Nigeria Super Falcons shine for Wafcon as dem gbab three awards and $1m prize money

Nigeria vs Morocco, Nigeria national team dey celebrate wit di trophy afta dem win di 2024 Women's Africa Cup of Nations final football match.

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/Getty Images

Read am in 4 mins

Nigeria Super Falcons shine for di 2024 Women's Africa Cup of Nations as dem achieve di mission X. Dem win di continental title for di tenth time plus di $1 million prize money (1.5 billion naira)

On Saturday night, di Super Falcons of Nigeria beat di host kontri Morocco 3-2 for di final game for di Olympic Stadium for Rabat, Morocco.

As di game finally end on Saturday night, di Nigerian team no just lift up di trophy for di tenth time, but dem also win three out of di six awards.

Nigeria as di winning nation go also walk away wit, $1 million prize money.

Who win and wetin dem win?

Rashidat Ajibade, Nigeria captain win di Best Player of di tournament.

Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie also win di Best Goalkeeper Award for di tournament.

Justine Madugu win Coach of di Tournament afta e guide di his team win di trophy wit di record of winning five match, scoring di highest number of goals and finishing wit only one draw during di tournament.

Esther Okoronkwo win title of di Woman of di match for di final game against Morocco.

Moroccan captain, Ghizlane Chebbak win di Golden Boot at di tournament, dis na di third time she go win di title.

Di Banyana Banyana of South-Africa, win di Fair Play Award wit total of 510 points at di tournament.

How much Nigeria team and odas go win?

Nigeria vs Morocco game

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/Getty Images

For dis just concluded CAF-WAFCON, di winning nation, Nigeria go walk away wit $1,000,000 as di prize money

Second place - Morocco go walk away wit $500,000

Third place -Ghana go walk away wit $350,000

Fourth place - South-Africa team go walk away wit $300,000

Quarter-finalists go walk away wit $200,000 each

Third in Group Stage go walk away wit $150,000

Fourth in Group go walk away wit $125,000 each

Rasheedat Ajibade - Wafcon Best Player Award

Rasheedat Ajibade pose wit her Woman of di Tournament trophy afta di 2024 Women's Africa Cup

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/Getty Images

Rasheedat Ajibade na di best player of di Women Africa Cup of Nations (WAFCON) tournament afta Nigeria win against Morocco 3-2 on Saturday night.

Di 25-year-old Atletico Madrid player contribute wit one goal and two assists during di tournament, but her overall performance during di matches na im make Nigeria win di game.

Rasheedat don win dis title three consecutive time against Botswana, Zambia, and South Africa.

In 2022, she bin win di highest goalscorer at WAFCON, showing her leadership qualities at di Morocco tournament.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Chiamaka Nnadozie - Wafcon Best Goalkeeper Award

Chiamaka Nnadozie pose wit her Best Goalkeeper trophy at di 2024 Women's Africa Cup

Wia dis foto come from, ABDEL MAJID BZIOUAT/Getty Images

Chiamaka Nnadozie na di official winner of Best Goalkeeper of di TotalEnergies CAF Women's Africa Cup of Nations 2024.

Di twenty-three year old, Nnadozie show her skills for di field wit her fast flexible ability to catch any ball wey come close to di goalpost.

Afta series of outstanding performance during di tournament she win di finest goalkeepers in African women's football.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Justin Madugu - Wafcon Coach of di Tournament Award

Justin Madugu officially win di Coach of di Tournament at di 2024 CAF TotalEnergies Women's Africa Cup of Nations (WAFCON). Di 61-year-old na local coach from Adamawa, e guide di female team wit im own experience to win di 2024 WAFCON game.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 3

Ghizlane Chebbak - Wafcon Golden Boot Award

Ghizlane Chebbak for di third time win di Golden Boot title at di TotalEnergies CAF Women's Africa Cup of Nations (WAFCON) 2024.

Di Moroccan captain, na di top scorer during di tournament. Chebbak continue to follow her papa foot steps, Larbi Chebbak, 1976 Africa Cup of Nations winner wit Morocco.

Chebbak no dey waste time on di field, she show she dominance spirit during di game against Zambia, delivering good field performance. Also, within 13 minutes she pick di ball and score against Nigeria at di finals.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 4

Banyana Banyana of South-Africa - Wafcon Fair Play Award

Banyana Banyana of South-Africa fail to retain dia continental title, but dem leave di competitio winning di Fair Play Award wit total of 510 points award base on di Technical Study Group criteria.

Banyana Banyana start di tournament winning against Ghana 2-0, but di Ghanaian team come back to win against dem at di Semi-Final to win South Africans.

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 5