First time for Morocco or 10th for Nigeria - who go win Wafcon final?

A composite image divided into two columns showing Sakina Ouzraoui in red Morocco shirt wit number 19

Wia dis foto come from, Getty Images/Backpage Pix

Wetin we call dis foto, Morocco forward Sakina Ouzraoui and Nigeria captain Rasheedat Ajibade
    • Author, Rob Stevens
    • Role, BBC Sport Africa, Rabat
  • Read am in 6 mins

Nigeria bid for a record to extend dia 10th continental title wen dey face host nationa Morocco in di final of di 2024 Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) on Saturday.

Both sides dey unbeaten and di West Africans don only concede one goal in five matches on dia journey to di 21,000-capacity Olympic Stadium in Rabat.

Runners-up in dat same stadium in 2022, Morocco dey look for redemption.

If di Atlas Lionesses lift di trophy for di first time e go offer some return on di vast investment wey di kingdom don pour into di women game in recent years.

To pick favourite no easy, wit neither side making any compelling case in di semi-finals.

Di North Africans, wey be Spain Women World Cup-winning coach Jorge Vilda in di dugout, wey need penalty kicks to beat Ghana, while Nigeria, di continent' top-ranked side, score a stoppage-time winner to knock out defending champions South Africa.

Confidence, however, dey high in di Super Falcons camp, wit dia campaign branded as 'Mission X'.

"Mission X - na wetin dis entire tournament dey about," defender Michelle Alozie bin tell BBC Sport Africa.

"E dey go all di way to di final and win am. We dey grow as a team and I think say dat dey show for evri game."

Di winners go pick up $1m (£743,000) in prize money as well as di new-look Wafcon trophy.

Listeners to di BBC World Service in Africa fit hear live radio commentary (kick-off 20:00 GMT), while di match go dey be streamed for viewerinin di UK on iPlayer and di BBC Sport website and app.

Atlas Lionesses one win from history

Morocco players celebrate inside stadium afta dem win dia Women's Africa Cup of Nations semi-final

Wia dis foto come from, Confederation of African Football

Wetin we call dis foto, Morocco fit become di first North African side to lift di Wafcon trophy

Morocco return to Wafcon for di first time since 2000 wen di kontri bin host di 2022 edition, but di hosts, wey go also stage di 2026 finals in March, now don firmly establish themselves as one of di continent elite sides.

However, dia performances dis month no dey as convincing as three years ago, becos dem bin fall behind twice against Zambia in di opening game and den trail Ghana at half-time in di last four.

Goalkeeper Khadija Er-Rmichi don look shaky on several occasions, 34-year-old star player and captain Ghizlane Chebbak don fade in di knockout stage and winger Sanaa Mssoudy never display di level of trickery and impact wey bin see her named as di best player for last year Women African Champions League and in di 2024-25 Moroccan league campaign.

Yet Chebbak, di joint-top scorer in di tournament wit four goals, still dey capable to produce in crucial moments and striker Ibtissam Jraidi provides a cutting edge up front.

"I don see one Moroccan team wey no really give up even wen dem dey trailing," Desire Oparanozie, a four-time Wafcon winner wit Nigeria, bin tell BBC Sport Africa.

"Dem don dey very impressive. Dey keep coming at you and dat na really positive tin."

Vilda appointment dey controversial, sake of say e bin leave di Spain job for middle of di fallout from one incidentfor di 2023 Women World Cup final wen den-federation president Luis Rubiales bin kiss player Jenni Hermoso without her consent.

Rubiales dey found guilty of sexual assault and fined, while Vilda was cleared of allegations of coercion.

Yet im presence in di Morocco dugout don divide supporters - even if e fit create history by helping a North African side win Wafcon for di first time while also achieve unique personal double.

"Morocco go need a coach to make dem more dan di sum of dia parts to win dis final," Algerian journalist Maher Mezahi bin tell di BBC World Service.

"I don see arguments to say dat Morocco to hire Vilda, if e get dem to win di Wafcon, fit worth am sake of say to do so much more for di women game - even if dat dey little bit tainted wit am as di coach."

Super Falcons fit complete Mission X?

Esther Okoronkwo in dark green Nigeria kit celebrate a goal against Zambia with two team-mates running towards her

Wia dis foto come from, Backpage Pix

Wetin we call dis foto, Nigeria bin deliver di most complete team performance of Wafcon 2024 when Esther Okoronkwo help di Super Falcons to a 5-0 quarter-final win over Zambia

Meanwhile, Nigeria, wey don for long be di dominant force in African women football, never dey shy to express dia intentions to reclaim di title wey dey last win in 2018.

Di kontri football federation bin announce Mission X bifor di finals and don be hot topic during media engagements wit players.

Coach Justin Madugu don find balance to im side wey don display physicality for di back, dominance in midfield and a potent front three wey dey spearheaded by Esther Okoronkwo intelligent build-up play.

Di Super Falcons threat from across di pitch dey underlined wit nine different goalscorers, and di side ground out victory against South Africa wen right-back Alozie na di unlikely match-winner.

"We dey born wit di zeal to fight and want to win every game," forward Okoronkwo tell BBC Sport Africa.

Goalkeeper Chiamaka Nnadozie, wey don signed for Women Super League side Brighton, don rarely dey tested and di only time she don dey beaten thus far na from di penalty spot.

Oparanozie think say di Super Falcons go dey out for "revenge" after dia semi-final exit at the hands of the Moroccans in 2022 - game wey bin see dem get two players sent off by di 72nd minute and eventually beaten on penalties.

Managing a partisan stadium

A capacity crowd dey expected in di Moroccan capital yet Oparanozie no anticipate say overwhelming support for di hosts go affect her compatriots.

"Nigeria dey known for big moments like dis," di 31-year-old tok.

"In 2016 we bin play against di host nation Cameroon [in di final]. Di stadium dey filled to 40,000 capacity and dat no stop Nigeria from winning."

Di 2024 tournament, dey delayed for a year sake of scheduling issues, don see di continent lowest ranked sides cause issues for those above dem, but di final still be one many predicted.

If Morocco fit bridge a gap of 24 places in di world rankings - and hand Nigeria dia first ever final defeat - e go put a new name on di Wafcon trophy.

Victory for di hosts fit potentially tilt di balance of power in Africa, as well as putting pressure on Morocco men ahead of di 2025 Africa Cup of Nations, wey kick off in di kingdom in December.