Simple guide to Edo state govnorship election

Wia dis foto come from, Reuters
On Saturday, September 21, 2024, Edo State pipo go comot go vote for who go take over from Godwin Obaseki as di govnor of di state.
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don tok say dem dey ready for di elections and dem call on residents of di state who dey old enough and who don register to vote, to come out and exercise dia franchise.
As di day don reach finish, dis na di important tins to know about di election.
Who be di candidates?

Sixteen men and one woman na im dem dey contest for dis ogbonge position of govnor of Edo State. Even though say na only three of dem wey dia campaign don dey hot.
Di names of di contestants and dia parties na:
- Iyere Kennedy – Accord Party (A)
- Iseghohi Tom – Action Alliance (AA)
- David Udoh Oberaifo – African Action Congress (AAC)
- Derek Izedonmwen Osarenren– Africa Democratic Congress (ADC)
- Kingson Akhimie Afeare – Action Democratic Party (ADP)
- Monday Okpebholo– All Progressives Congress (APC)
- Isaiah Osifo – All Progressives Grand Alliance (APGA)
- Odaro Ugiagbe– Allied Peoples Movement (APM)
- Amos Areloegbe – Action Peoples Party (APP)
- Edeipo Osiariame – Boot Party (BP)
- Olumide Akpata – Labour Party (LP)
- Friday Azemhe Azena – New Nigeria Peoples Party (NNPP)
- Asuerinme Ighodalo – Peoples Democratic Party (PDP)
- Patience Key Ndidi – Peoples Redemption Party (PRP)
- Abdulai Anerua Aliu – Social Democratic Party (SDP)
- Paul Okungbowa Ovbokhan – Young Progressives Party (YPP)
- Akhalamhe Amiemenoghena - Zenith Labour Party (ZLP)
Sabi pipo tok say di main contest go be between Monday Okpebholo of di APC, Asue Ighodalo of di PDP and Olumide Akpata of di LP.
Time and how to vote

Wia dis foto come from, EPA
Voting go start by exactly 8.30 am across di various polling stations for di state, but Inec officials dey expected to don arrive by at least 8:00am to set up for di election.
Na only pipo wey get di Permanent Voters Card (PVC) go fit vote.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wen di voter approach di Inec officials, e go first show im PVC and di Inec pipo go check am wit di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).
Afta dat, di Inec pesin go also check di name of di voter for di voters register and mark am say e don dey accredited.
Di voter go den collect di ballot paper and go to di voting cubicle to thumbprint on am bifor e go drop am inside di ballot box.
Inec officials go also apply ink on di thumb of di voter to show say di pesin don vote true-true.
Afta voting, di voter fit go house if e want, or e go stay some meters away from di voting area to wait for sorting and counting.
Wen di result go dey announced?
Di final step for di elections na di official announcement of election results by di electoral administrators.
Dis na how dem dey announce am for govnorship election according to Inec.
Di Presiding Officers go send results of di election to di RA Collation Officer.
RA Collation Officer go collate and send di result to di local government Collation Officer.
Di local government Collation Officer go collate di results and send to di State Returning Officer.
Di State Returning Officer go den collate di results from di LGA Collation Centres, and declare di result and return di winner as Governor elect for di state.
Candidate for di election to di office of Governor go dey declared winner if e get:
- Di highest number of votes cast for di election; and
- Not less dan one-quarter of all di votes cast in each of at least two-thirds of all di LGAs for di state.
Na afta all dis, di returning officer go declare di winner.
E fit take between one to three days depending.
For di last election for 19, September 2020, Inec declare di winner on 20, September 2020.
Wen di new govnor go begin work
Whoever win di election get to wait till November 16, 2024 wey be wen e go take oath of office and start work.














