PRESEC win record 8th Ghana national science & maths quiz

Di national science & maths quiz trophy

Wia dis foto come from, National Science & Maths Quiz/Facebook

Wetin we call dis foto, Di national science & maths quiz trophy

Di Presbyterian boys secondary school (PRESEC) don win record 8th trophy for di grand finale of di national science and maths quiz for Ghana.

Dem win am back-to-back, sake of in 2022, dem win di competition.

Afta nail-biting five rounds wit Achimota and Opoku Ware school, PRESEC emerge champions.

For di past four weeks, dem dey do di contests from di preliminary stage come reach di final.

For winning di championship, PRESEC get di trophy and bragging rights.

For dia win, dem get GHC 70000 ($5882) prize money.

Dem also get insurance packages.

Di school for Accra don turn serial winners of di competition.

For dia second place prize, Achimota school from Accra don get GHC 50000 ($4201). Dem also get packages from sponsors.

Opoku Ware school from di Ashanti region wia chop third get GHC 35000 ($2940) as prize money.

Oga for di organizers, prime time production, Nana Akua Mensah - Bonsu tok say dem wan support make dem expand di competition beyond Ghana.

“We wan make di nsmq continent-wide make e go outside di kontri.”

Dis be di 30th anniversary of di science and maths quiz competition wia e don generate plenti interest across di kontri.

Dis year, 147 schools don participate, 7 of dem be private schools wia di rest be public schools

'Semi-final contest bring wahala'

Di organizers dey allow say some of di schools fit protest if dem feel say di quiz mistress allow or disallow some answers.

Na so one school, Prempeh College from Kumasi don raise issue wit one answer di quiz mistress accept wey make di school chop second for one of di two semi-final contests.

Di winner of dat contest be Opoku Ware wey go di final wit two points.

Prempeh College write to di organizers of di NSMQ say one of dia answers for di last round of di contest be correct wia di quiz mistress disallow am.

Di NSMQ explain say sake of di riddle round dey require specific answers based on clues dem dey give, di quiz mistress dey expect specific response, wia im go fit use im discretion.

Na so im decide to reject di Prempeh College answer wia make dem lose di 19 October contest by just two points.

Despite di explanation, Prempeh College maintain say di quiz mistress for accept dia answer.

One of di old students of di school don go court sef, to file injunction on di grand finale until di high court go determine whether dem get case.

But since some part of di writ trend for social media, di organizers no talk if e go affect di 30 October grand finale.

Di three schools wey dey vie for di trophy

PRESEC representatives

Wia dis foto come from, National Science & Maths Quiz/Facebook

Wetin we call dis foto, PRESEC be seven-time winners of di national science & maths quiz competition

PRESEC be seven-time winners of di national science & maths quiz competition, wia dem win am last year.

Dis be dia fifth consecutive final for di competition.

Di school be one of di top senior high schools for di kontri wia dem dey do well for plenti competitions.

Dem also be Greater Accra regional champions of di same contest.

Di oda school, Achimota Senior High School wia dey Accra, don win di competition two times.

Di school dey boast of di fact say dem produce four heads of state for Ghana.

Achimota Senior High School representatives

Wia dis foto come from, National Science & Maths Quiz/Facebook

Wetin we call dis foto, Achimota Senior High School wia dey Accra, don win di competition two times.

Opoku Ware be di last of di three finalists.

Dem also win di competition two times before.

Di school dey di Ashanti region wia ibi one of di best schools for di kontri.

So far, no all-girls school win di competition for di thirty years di NSMQ dey run.

Wesley Girls High school and Mfantsiman Girls school be di only all-girls schools wey reach di finals before.

Opoku Ware representatives

Wia dis foto come from, National Science & Maths Quiz/Facebook

Wetin we call dis foto, Opoku Ware be di last of di three finalists