Why dem arrest former Pakistan PM Imran Khan?

One supporter of Imran Khan hold poster wit im portrait for one rally for Karachi in support of di former Pakistani prime minister.

Wia dis foto come from, EPA

Dem arrest Imran Khan, wey be Pakistan ogbonge popular former prime minister, on Tuesday sake of corruption charges - di moment wey im bin don successfully avoid for plenti months.

Dem bin don miss plenti attempts to arrest am. For March, Im supporters clash wit police for im home for Lahore afta one court give order to detain am.

Im arrest, wey happun wen im dey inside court for di capital Islamabad still carry drama follow body. Di 70-year-old barely dey visible among plenti officers wey guide wit riot gear as dem escort am outside and bundle am enta dia motor.

Oga Khan don face several charges, from corruption to sedition, since dem overthrow am afta im lose one confidence vote last year. So im arrest no dey unexpected.

But e don vex im supporters and even shock di kontri wey bin dey hope for end to di political kasala wey don push Pakistan to di edge.

Why dem arrest Khan?

Pakistan goment say dem take am into custody sake of im no co-operate wit authorities for one ongoing corruption investigation.

Di case allege say Oga Khan, wen im be PM, receive land as bribe as exchange for political favours. E follow one investigation wey Britain National Crime Agency do into "laundered" money wey involve Pakistan biggest property tycoon Malik Riaz Hussain.

Oga Hussain allegedly give di land to di Al-Qadir Trust, wey Oga Khan third wife, Bushra Bibi set up. Oga Khan, wey deny di charges, say dem don donate di land for di purpose of charity.

Oga Hussain deny say im launder money. But im position on di question of land for favour no dey clear - im appear before Pakistan National Accountability Bureau investigators earlier dis year and record one statement for di Al-Qadir Trust case, but dem no ever make am public for di media.

Since im arrest, dem don indict Oga Khan for anoda graft case. Di allegation for dis one be say im no disclose money wey im get wen e sell gifts im receive on foreign visits as PM. Di hearing for dis case see dem press charges for di first time against Oga Khan on Wednesday and im plead not guilty.

Imran Khan supporter protest against Oga Khan shock arrest

Wia dis foto come from, Getty Images

Analysts believe say now wey im dey custody, courts fit indict am for series of cases – di fate wey im don repeatedly avoid as im dey miss appointment, or appear for higher courts, wit heavy security, only to apply for protective bail. Im bin come court on Tuesday to seek protective bail against arrest wen dem finally gbab am go custody.

Oga Khan imself be like e don prepare for am. Afta dem detain am, im release one video wey im don record earlier, say e dey likely dem go don arrest am by di time wey im supporters go see di message.

But e dey possible say neither im or im lawyers expect make dem arrest am for court premises because Oga Khan don appear for court for bail before. But dis time di executors of di warrant no be police, but one paramilitary force, di Punjab Rangers.

Leaders and supporters of Oga Khan Pakistan Tehreek-e-Insaf (PTI) party argue say dis na proof of di army involvement. Dem say di arrest get little to do wit corruption charges and everyting to do wit Oga Khan ongoing public battle wit di army. Im don accuse di army and di spy agency, di Inter-Service Intelligence (ISI), say dem join hand dey plan to assassinate am - im survive one shooting last year.

Di kontri generals, wey don seize power three times since Pakistan independence for 1947, don since play ogbonge role for politics. Di believe be say Oga Khan get dia support too as e enta power. But di privilege of im birth, im fame wey e get from playing cricket, and im charisma drive im popularity far higher an anytig Pakistan don ever see in recent years.

Supporters of Imran Khan hold protest for Hyderabad on 9 May 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wen dem overthrow am as PM, many believe say na sake of im poor track record for office and say im bin get gbege wit di army. But e quickly go on di offensive, criticise di army and join bodi wit one populist narrative wey pipo believe. And im do am loudly, dey hold rallies and marches wey draw ogbonge crowds, dey campaign for local elections, most of which im party later win.

Dis one continue for months even as Oga Khan manage to dodge arrest. Den im publicly accuse one intelligence official say dem try assassinate am. Army officials deny di charge, and just di day before im arrest, dem warn make e no repeat am.

Now, oga Khan supporters say di army don cross "red line" - dat of di former PM imself. And as public anger turn against di army, Pakistan dey witness moment wey dem no expect.

For one statement, di military say dem go remember 9 May as "a dark chapter" and warn of "extreme reaction" if protesters carry out more attacks on military and oda state installations.