Eight police officers chop suspension ontop accuse say dem help suspected serial killer escape from custody

Wia dis foto come from, AFP
- Author, Ian Wafula
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Eight police officers for Kenya don chop suspension on suspicion say dem help suspected serial killer escape from custody, police tok.
For July, police tok say Collins Jumaisi Khalusha confess to di murders of 42 women, including im wife, since 2022.
Mr Khalusha lawyer deny di claim, and tok say dem torture im client to confess.
E don dey police custody since dem arrest am for July, but on Tuesday police tok say Mr Khalusha and 12 oda escape afta dem get "help from insiders".
Police say di officers wey dem suspend bin dey on duty wen di suspects run away.
Incident report from di station say police discova say di detainees dey miss at 05:00 local time (03:00 GMT) wen officers dey serve breakfast.
Di 13 individuals run comot by cutting through wire mesh roof and scaling a perimeter wall, di report add.
Di pipo wey run alongside, Mr Khalusha na Eritrean nationals wey dem detain for entering di kontri illegally, di police tok.
Dem detain 33-year-old Mr Khalusha afta di discovery of nine mutilated bodies for one abandoned quarry for di capital, Nairobi.
Di victims dey between di age of18 and 30 and im allegedly kill dem all in di same way, according to di police.
Di death of im victims spark shock and outrage. Many question how 42 pipo fit die in di space of two years witout police noticing and also how officers fail to detect say dem leave di bodies inside quarry around 100m (109 yards) from police station.
Kenya police watchdog launch investigation to establish weda di police dey linked to di killings, following “widespread allegations of police involvement in unlawful arrests [and] abductions”.
Dem neva release dia findings.
Police for Kenya don dey accused of scores of human rights abuses in di past - and di force dey currently under investigation ova deaths and abductions following recent anti-goment protests.
At di time of Mr Khalusha arrest, Directorate of Criminal Investigations (DCI) chief Mohamed Amin tok say: "E dey clear say we dey deal wit serial killer, psychopathic serial killer wey no get respect for human life, wey no get respect and dignity."
Mr Khalusha lawyer, John Maina Ndegwa, tell di BBC for July: "E tok say dem strangle am to confess. You fit tell say e dey in distress, terrified and in anguish."
Di suspect appear for one court for Nairobi on Friday, wen di magistrate order say make dem hold am for anoda 30 days so police go fit complete dia investigations, news agency AFP report.
Di discovery of di dismembered bodies come as di kontri still dey shake from di so-called Shakahola forest massacre, wia dem find more dan 400 bodies for mass graves near di Indian Ocean coast.
Cult leader Paul Mackenzie bin allegedly encourage im followers to starve demsefs in order to "go see Jesus".
E don plead not guilty to manslaughter.










