Wetin be di strength of di Nigerian passport? - latest Henley Passport Index show

Nigerian passport with money

Wia dis foto come from, Osarieme Eweka/Getty Images

Read am in 4 mins

Nigeria passport don move to di 88th spot in di latest Henley Passport Index ranking wey dem release on Wednesday but Nigeria passport still dey among di weakest passport for Africa.

Inside dis latest report Nigeria move from 92nd place to 88th from di previous year wit only visa-free access to 45 kontris

Di index use di data by di International Air Transport Association (IATA) to rank 199 passports based on dia strength to travel to 227 kontris without visa.

Passports na travel document wey dey dey grant access for citizens across di world.

Na Singapore hold di record for di most powerful passport, wit access to 193 nations, while Afghanistan rank di weakest passport globally wit access to only 25 kontris.

Oda Asia kontris also lead di global ranking wit Japan and South Korea ranking second wit access to 190 kontris visa-free.

Di top 10 kontris globally na Singapore, Japan, South Korea, Denmark, Finland, France, Germany, Ireland, Italy and Spain.

India, Saudi Arabia and Qatar passports na di biggest climbers for di pass six months wit access to more kontris visa-free dan 2024.

While Venezuela, US, Vanuatu and UK ranking dey drop fast compare to di previous year.

Seychelles na di highest ranked kontris for Africa wit access to 156 kontri globally.

Di kontri rank 24th position while Mauritius wey rank 29 on di list na di second Africa kontri wey top di list wit access to 151 kontris and South Africa rank 48 wit visa-free access to 106 kontris.

Afta dat, Botswana, Namibia, Lesotho, Malawi follow in di list.

Nigeria rank 88th sharing di spot wit Ethiopia and Myanmar, dis three kontris get visa-free access to only 45 kontris.

Nigeria Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo neva comment on di latest report and even wen BBC Pidgin try to reach am.

Kontris wit di strongest passports in di world

Foto of traveller at airport

Wia dis foto come from, Getty Images/Riska

According to di Henley Index, na Singapore top di list, followed by Japan and South Korea in second place.

Seven European kontris also rank third place in di list— Denmark, Finland, France, Germany, Ireland, Italy, and Spain hold thirdplace in di list wit access to 189 kontris visa-free.

Austria, Belgium, Luxembourg, Netherlands, Norway, Portugal and Sweden rank 4th place wit access to 188 kontris visa-free.

Greece, New Zealand and Switzerland rank 5th place wit access to 187 kontris visa-free.

United Kingdom rank 6th place wit access to 186 kontris visa-free.

Australia, Czechia, Hungary, Malta, and Poland rank 7th place wit access to 185 kontris visa-free.

Canada, Estonia, United Arab Emirates rank 8th place wit access to 184 kontris visa-free.

Croatia, Latvia, Slovenia and Slovakia rank 9th place wit access to 183 kontris visa-free.

Iceland, Lithuania, and United States rank 10th place wit access to 182 kontris.

Kontris wit di weakest passports in di world

South Sudan and Democratic Republic of Congo rank 90th wit access to 43 kontris.

Iran and Sri Lanka rank 91st wit access to 42 kontris visa-free.

Sudan rank 92nd wit access to 41 kontris visa-free

North Korea rank 93rd wit access to 40 kontris visa-free.

Bangladesh, Eritrea and Palestinian rank 94th wit access to 39 kontris visa-free

Libya, Nepal rank 95th wit access to 38 kontris visa-free

Pakistan, Somalia, Yemen rank 96th with access to 32 kontri visa-free

Iraq rank 97th wit access to 30 kontris visa-free.

Syria rank 98th wit access to 27 kontris visa-free.

Afghanistan rank 99th wit access to 25 kontris visa-free.

Top 10 strongest Africa passports

Seychelles

Mauritius

South Africa

Botswana

Namibia

Lesotho

eSwatini

Kenya

The Gambia

Tanzania

Ten weakest Africa passports

Somalia

Libya

Eritrea

Sudan

South Sudan

Democratic Republic of Congo

Nigeria

Ehtopia

Djibouti

Republic of Congo.