Denmark vs Tunisia end for goalless draw

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Fiona Equere
- Role, Broadcast Journalist
Tunisia hold Denmark to a draw by Tunisia for dia World Cup opener for di Education City Stadium for Al Rayyan.
Despite say dem field many Premier League regulars, di Danes get a tough workout for Group D.
Both sides get dia goals rule out for offside, while Denmark Andreas Cornelius somehow miss from a yard.
Drama bin dey for di 95th-minute wen referee Cesar Ramos check di pitchside monitor over potential Denmark penalty for handball, only to stick wit im original decision.
One of di pre-tournament favourites, Denmark go now need to find some form if dem go qualify from di tricky-looking group.
Denmark vs Tunisia as e happun
SECOND HALF
90 + 7: FULL-TIME:
End of Di one wey oda users dey read well well
DENMARK 0-0 TUNISIA
90 + 5: NO PENALTY! Afta referee go check am for di monitor e no give di penalty
90 + 4 mins: SAVE BUT VAR CHECK! Lindstom cross-turn-shot dey pushed away by Dahmen before dem block Cornelius attempt. Inside di box, di ball hit di hand of a defender afta Eriksen cross di ball.
90' + 2 mins: Maehle shot go out for corner afta Cornelius bin keep di ball alive.
90 + 1 mins: Eriksen corner from di right dey cleared away. Denmark dey put Tunisia under pressure now
90 mins: Na five minutes of additional time remain.
88 mins: Substitution for Tunisia. Kechrida dey replace Drager on di right.
86 mins: Khenissi collect yellow card afta im foul Jensen inside Denmark half as im try to block di ball.
83 mins: Na only one save Schmeichel don make so far. Im be di third-oldest player to play for Denmark for World Cup (at di age of 36 years, 17 days), behind Morten Olsen (36y 308d for 1986) and Jan Heintze (38y 293d in 2002).
81 mins: Jensen pass too strong for Damsgaard. Im pass forward go straight out for goal-kick.
80 mins: Mejbri na di second teenager to play for Tunisia for World Cup aftaYassine Chikhaoui for 2006.
80 mins: Substitution for Tunisia. Khenissi dey replace Msakni.
80 mins: Mejbri don enta pitch for Tunisia. Im dey replace Jebali.
78 mins: Jensen foul Sliti as im bin dey run down di right side. Di Brentford player don collect yellow card.
76 mins: Jensen receive di ball from Maehle, e shift am to im right foot before im drag am wide from outside di box.
75 mins: Schmeichel pass di ball straight out for a throw-in, but Tunisia no fit do anytin wit di opportunity. Sliti give di ball away.
70 mins: BIG CHANCE?
Denmark almost score from Eriksen corner.
69 mins: SAVE!
Dahmen deny Denmark from scoring. From di edge, Eriksen powerful effort dey pushed wide by di goalkeeper.
67 mins: Substitution for Tunisia. Sliti replace Slimane.
65 mins: Captain Kjaer dey replaced by Jensen. Eriksen now dey wear di armband.
65 mins: Substitution for Denmark. Cornelius replace Dolberg for attack.
65 mins: Substitution for Denmark. Olsen replace Lindstrom.
65 mins: SUBSTITUTION
Simon Thorup Kjær Mathias Jensen
63 mins: Dolberg try to dribble two defenders but e no work. E try to get free-kick, referee no give am, na Tunisia hold ball now.
61 mins: Olsen cut inside from di right before im cross one dangerous ball inside di box. But, Abdi head am ova di bar.
57 mins: Denmark don dey play well and look more dangerous for dis second half. Dolberg flick di ball pass Dahmen las im bin dey look for Olsen, but im strike partner no dey dia.
56 mins: OFFSIDE!
Denmark score, but e no go count. Olsen put am for di bottom corner afta keeper save Damsgaard shot, but im bin dey for offside position from di original pass.
54 mins: Andersen play long ball forward as im try to switch di play, but im pass dey blocked by Bronn wey direct back to di goalkeeper.
52 mins: Olsen block Bronn shot from inside di box wey take am ova di bar.
50 mins: Big chance for Tunisia.
Jebali chip di ball to Laidouni wey break pass di Denmark defence. E try to play am to Slimane, but im pass dey blocked. Im for go alone.
49 mins: Maehle try to go past Drager but no way before im accidentally step on di foot of di Tunisian player - na free-kick.
47 mins: Di corner target Msakni, im flick di ball out for a goal-kick.
46 mins: Great start from Tunisia. Drager run down di right to cross but e dey blocked.
46 mins: Tunisia kick off di second half.
Kick-Off!

