Pakistan former Prime Minister Imran Khan chop second jail sentence in two days

Imran Khan and IM wife Bushra Bibi sign surety bonds for bail in July 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Imran Khan and im wife Bushra Bibi last July as dem dey post bail

Imran Khan and im wife Bushra Bibi don dey sentenced to 14 years in prison, one day afta di former Pakistan prime minister bin dey jailed for 10 years.

Mr Khan, wey im opponents comot as PM for 2022, dey already serve one three-year jail term after dem find am guilty of corruption.

On Tuesday dem sentence am for leaking state secrets, and on Wednesday, dem give am 14 years for anoda corruption case.

E don say all di charges against am dey politically motivated.

Na di second conviction against am in days- and di verdicts come a week before Pakistan elections.

Khan still dey very popular across di kontri but dem stop am from standing in di 8 February vote. Im party, di Pakistan Tehreek-e-Insaf (PTI), don also face campaigning restrictions.

E never dey confirmed yet but di believe na say Khan go dey able to serve di sentences concurrently.

Di former premier and international cricket star don already dey detained since last August wen dem arrest am, e dey serve time mostly for Adiala jail for Rawalpindi.

Im wife Bushra Bibi, wey bin dey out on remand, also surrender for di jail on Wednesday. She bin dey keep a low profile during dia period in office. Dem marry for 2018, months before Khan dey elected prime minister.

Both of dem bin don strongly deny di accusations against dem by Pakistan anti-corruption watchdog. Dem allege say dem sell or keep state gifts dem bin receive while in office for personal profit. Such gifts include a jewellery set from di Crown Prince of Saudi Arabia.

Authorities convict dem of di charges on Wednesday. Along with di 14-year prison terms, di court order dem to pay a fine of about 1.5 billion rupees (£4.2m;$5.3m).

On Wednesday, Khan PTI party say di sentencing further mean say di former PM go also dey disqualified for 10 years from holding public office.

One tok-tok pesin for im party describe di ruling as: "Anoda sad day in our judicial system history, wey dem dey scata."

Di former premier bin blast di court decision on Tuesday - wia one judge find am guilty of revealing a classified document and damaging diplomatic relations.

Khan bin dey sentenced to 10 years in jail inside one case wia dem accuse am of leaking state secrets.

Di conviction under di secrets act dey come di week before general elections wia dem stop am from contesting.

Former Foreign Minister Shah Mahmood Qureshi bin also dey sentenced to 10 years in prison by di special court.

Di case involve di alleged leaking of secret diplomatic correspondence wey Pakistan ambassador for Washington to Islamabad send wen Mr Khan be prime minister.

E relate to im appearance for one rally for March 2022, one month before dem comot di former cricketer from power with one vote of no confidence. Imran Khan appear on stage, e dey wave one piece of paper wey e say show one foreign conspiracy against am.

E say e show say "all go dey forgiven if Imran Khan dey removed from power". E no name di kontri - but afta den, e become highly critical of United States.

Di prosecution say di former PM actions amount to leaking a classified document and damaging diplomatic relations. Part of di charge fit lead to life imprisonment or even di death penalty.

Khan and im PTI party bin describe dat case and di odas against am as bogus, arguing say di trials happen under duress inside "kangaroo courts", wia dem rush di proceedings.

Imran Khan

Wia dis foto come from, EPA

After Tuesday verdict, Khan tell im followers to "take revenge for every injustice with your vote on February 8 while remaining peaceful" in a statement dem release on im X (formerly Twitter) account.

"Tell dem say we no be sheep wey dem fit drive with stick," e tok.

Many don already dey question di credibility of next Thursday vote, sake of say Imran Khan - wey still be one of Pakistan most popular politicians - and im party don dey sidelined.

Di authorities deny say dem dey carry out a crackdown on PTI, but many of im leaders now dey behind bars or don defect. Im candidates dey stand as independents and many dey on di run.

Police also round up thousands of im supporters after protests - wey sometimes bin dey violent - last May wen dem bn first carry Imran Khan go custody.

Dem don also remove di party cricket bat symbol, wey dey important inside country with low literacy rates to allow voters to choose wia to mark dia ballots.

Di man sabi pipo dey reason go win na three-time former PM Nawaz Sharif, wey return from self-imposed exile for autumn time. E bin worry di powerful military during im long career and dem jail am for corruption ahead of di 2018 election wey Imran Khan win.

Now, many believe e dey currently preferred by di Pakistan military establishment, while Khan- wey pipo bin reason say dey close to di military - don fall out with dem.