'I dey challenge both di process and di outcome of di presidential election' - Peter Obi

Peter Obi

Wia dis foto come from, @Peter Obi/Twitter

Wetin we call dis foto, Labour Party presidential candidate Peter Obi

Presidential candidate of di Labour party for di 25 February general elections, Peter Obi say im dey challenge di electoral process wey make di Independent National Electoral Commission (INEC) declare di All Progressives Congress presidential candidate Bola Tinubu winner of di election plus di declaration itself.

Oga Obi give retract im initial position afta one television interview where e tok say na di electoral process im dey challenge no be di outcome of di election.

Dis clarification dey come afta di mata don generate plenty reactions for Nigerians for social media.

Di former Anambra state govnor wen e appear for Arise TV earlier bin tok say im no dey contest di outcome of di 2023 presidential elections wey declare President-elect Bola Tinubu of di All Progressives Congress, as di winner of di election.

But wetin im dey challenge na di process wey di electoral body take get di results dem announce.

“I no dey challenge who dem declare, I no dey challenge di outcome, I dey challenge di process wey dem take arrive at dia declaration.”

E later tweet say “I dey challenge di INEC electoral process wey lead to di declaration of Tinubu as president-elect plus di declaration itself.”

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di former Anambra state govnor add say di process pipo take enta office dey more fundamental pass wetin dem do thereafta.

“And unless we do dat, we no go stop di rascality wey we witness for dat election.”

Di Labour party presidential candidate bin tok for one press conference say, if you wan answer ‘His Excellency’, di process to reach dat position must dey excellent.” He insist say getting di process right dey important.

Oga Mahmood Yakubu and di leader of di Labour party legal team

Wia dis foto come from, INEC/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Oga Mahmood Yakubu and di leader of di Labour party legal team for di INEC headquarter to inspect election materials

Meanwhile, INEC Chairman, Prof. Mahmood Yakubu don assure di Labour Party legal Team say di commission go provide all di documents dem request to prosecute dia case.

Dis dey come afta di Labour party presidential candidate Peter Obi for one TV interview tok say im go go through both di legal process, by telling di court say INEC dey in contempt as dem no obey di court order.

Dem go also do peaceful protest go INEC office to request di collation materials.

Later in di day, Oga Mahmood for inside statement say di Labour party legal team don show for di commission headquarters to discuss di modalities for obtaining di documents.

E add join say “INEC no get anything to hide. Documents dey available for di Headquarters and dem go release am immediately.

Plus dem go meet wit Resident Electoral Commissioners today and dem go discuss how oda documents for di state level go also dey available to di team speedily.

INEC chairmo, Prof. Mahmood Yakubu, for di early hours of Wednesday, March 1, bin declare APC Bola Ahmed Tinubu as di winner of di February 25 presidential election, e beat Atiku Abubakar of di People’s Democratic Party and LP’s Obi wey come second and third respectively for di keenly contested poll.