How husband kill im bride, imsef plus odas on dia wedding day

Wia dis foto come from, Getty Images
One Thai para-athlete and former soja shoot im bride and three odas before e kill imself on im wedding day, police don tell BBC.
Chaturong Suksuk, 29 and Kanchana Pachunthuek, 44, bin marry on Saturday for north-east Thailand.
According to reports, e comot di wedding party suddenly and later return wit gun wey e take shoot im wife, her 62-year-old mama and 38-year-old sister.
Stray bullets also meet two guests, wey dem carry go hospital. One of dem die.
Police tell BBC say Chaturong bin dey "high at di time", but di reason e do am never still clear. E bin buy di gun and ammunition legally last year, dem add.
Thai media cite wetin guests for di party bin tell police, say di couple bin get argument during di party. Dem also report say Chaturong bin feel insecure about di age gap between am and Kanchana.
But police say dis na still speculation, adding say dem don collect evidence and dem expect to close di case "soon".
Chaturong and Kanchana bin live togeda for three years before dem marry according to Thai media.
End of Di one wey oda users dey read well well
Chaturong bin gbab one silver medal inside swimming for di Asean Para Games for Indonesia last year. Di belief also be say e bin dey on di list of athletes wey dey compete for di World Abilitysport Games for Thailand next month.
E bin lose im right leg while on duty with di paramilitary light infantry force, wey dey patrol Thailand borders.
While mass shootings dey rare, gun ownership dey common for Thailand.
Last month, three pipo die for one shooting for one luxury mall inside Bangkok. And last October, one former policeman kill 37 children inside one gun and knife attack for one nursery for north-east Thailand.













