Elon Musk say im Neuralink company implant wireless chip inside human being brain

Wia dis foto come from, Getty Images
Tech billionaire Elon Musk say im company Neuralink don successfully do implant for one of dia wireless brain chips for human for di first time.
Dem say di Initial result detect promising neuron spikes or wetin dem call nerve impulses, and add say di patient dey recover well.
Di company goal na to connect human brains to computers and dem say dem wan help tackle to complex neurological conditions.
Some rival companies don already implant similar device dem.
BBC News bin approach both Neuralink and US medical regulator, di Food and Drug Administration (FDA), for comment.
FDA bin give Oga Musk company permission to test di chip on humans for May, dat move na critical milestone for dem afta dia early struggles to gain approval.
E give dem di green light for di start of di six-year study during dat time dem use robot to surgically place 64 flexible threads, wey thin pass human hair, to one part of di brain wey dey control "movement intention", according to Neuralink.
Di company say dis threads allow dia experimental implant – wey dey powered by one battery wey fit dey charged wirelessly - to record and transmit brain signals wirelessly to one app wey go decode how di pesin intend to move.
End of Di one wey oda users dey read well well
For X, di social media platform wey im own wey be Twitter before, Oga Musk say dem go call Neuralink first product Telepathy.
Im say, Telepathy, go enable pipo "control your phone or computer, and through dem almost any device, just by thinking".
"Initial users go be those wey lose di use of dia limbs," im kotinu.
E bin dey refer to di late British scientist wey bin get motor neurone disease, Im add say: "Imagine if Stephen Hawking fit communicate faster pass a speed typist or auctioneer. Dat na di goal."
While Oga Musk involvement go raise di profile of Neuralink, im get competition, some of dem get a track record wey go back two decades. Utah-based Blackrock Neurotech bin implant dia first of many brain-computer interfaces for 2004.
Precision Neuroscience, wey Neuralink co-founder form, also plan to help pipo wit paralysis. And dia implant resemble one very thin piece of tape wey dey sit on di surface of di brain and e go fit dey implanted through a "cranial micro-slit", wey dem say na a much simpler procedure.
Existing devices don also generate results. In two separate recent US scientific studies, dem use implants to monitor brain activity wen person try to speak, wey fit dey decoded to help dem communicate.












