 min:

Croatia win corner kick.

Luka Modric strike di ball to di top left corner of goal, e raise im hand to celebrate but goalkeeper save di ball.

62 min:

Substitution Croatia don make dia first change. Bruno Petkovic don comot, Ante Budimir replace am

60 min:

Yuto Nagamoto of Japan pass di ball to di net but Croatia defence clear di ball.

56 min:

1-1

Dejan Lovren na im give Ivan Perisic di ball, wey beat di defender for air as e play di ball inside di bottom right corner of di net from close range.

56 min:

Goal!

Croatia don score di equalizer! Ivan Perisic na im score di goal for Croatia.

54 min:

Ritsu Doan of Japan wan play corner kick

49 min:

Mateo Kovacic of Croatia fire shot near di goal post from di edge of di penalty box but e shot am wide!

46 min:

Beta strike from Daichi Kamada of Japan near di edge of di box but goalkeeper manager push am ova di bar!

46 min:

Referee Ismail Elfath don blow whistle to start di second-half

First Half

Di match between Japan and Croatia don start.

45+3

First-Half don end afta Luka Modric play corner kick.

45 min:

VAR check di goal! confam! Japan dey celebrate!!!

44 min:

Goal! Daizen Maeda score for Japan, afta Ritsu Doan take corner kick sharp sharp wit short pass.

40 min:

Danger for Japan! Luka Modric cross di ball into di box from free kick but defense clear di danger.

38 min:

Yuto Nagamoto of Japan try to create dangerous situation in front of di goal post , e send one cross into di Bo’s but defender clear di ball to goal kick for Croatia.

35 min:

Yuto Nagamoto of Japan don commit foul as e dey try attack, referee blow whistle. Japan dey control di game wit short passes.

31 min:

Daichi Kamala of Japan bin get space, but Croatia clear di ball.

29 min:

Josip Juranovic of Croatia cross di ball inside di box but Japan clear di threat.

26 min:

One long pass inside di box almost give Bruno Petkovic of Croatia good chance but e lose to one defender.

21min:

Croatia player Josko Gvardiol fire shot wey go ova di bar afta e stand up from injury scare!

18 mins:

Japan win free kick afta Josko Gvardiol of Croatia tackle dia player

16 min:

Andrej Kramaric of Croatia swing in cross but one of di defenders clear di ball to safety.

10 min:

Shuichi Gonda of Japan show im ability to read di game as e clear danger afta Bruno Petkovic of Croatia threaten to shoot ball from outside di box.

5 min:

Croatia get possession of di ball as dem produce short passes from player to player.

3 min:

A huge chance for Japan. Junya Ito play di corner short give Wataru Endo, wey immediately whips in a cross. E land give Shogo Taniguchi, six yards out, but di defender header goes wide.

2 min:

Japan get free-kick on di left wing as Daizen Maed chop foul. Ritsu Doan whip am in but nobody fit reach di end. Dem get corner however.

1 min:

Japan 000 Croatia

Croatia attack within 10 seconds but dem don clear dia cross

Japan and Croatia go put leg for one trouser today for di last 16 of di ongoing Fifa World Cup.

Na for di Al Janoub stadium di match go shele, as di two kontri dey hustle to qualify for di quarter-finals.

Japan defender Yuto Nagamoto tok say Japan must to "fight like Samurai" wen dem face Croatia in the World Cup round of 16.

Japan shock Spain and Germany to win Group E as dem reach di knockout stage for a fourth time.

Croatia, wey finish second for di 2018 edition for Russia na di obstacle wey dey block Japan as dem dey try to qualify for dia first World Cup quarter-final.

Nagatomo add say "di first condition na to get courage" for di Al Janoub Stadium for Qatar.

"Before dem go into battle dem [Samurai] polish dia weapons and try to improve dia techniques," im tok.

"But if dem dey fear during di battle, dem no go fit use dia weapons and techniques well well.

"Na exactly di same wit football. Of course, di tactics and techniques dey important, but no mata how much wey we don improve, if we dey fear wen we dey for field, dos tins dey useless."

Croatia no score against Morocco and Belgium, but dia 4-1 win over Canada make sure say dem qualify as second for Group F.

Oga of Croatia, Zlatko Dalic say im dey surprised about Japan 2-1 win over Spain and how dem no give up.

"Wen Spain score di opening goal, I bin tink say Japan don finish, but dem no give up dem and deserve dia victory.

"Di fact say Germany, Belgium and Denmark don comot just show how strong oda teams be for dis World Cup.

"If na before, I fit choose Japan as di opponent wey we go want to play, but dem don beat both Germany and Spain. For sure dis game no go esay for us”.

Team News

Japan defender Ko Itakura dey suspended so Takehiro Tomiyasu fit replace am sake of say im don dey fit enough to start. Im bin get hamstring injury for di beginning of di di tournament.

However, Takefusa Kubo missed training on Saturday sake of muscular discomfort, while Hiroki Sakai still get thigh problem wey e get for dia match against Germany.

Croatia oga Zlatko Dalic make just one change during dia three group stage matches, and im fit stick stick wit di same team wey play against Canada and Belgium.

Match Stats

  • Dis na di third World Cup meeting between di two sides. Croatia win 1-0 for 1998 and dem draw 0-0 for 2006, for di group stages.
  • Turkey remove Japan for di last 16 for 2002, Paraguay comot dem for 2010 and Belgium for 2018.
  • Di only Asian nations wey don reach di World Cup quarter-finals na North Korea for 1966 and South Korea for 2002.
  • Croatia don lose only two of dia eight World Cup knockout games, dem win 2 draw 4 and dem progress from di two matches wey dem draw on penalties – di two happun for 2018.
  • Japan averaged only 32% possession across dia three group games. Dia .two wins over Spain and Germany come wit 18% and 26% ball possession

Japan vs Croatia line up

Japan

Gonda, Tomiyasu, Yoshid, Taniguchi, Ito, Endo, Morita, Nagatomo, Doan, Maeda, Kamada

Croatia

Livakovic, Juranovic, Lovren, Gvardiol, Barisic, Modric, Brozovic, Kovacic, Kramaric, Petkovic, Perisic