Argentina vs Saudi Arabia highlight: Lionel Messi, Di Maria skill no dey enough to deny Saudi Arabia victory for Qatar 2022 Fifa World Cup

Lionel Messi no believe wetin im eye dey see

Wia dis foto come from, Getty Images

A bold and brilliant Saudi Arabia pull off one of di biggest shocks for World Cup as dem come from behind to stun two-time World Cup winners Argentina for a fantastic Group C opener for Lusail.

Ranked 51st for di world, Saudi Arabia - Argentina for end am for first half afta Argentina open scoring wit Lionel Messi goal from di penalty spot.

Ref rule later rule three of dia goals offside.

But Saudi Arabia change di game inside 10 minutes for second half. Saleh Al-Shehri equalize wit a low effort and Al Dawsari fire dem into di lead wey make di supporters craze.

Di Green Falcons demonstrate di ruggedity to keep dia defese tight.

Lionel Scaloni, Argentina coach enta di tournament as one of di favourites, on dia 36-game unbeaten run.

Dem be South American champions after dem win di 2021 Copa America.

Dem now get to keep dia hopes alive for dia first global triumph since 1986 and give Messi better retirement package by winning di World Cup.

Argentina next match na against Mexico on Saturday, while Saudi Arabia take on Poland.

FULL TIME

Argentina 1-2 Saudi Arabia

98mins: SUBSTITUTION! Al Burayk enta for Al Shahrani.

96mins: Saudi Arabia dey solid for back, but di goalkeeper Al Owais go involve im sef

93mins: Al Owais dey vex sake of di challenge from Otamendi

EIGHT minutes of added time

89mins: Di Maria drive in to di Saudi half again. E dey worry dei defense but dem neva break dem

87mins: Superb defending once again from Al Tambakti. Dis time e stop Martinez from heading di ball.

84mins: Chance for Messi! Di Maria pick am out wit a curling cross to di back post, but e no head am well.

81mins: YELLOW CARD! Abdulhamid chop card.

79mins: Argentina free-kick shooting range

Big moment for both teams, this. Saudi fans can breathe easily...that was high, wide and handsome from Messi. Immensely disappointing.

77mins: Time dey go really fast. Who go rescue Arentina.

75mins: More good goalkeeping from Al Owais to rush out of im area and sweep up behind dat Argentina high line.

72mins: Better ball from Di Maria to Messi but e no reach am.

68mins: Messi tries to slip Tagliafico in on di left but Al Brikan track back to stop am.

65mins: Messi again try to take free kick but the referee pulls am back. Argentina get 30 minutes more left.

62mins: dey look like pesin wey wan turn im sef to goal. E dey do evri tin to get behind di Saudi defense.

60mins: Scaloni don vex comot Lisandro Martinez, Alvarez and Fernandez

57min: See beta challenge from Al Tambakti. Messi bin don [position to play di shot.

Argentina 1-2 Saudi Arabia

56mins: GOAL! Saudi Arabia lead Argentina!

Na Al Dawsari score aft aim dribbling skill. E hit am pass Martinez.

51mins: Saudi fans dey over happy for stadium

50mins: GOAL! Saudi Arabia don level

Al Shehri score

Second Half Kick off

Argentina vs Saudi Arabia Line up

Argentina: Emeliano Martinez, Nahuel Molina, Cristian Romero, Nicolas Otamendi, Nicolas Tagliafico, Alejandro Gomez, Rodrigo De Paul, Leandro Paredes, Lionel Messi (c), Lautaro Martinez, Angel Di Maria

Saudi Arabia: Mohamed Al-Owais, Ali Al-Bulaihi, Yasser Al-Shahrani, Mohamed Kanno, Saud Abdulhamid, Abdulelah Al-Malki, Saleh Al-Shehri, Hassan Al-Tambakti, Salman Al-Faraj (c), Salem Al-Dawsari, Firas Al-Buraikan.