Wetin we know as Uganda confam fresh outbreak of Ebola virus

Wall graffiti about Ebola

Wia dis foto come from, EPA

One 24-year-old man wey dey infected with Ebola don die for central Uganda.

Dis na fresh outbreak wey health officials for Uganda dey confam.

Di health minister tell journalists say di victim bin show symptoms before di disease kill am.

E be resident of Ngabano village inside Mubende district, about 147km (91 miles) from di capital, Kampala.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Uganda Virus Research Institute confam di case of di relatively rare Sudan strain, di World Health Organization (WHO) tok for statement.

Dem say eight pipo with suspected symptoms dey receive medical care, and dem dey send staff go di affected area.

Di East African kontri last report outbreak of di strain for 2012.

“Thanks to dia [Uganda] expertise, dem don take action to quickly detect di virus and we go fit bank on dis knowledge to stop di spread of infections," Dr Matshidiso Moeti - WHO regional director for Africa tok.

Wetin be Ebola

Pesin carri bat

Wia dis foto come from, Science Photo Library

Ebola na viral haemorrhagic fever wey dey caused by di Ebola virus wey often dey deadly if dem no treat am. According to World Health Organization.

Di Disease na rare but severe illness wey fit kill pesin wey get am; 50% to 90% of pipo wey contract am no dey survive.

But if dem provide di right medical care and treatment, e dey possible to recover.

Di virus dey transmitted to pipo through close contact with di blood, secretions, organs or oda bodily fluids of infected animals like fruit bats (wey expert tink be di natural hosts).

E dey spread through human-to-human transmission through direct contact with blood or body fluids of pesin wey dey sick wit or don die from Ebola, objects wey dey contaminated with body fluids from pesin wey dey sick wit Ebola or di body of pesin wey die from Ebola.

Why Ebola dey always come back ?

Pipo wear PPE

Wia dis foto come from, Getty Images

Ebola dey quick spread. Small sweat or spit from pesin or animal wey get di disease fit infect pesin.

According to di WHO, new Ebola outbreak go ever dey happun for Dr Congo because di virus dey live for animal reservoir wey dey for many parts of di kontri.

Fruit bats na di main carrier of di disease, but pipo fit dey infected if dem come in close contact wit blood, organs or bodily fluids of animals wey get di virus like chimpanzees, gorillas, monkeys, antelope and porcupines.

Di disease dey very rampant for dis area and e no go dey possible to destroy all di animals wey fit dey carry Ebola.

As long as pipo dey touch and eat dem, possibility dey say Ebola go always return.

How dem dey manage di Ebola epidemic

Pesin dey wear PPE

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Quick and well coordinated response to disease dey epp contain am and reduce di number of infections or infected pesins wey fit die from di disease.

WHO Director-General, Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say di health body go send a team of 25 pipo go DR Congo for 2 June to support and see wetin dey happun.

Di team go collect and test samples wey dem go carry go laboratory for confirmation.

Dem go begin contact tracing and send additional supplies to di kontri to support di goment.

WHO go also make sure say dem send essential health services go areas wey di outbreak serious.

Vaccine dey?

Pesin dey collect injection

Wia dis foto come from, AFP

Five identified strains of Ebola virus na im dem don discover, di deadliest na di Zaire strain.

Na dis strain dem see for di latest outbreak, and vaccine dey available to treat am.

Dem develop di vaccine for 2014-2016, wen di epidemic bin dey very serious but dem no fit use am, because as at dat time e don late.

E neva receive full licence for use but wit di epp of global efforts, dem prove say e dey safe for human use and dem don store 300,000 doses.

WHO guidelines recommend say Ebola outbreak go occur before dem give licence.