Manchester synagogue attack victims dey identified as Melvin Cravitz and Adrian Daulby

Melvin Cravitz

Wia dis foto come from, FACEBOOK

    • Author, Maia Davies
  • Read am in 5 mins

Authorities don identify di two Jewish men wey die for di Synagogue attack for Manchester on Thursday, 2 October.

Police say 66-year-old Melvin Cravitz and 53-year-old Adrian Daulby come from Crumpsall, wia di Heaton Park Congregation Synagogue dey located.

Three odas still dey for hospital wit serious injuries afta Jihad Al-Shamie use car jam pipo bifor e begin stab odas on Thursday morning.

Di attack, wey police declare as terrorist incident, hapun on Yom Kippur, di holiest day for di Jewish religious calendar.

Di attacker, wey police shoot dead for di scene, na 35-year-old British citizen wey come from Syria.

Di home secretary Shabana Mahmood tell BBC say di counter terrorism police no get record of am.

Wetin happun?

Emergency services for di scene

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Emergency services for di scene afta di attack on Thursday morning

Police bin respond to reports on Thursday, 2 October around 09:31 BST on Thursday say one car bin drive go jam members of di public, and dem stab one man.

Di incident hapun for Heaton Park Hebrew Congregation Synagogue for di Crumpsall area for di north of di city.

By 09:37, Greater Manchester Police (GMP) declare am as major incident.

Di force for statement tok say: "Greater Manchester Police firearms officers fire shots at 09:38.

"Dem shoot one man wey dem believe to be di offender."

Di North West Ambulance Service confam say na major incident and dem deploy dia staff go di scene.

Di man wey dey stabbed na one security guard, police and Greater Manchester Mayor Andy Burnham tok.

One eyewitness, Gareth wey follow BBC Radio Manchester tok say im bin dey drive im delivery van at di time of di incident.

E say im bin dey inside traffic, and tink say na "normal collision", but as e go closer im see one man "wey dey bleed for ground".

Gareth say im see anoda man "wey lie down for floor" for front of one car, and e hear pipo dey shout.

E say im see anoda pesin, one man wey hold knife and dey use am "stab di window" of a nearby building "and dey try to get in".

"Within seconds, di police land, dem warn am but e no hear, so dem open fire," Gareth explain, e say di man wey hold knife later fall for ground.

Di man "start to dey get back up and di police shoot am again", Gareth tok - e describe di scene as "nerve-racking".

One man show di synagogue for di north of Manchester

How many pipo don die and how many injure?

Greater Manchester Police say two pipo don die.

Police also believe say one third pesin, one man wey dem believe say na di offender, wey police shoot also don die.

Three oda members of di public still dey for serious condition.

Police earlier tok say di injuries na sake of both di motor and stab wounds.

Wetin we know about di suspect?

Jihad Al-Shamie

Wia dis foto come from, FACEBOOK

Police say dem believe say di attacker na 35-year-old Jihad Al-Shamie, one British citizen of Syrian descent.

Dem understand say e enta UK wen e be small pikin, and dem grant am British citizenship for 2006 as a minor.

Police shoot Al-Shamie dead seven minutes afta dem alert officers to di attack on Thursday morning.

Police chief Sir Stephen Watson tok say di suspect bin dey wear "one vest wey be like say get explosive device" - but di force later confam say no be so..

Al-Shamie name no appear for initial searches of police and security service counter-terrorism records, and e no dey under current investigation, according to PA news.

Further checks dey go om to see if e show for any records of oda investigations.

Greater Manchester Police say dem don arrest three oda suspects on suspicion of commission, preparation and instigation of acts of terrorism. Dem be two men wey dey dia 30s and one woman for her 60s.

Wetin be Yom Kippur?

Yom Kippur na di holiest day for di Jewish religious calendar. Large numbers of pipo dey attend synagogues and dey fast dat day.

Rabbi Jonathan Romain, of Maidenhead Synagogue, tell PA news agency tok say dis na "evri Jewish pesin worst nightmare".

"Dis day no be just sacred day, na di most sacred for di Jewish calendar, but na also a time of mass gathering, and di time wen di Jewish community, however religious or irreligious, dey gada togeda."

Prime Minister Sir Keir Starmer say im thoughts dey wit di loved ones of all dos wey dey affected, and e thank emergency services plus all di first responders."

E go chair one meeting of di govment emergency Cobra committee for London today afternoon, as e dey leave one European summit for Denmark for di meeting.

Di home secretary say she dey "horrified" by news of di attack on di holy day and she say she dey receive updates from local police.

Conservative leader Kemi Badenoch tell BBC say e be like "an outrageous attack on di Jewish community on dia holiest day" - she call am "vile and disgusting".