How woman wey no know say she dey pregnant born inside football club toilet

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC
- Author, Nikki Fox
- Role, BBC health correspondent, Suffolk
- Reporting from, Lowestoft
- Read am in 6 mins
One woman tok say she no get any idea say she get belle until she give birth inside one football club toilet.
Charlotte Robinson, 29, tok say di arrival of Henry for Lowestoft, Suffolk, na "di biggest shock of my life" but proof say "miracles dey hapun".
Six hundred pipo attend di match on 24 August wen Mrs Robinson rush go one cubicle, she feel di urge to push and she see her son head.
Dr Louise Jenkins, di head of midwifery for Anglia Ruskin University, tok say cryptic pregnancies, na wia di mama dey unaware of di baby, e dey affect about one in 2,500 births.

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC
Mrs Robinson, na residence of Bradwell near Great Yarmouth for Norfolk, she tok say tins dey normal up until she born Henry.
She dey work for office job and bin dey on a trip to London wit her husband Macaulay.
"I no feel am move... Nothing dey different at all," she explain.
Mrs Robinson tok say she don suffer hip pain since she born her 18-month-old daughter, so she no tink about anything wen e become worse
Afta di football match finish for Kirkley and Pakefield, she enta di toilet and feel sudden pressure.
"I be like hold on for one minute, I know wetin be dis feeling. I get dis quick feeling and e be like say something dey dia wey no suppose dey dia."
Mrs Robinson quickly lift her son out of di toilet and try to contact her family, but di signal dey poor.
"I dey try to call my husband or my mother-in-law to come and help and someone answer di phone."

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC
Mr Robinson no wan enta di women toilets so im mother Miranda enta instead.
She describe di scene as "utter chaos".
"I just wonder if di baby even dey alive becos e look so small," she tok.
"We eventually give Macaulay chair becos e no dey like blood!"
She tok say anoda family member use one football shirt to wrap di baby, while di club fetch towels and foil sheets.
One off-duty paramedic help until di ambulance arrive.

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC
Mr Robinson describe di day as "surreal but amazing".
E tok say: Pipo go say I recover pretty quickly from di drink... afta I hear di little man cry.
"Everything just dey go slowly. E be like say di earth just stop."
Dr Jenkins, wey dey live for Anglia Ruskin campus for Chelmsford, tok say Mrs Robinson no dey alone.
"We dey get lots of women wit di surprise and dem no dey know say di baby dey dia until dem born am," Dr Jenkins tok.
She tok say di risk be say dem go miss antenatal care.
"Generally, once dem born di baby, dem go need good check ova to make sure everything dey healthy."
Wetin be cryptic pregnancy?
- Dem dey use di term wen woman no realise say she get belle - sometimes until she dey in labour
- Irregular bleeding fit make women tink say dem neva miss dia period. Dis fit hapun wen di woman still dey young or e just born pikin recently, or women wey dey go through menopause e fit go up to nine months without any period. Women wit polycystic ovary syndrome also get irregular periods
- Some women dey mistake pregnancy spotting for light bleeding
- If di baby legs and arms dey face towards di front, e dey likely possible to feel di baby moving. E dey also make di bump more visible
- About 300 births for di UK dey affected yearly. E dey equivalent to one birth per maternity department
Source: Dr Louise Jenkins, head of midwifery, Anglia Ruskin University

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC

Wia dis foto come from, JANE HUTCHINSON
Di couple tok say di day, she born Henry dey emotional becos dem dedicate di match to di man Mr Robinson dey call "uncle Huggy".
James Hutchinson die of brain tumour for 2023 and di club dey try raise money for memorial garden.
Di couple named dia new baby Henry James in memory of di late "uncle Huggy".
Mr Hutchinson wife Jane tok say di timing of di birth dey "so special" and dat wen she announce di news to di remaining supporters, something unforgettable hapun.
"My friend little girl run to me and she say, 'See wetin land on me' and na one white feather land on her, so I just feel say e dey here on dat day."

Wia dis foto come from, SHAUN WHITMORE/BBC
Mrs Robinson tok say dem don dey adjust to Henry arrival, but na good one for di family, afta six family members die in 12 weeks.
"I no fit imagine life without am now," she tok.