Wia dis foto come from, Getty Images
FIRST - HALF
45 + 5 mins: HALF-TIME!
Denmark 0-0 Tunisia
45+ 4 mins: Eriksen look for Andersen wit di corner, but Abdi head am out.
45 + 4mins: Eriksen and Olsen stand ova am. Olsen take am, Meriah clear am out for corner.
45 + 3 mins: Free-kick to Denmark for crossing position.
45' + 1 mins: Delaney dey waka one kain e no fit continue. Dem replace am wit Damsgaard for midfield. Im injury come afta Msakni tackle am.
43 mins: Schmeichel punch away di ball from corner kick before Skhiri hit am ova from outside di box.
43 mins: SAVE!
Na correct stop from Schmeichel. One-on-one, Jebali chip but keeper flick am ova.
42 mins- Hojbjerg bin think say im don win penalty afta Laidouni push am comot from di ball. E raise im hands up, but di referee say na goal-kick and di match continue.
40 mins: Kristensen run down di right as im dey look to collect Olsen pass, but e go out for a goal-kick.
39 mins: Slimane corner from di right bounce around di box before Laidouni shoot wide from a tight angle.
38 mins: Jebali do well to win corner. Nobody dey Denmark box, im hold di ball before im hit am against Kjaer.
37 mins: Laidouni dribble past a number of Demark defenders as Tunisia players dey run forward. but, im pass no make sense.
33 mins: Msakni collect di ball around halfway, e find Slimane wey enta di box. E cut inside, but Hojbjerg tackle di Tunisian.
31 mins: Kjaer pick out Olsen wey bin dey run behind di Tunisia defence. One-on-one for di right of di box, Abdi block di ball.
30 mins: Delaney burst down di right and look to pass di ball towards Kristensen wey move inside, but Tunisia player block di pass.
28 mins: Kristensen curl di ball from di right straight for di hands of Dahmen. Na poor cross and wasted chance for Denmark wey dey struggle for dia attack so far.
26 mins: Denmark 0-0 Tunisia
24 mins: Kristensen collect yellow card afta a late challenge on Laidouni.
24 mins: Jebali score, but na offside.
24 mins: Yellow Card for Rasmus Nissen Kristensen
22 mins: Di ball dey bounce around di box, e reach Andersen wey kick shot to Dahmen.
20: Eriksen play corner from di right to Andersen, but im header dey cleared.
19 mins: Denmark dey look to slow di game down as di ball comot for pitch, but Tunisia still dey ginger dem.
18 mins: Laidouni try to chip di ball forward to Slimane, but Christensen come across and pass di ball back to Schmeichel.
16 mins: Denmark go for corner, but e no work. Talbi block Kristensen cross, di ball touch di Leeds man and go out for a goal-kick.
14 mins: Tunisia don fail to keep a clean sheet in 14 of dia 15 games for di World Cup (dem concede 25 goals), di only exception na against West Germany for 1978 (0-0). So far, dia defence no dey under pressure.
12 mins: From di corner, Msakni flick di ball ova di bar for di near post.
11 mins: WIDE! Tunisia go close. Drager shot from di edge deflects off of Christensen and go wide.
10 mins: Schmeichel get di ball for di edge of im own box and move forwards wit am im no dey under no pressure. E take im time, play di ball out as im look for Olsen for di right.
8 mins: Tunisia dey play well so far. Dem dey pass ball around confidently and dey look attack Denmark wit every opportunity.
7 mins: Dahmen hit di ball down di field to find Jebali, but Kjaer run forward to clears am away.
5 mins: Jebali win di ball off of Christensen wey bin dey try to let the ball roll out for a goal-kick.
4 mins: Di game don stop Christensen need attention. Im block one hot shot from Msakni, but im dey fine to continue.
2 mins: Eriksen corner from di right side dem clear am. Di Manchester United man gets di ball on di right but Laidouni tackle am. Di Tunisian player come hit im chest and celebrate di clearance.
Denmark 0-0 Tunisia
1 min: Denmark kick off di game
Team News
Denmark Frederik Ronnow bin miss Union Berlin final three Bundesliga matches wit a hamstring injury.
Wolfsburg forward Jonas Wind also na doubt wit a muscle issue.
Tunisia captain Youssef Msakni bin miss di 2018 World Cup wit injury and im don struggle wit injury again for di build-up to Qatar - but im dey expected to dey fit to face Denmark.
MATCH FACTS- Head to head

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis na di first encounter between Denmark and Tunisia for di World Cup.
Dia only previous meeting na for friendly 20 years ago for Japan, before di 2002 tournament, wey Denmark win 2-1.
Denmark dey unbeaten against African opposition for World Cup (W2, D2), while Tunisia neva win against European opposition for di tournament (D3, L7).
Denmark line up
1 Schmeichel
2 Andersen
4 Kjaer
6 Christensen
13 Kristensen
23 Højbjerg
8 Delaney
10 Eriksen
5 Maehle
11 Skov Olsen
12 Dolberg
Substitutes
3 Nelsson
7 Jensen
9 Braithwaite
14 Damsgaard
15 Nørgaard
16 Christensen
17 Stryger Larsen
18 Wass
19 Wind
20 Poulsen
21 Cornelius
22 Rønnow
24 Skov
25 Lindstrøm
26 Bah
Tunisia line up
16 Dahmen
3 Talbi
6 Bronn
4 Meriah
20 Dräger
14 Laïdouni
17 Skhiri
24 Abdi
25 Ben Slimane
7 Msakni
9 Jebali
Substitutes
1 Mathlouthi
2 Ifa
5 Ghandri
8 Mejbri
10 Khazri
11 Khenissi
12 Maâloul
13 Sassi
15 Ben Romdhane
18 Chaalali
19 Jaziri
21 Kechrida
22 Ben Saïd
23 Sliti
26 Hassen
Referee:
César Arturo Ramos Palazuelos












