Who be Kojo Choi wey Ghana president appoint as ambassador to South Korea

Wia dis foto come from, KOJO CHOI/FACEBOOK
Ghana President John Mahama make im latest appointment for di role of ambassadors and high commissioners to some kontris and dis latest appointments don spark conversation.
Inside one letter from di presidency wey di secretary to di president Dr Callistus Mahama write, di ambassadors involve reps to Namibia, Hungary, Italy, DR Congo, Burkina Faso.
Di odas na Kenya, Saudi Arabia and South Korea.
But di ambassador for South Korea na who dey trend since Thursday evening when di list don comot.
On top social media pipo dey tok.
While some dey ask if im qualify to be ambassador, odas dey wonder if im be Ghanaian sake of im get Korean roots and e look like Korean.
So who be dis Kojo Choi wey di president now appoint as ambassador to South Korea?

Wia dis foto come from, KOJO CHOI/FACEBOOK
Profile of Kojo Choi
Kojo Choi na 47-year-old Korean wey bin naturalize for Ghana.
Im bin dey di kontri for many years wey im education largely na from Ghana wey im be businessman for ova 20 years.
Kojo Choi bin do im internship as im still be student for di Tema oil refinery (TOR) wia im propose to di management at di time say im wan supply Korean equipment to TOR as dem bin dey revamp di refinery for 1994.
Inside one post on top im social media page, Kofi Choi tok say im bin witness every Ghana election under di 1992 constitution.
"We bin shock di world, wit peaceful, democratic election and democratic transitions. Today, Ghana na beacon of democracy for Africa," Kojo Choi write.
Im add say, "I fit leave Ghana to di US or Korea at some point for so-called greener pastures but I bin naturalize as Ghanaian wey I neva look back since."
Inside dat post, im also tok say "I bin look back at my life as I don dey approach 50 years - I dey look back wit gratitude. Dis journey na blessing."
"I dey proud to be Ghanaian."
Oga Kojo Choi also bin add say, "Ghana no be my birthplace but dis na my true home."

Wia dis foto come from, KOJO CHOI/FACEBOOK
Kojo Choi na businessman wey im be president of one payment processing company - Payswitch wey dem set up for 2016.
Di company dey authorized by govment of Ghana wia im be third party payment processor.
Currently, di company don dey provide payment processing services for five banks for Ghana wia dem also be di payment partner for small and large retail businesses.
Im comot Ghana for 2023 to Kenya to work and try to open business for dia, but im return to Ghana afta only four months.
Kojo Choi get wife and six children, "I bin take root for Korea, dem transplant me to Ghana, na wia my life don begin and bear fruit."
For anoda post, oga Kojo Choi bin remember di role im play for Ghana Winter Olympics for PyeongChang for South Korea in 2018.
Im support di Ghana Olympic committee wey dem ask am to be di deputy head of mission, e tok about am say na at "my own expense no be as politician or businessman but as servant of God wey wan to represent Ghana well."
"Dat experience bin change my life, na di first time for my life wen diplomacy and faith don come togeda; dat na unforgettable moment for me," oga Kojo Choi bin tok.










