Police identify gunman wey shoot pipo die for Monterey Park for America

Wia dis foto come from, Getty Images
California police don identify di gunman wey dem suspect say kill 10 pipo for one ballroom dance studio near Los Angeles as Huu Can Tran.
Authorities later find 72 years old Huu Can Tran dead for one white van.
E get self-inflicted gunshot wound and dem declare am dead for di scene, LA County Sheriff Robert Luna tok.
Celebrations for Lunar New Year bin dey go on for Monterey Park, wey dey known for dia large Asian population wen di shooting incident happun.
Di mass shooting wey include septuagenarian na one of di deadliest for California history and e happun at 22:22 local time on Saturday (06:22 GMT on Sunday).
Videos on social media show one large police presence for di city wey dey located about eight miles (13km) east of Los Angeles.
Ten pipo wound for di shooting, and seven still dey hospital, some dey for critical condition, police tok for one news conference on Sunday afternoon.
Police Chief Scott Wiese say wetin im officers find for di scene of di shooting na "scene of carnage".
End of Di one wey oda users dey read well well
And say di first officers to reach dia na some of di youngest for im squad, dem only just finish dia training few months ago.
"Dem come across a scene wey none of dem prepare for," e tok. "injured pipo dey inside and dead pipo inside. My young officers do dia job."
About 30 minutes later, di gunman go anoda dance studio for di nearby town of Alhambra.
E enter di studio, but two pipo manage to wrestle di weapon off am - one semi-automatic assault pistol wit one extended magazine - and e escape.
Sheriff Luna say im believe say di weapon dey illegal for California, and add say im need to torchlight di mata well.
E praise di two community members, wey im consider to be heroes for overpowering di gunman and taking di weapon form im hand.
"Dem save lives, di mata fit dey worst ," di sheriff tok, adding say e believe Tran plan to kill more pipo.
For hours on Sunday, authorities go round di Los Angeles area in search of di gunman.
Just before 13:00 local time (21:00 GMT) - about 12 hours afta di shooting -SWAT team gada one white van for carpark inside Torrance, about 30 miles (48km) fromd di Monterey Park shooting scene.
Sheriff Luna say dem hear single shot from inside di van as dem approach and den find di suspect slump over di steering wheel.
Dem recover evidence including one handgun, and dem identify di man as di gunman.

Wia dis foto come from, Reuters
Di gunman dey look for im wife, eyewitness

Wia dis foto come from, EPA
Police neva reveal di motive for di shooting, but one witness tell tori pipo, CBS say di gunman come di Monterey Park dance studio to find im wife.
She tell CBS - wey be BBC media partner for US say - di gunman begin shoot upandan for di ballroom without saying anything.
"E see im wife there," according to di witness wey no want make we mention im name.
"E start to shoot evri body... wen dem dey dance."
Di witness no fit confam say di gunman na di same man authorities don share foto of, but tok say im clothes look similar.

Also, anoda eyewitness tell di Los Angeles Times say three pipo bin run enta im restaurant and dey tell am to lock di door as one man wit machine gun dey di area.
Di annual Lunar New Year festival na one weekend-long event wey before now dey draw crowds of more dan 100,000 visitors.
Dem schedule Saturday night festivities to end for 21:00 local time.
Monterey Park get population of about 60,000 with 65% of dem wey be Asians.
President Biden and police authorities tok

Wia dis foto come from, Reuters
US President Joe Biden say dem go mobolise full federal support to investigate di Monterey Park shooting as America kontinu to “search for answers”.
As a "mark of respect" for di victims, dem go lower flags on goment buildings to half-mast until sunset on Thursday, President Biden don announce.
For statement earlier on Sunday, e say im dey tink of and pray for doz wey die and wunjure.
Sake of dis attack, police for Houston, Texas, say dem dey step up security for venues for di city celebrating Lunar New Year.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Also, LA County Sheriff Robert Luna tell tori pipo during one press briefing say "gun violence need to stop".
Wetin don happun so far for di Monterey Park shooting
- Police don identify di suspected gunman as 72-year-old Huu Can Tran, and confam say e shot and kill imsef inside one white van wey officers bin surround earlier on Sunday
- No oda suspects dey, police tok.
- Detectives neva still find out di motive for di attack, but dem dey torchlight Tran mental and criminal history.
- E no dey clear yet how many guns im use for di shooting, but police don seize one semi-automatic pistol and handgun. One of di weapons wey dem don see fit no dey legal to own inside California, but more investigation dey needed, police tok.
- Seven of di 10 pipo wey injure for di shooting still dey for hospital. Police earlier confam say 10 pipo die, but say dem believe say Tran bin plan to kill more pipo.
- Authorities still dey try confam di age of di victims, but most of dem appear to dey over 50 years.
- LA County Sheriff Robert Luna call for conversation about gun control as dis shooting happun.
- California get some of di "strictest" laws for di kontri, but "di status quo no dey work", e tok.











