Family of six die afta dem eat food dem mistakenly put chemical inside instead of seasoning

Family of Ummaru Ladan don lose six members, including one 10-year-old girl, afta dem mistakenly use local henna chemical cook instead of white seasoning.
Di incident happun for Kaura town wey dey for Shagari local goverment area for Sokoto state.
Di family cook soup wit "Gishirin lalle" (henna salt for Hausa) wey pipo sabi as (ammonium chlorite) wey dem use on Wednesday, and dem warm di food again for Thursday morning befor dem chop am.
According to Kabiru Muhammad, one relative of di family, di girl wey first die start to dey sick on Thursday, and dem give am treatment for malaria.


Muhammad tok say, "On Thursday, eviribodi for di village bin see di girl dey waka about."
"Na on Friday morning di girl die, afta she die, oda pipo for di house begin sick, so we carry dem go General Hospital Shagari."
"After we reach di hospital, Alhaji Ummaru wife die. So, we combine her funeral prayer wit di girl own. From dia, di doctors for di hospital see say di matter don pass dia power, so dem tok say make we carry dem go di main hospital for Sokoto, UDUTH."
"But before dem fit transfer dem, anoda person die on Saturday, so we carry three patients go."
E add say, "For UDUTH, two of dem die togeda, and on Monday, anoda one come die, so we do funeral prayer for am too."
"Di pipo wey die include one of Alhaji wife, im pikin, two of im in-laws wey marry im sons, and two of im grandchildren," e tok.

Wen BBC Pidgin ask how dem take discover say na di chemical (ammonium chlorite) cos di deaths, Muhammad say na one girl for di house realize di mistake on Friday wen dem dey look for di chemical to use.
Dem notice say di seasoning wey dem never use dey near wia dem keep di chemical, sake of say di white seasoning and ammonium chlorite look di same.
Dan Modi Sahabi, wey be niece to Alhaji Ummaru , tok say Alhaji Ummaru Ladan chop di food too but only small, na why dem discharge am from hospital afta dem give am medicine.
Sahabi tok say, "Right now, Alhaji Ummaru dey in shock, and e no fit even tok to pipo sake of di condition wey e dey now."

Di pipo wey dey live for di town describe di pipo wey bin die as pipo wey love odas, live peacefully, and no dey fight wit anybody.
Hajiya Asabe Balarabe, di Commissioner of Health for Sokoto State, tok say dem no contact dem wen di incident happun, and by di time dem try save di pipo life, di tin wey dem chop don already cause serious damage.
Dis incident happun one week afta six oda pipo die from a case of food poisoning for Sokoto state.
How you go fit know if persin don chop food wey get poison?
Dr Fatima Adamu, wey be Doctor for Aminu Kano Teaching Hospital, tok say, "Di truth be say we no dey see am wit eye; most times wen dem carry you come hospital, some questions dey wey we go ask, and na from di answers we go know say if na poison or anoda sickness."
But she tok about some signs wey dem dey see for pipo wey don chop poison, and di signs include:
- Vomiting
- Stomach pain
- Fever
According to Dr Fatima, na from dat time dem go begin check wetin di person chop and if oda pipo wey chop di same food follow get di same problem.
Dr Fatima add say you no need wait until foam dey come out from di person mouth becos, according to her, poison get different types.
Wetin dey happun for person body if dem chop food wey get poison?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dr Fatima tok say wahala go start as soon as di poison wey di person chop for food enter dia body.
"Di body go know say something wey no suppose enter don enter."
Di body get im own defense; if di defense try fight di tin but e no fit, di body go begin show signs. Some poison no need medicine.
Persin fit recover afta e chop food wey get poison?
"Afta some days, e go heal, but some need medicine. E depend on how strong your immune system dey and di kain poison wey enter body."
But di doctor tok say make person no stay for house if dem suspect say e don chop food wey get poison, say make e quick go hospital.
"Every poison get the kind treatment wey dem dey give; some go need to wash di food wey dem chop commot, some go need medicine to stop di poison from entering blood, den dem go purge am, some na only medicine for fever dem go need."
She add say make pipo no dey try treat am for house, say na dat one dey cause plenty wahala wey fit make person die.
Mistakes wey pipo dey make if person chop food wey get poison
Dr Fatima tok say some tins dey wey pipo dey do becos dem wan reduce di effect of poison for person body, but for science, na mistake dem be and e fit harm di person.
She tok say: “For example, you go hear pipo dey tok say make dem give di person milk or sometin, or you go hear say make di person try vomit.
If na chemical or sometin like acid, if dem tok say make di person vomit, e go cause more harm, or if the vomit enta di person airway, e fit lead to death.
So, dis kain of actions no go help; as soon as you notice any sign, di best tin na to quickly carry di person go hospital.
Ways to avoid eating food wey get poison

Wia dis foto come from, Getty Images
Poison dey harm person wen e enta body, so how person go fit stop imself from eating food wey get poison?
Di doctor tok say some important steps dey wey person suppose take to avoid eating food wey get poison:
- Clean di food well
- Clean di place wey you dey cook
- Keep food for safe place wia notin go fit spoil am
- Use clean water
- Use clean plates and cutlery
- Keep food inside fridge
- Always wash your hand
- No keep anytin wey get poison near wia you dey cook









