How Russia dey retaliate sanctions di West give am

Wia dis foto come from, Getty Images
Di price of Gas don increase afta Russia refuse to supply Germany and oda European kontris.
Dis dey come afta Russia threaten dem dis week.
European gas price don go up to almost 2%, di highest afta Russia invade Ukraine.
Germany dey import 55% of dia gas from Russia and most of dem dey enta di kontri thru di Bord Stream 1 – di rest dey come from land-based pipelines.
As e be so, Russian energy firm Gazprom say di latest supply reduction na to allow maintenance work on one turbine.
But di German goment say no technical reason dey for Russia to reduce di supply.
How Russia take dey retaliate di sanctions from di West

Wia dis foto come from, Getty Images
Since di invasion of Ukraine, Western kontris don sanction Russian oil and gas, wey make Moscow sef sama warnings say dem go retaliate.
Apart from di reduction of di supply of gas to EU kontris, Russia bin announce say dem go withdraw form di International Space Station afta 2024 and build dia own station instead.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di US, Russia plus oda partners don successfully work togeda on di ISS since 1998.
But dia relationship don sawa since Russia invade Ukraine and Russia don before enow threaten to comot di project because of di sanctions di West sama am.
Di ISS - na joint project wey involve five space agencies – e don dey for orbit around Earth since 1998 and dem don use am carry out thousands of scientific experiments.
Dem approve to operate until 2024, but di US wan extend am for six more years wit di agreement of all partners.
Russia also don ban exports of more dan 200 products wey include telecoms, medical, vehicle, agricultural, electrical equipment and timber.
Dem dey block interest payments to foreign investors wit goment and don ban Russian firms make dem no pay dia shareholders for overseas.
Russia no also allow foreign investors wey get billions of dollars worth of Russian investments from selling dem.
President Vladimir Putin demand say make "unfriendly" nations for Europe pay for gas in Russian roubles.
E say dis go help support di value of Russia’s currency.
Poland, Bulgaria and Finland refuse to do am and Russia cut off dia supplies.
Several European energy companies don dey pay gas via Russian bank accounts, dem go convert euros into roubles. Dem insist say dem must make di payments in line wit di sanctions.
Sanctions wey Russia dey face?

Wia dis foto come from, Getty Images
Since Russia attack Ukraine, di West announce some measures to reduce dia ability to pay for di war in form of sanctions.
Western kontris bin target wealthy individuals, banks, businesses and state-owned enterprises.
- Financial measures
Di US stop Russia from paying dia debts as dem hold dia money wey dey US banks wey make am hard for Russia to repay dia international loans.
Dem also freeze Russia central bank asset wey make dem no fit use di $630bn e get for im foreign reserves.
Dem remove major Russian banks from di international financial message system swift wey go dlay payments to Russia for dia oil and gas exorts.
Di UK has comot key Russian banks from di UK financial system, freese di assets of all Russian banks, ban Russian firms from borrowing money and put limit on top di number of deposits Russians fit make for UK banks.
- Oil and gas
Dem believe say Russia make nearly $100bn from di export of oil and gas during di first 100 days of di war.
Sake of dat, EU say dem go ban di importation of Russia oli by di end of 2022.
Di US ban all Russian oil and gas import
German halt plan fpr di opening of one major gas pipeline from Russia
Di EU say dem go stop Russian coal imports by August
- Targeting individuals
US, EU, UK and oda kontris don saction more than 1,000 Russian individuals and businesses.
Dem include wealthy business leaders - the so-called oligarchs – wey dem reason dey close to di Kremlin, including former Chelsea FC owner Roman Abramovich.
Di sanctions dey affect Russia?

Wia dis foto come from, Getty Images
Russia economy dey expected to fall by 10% for 2022 and fall into deep recession.
But supermarkets shelves for Moscow still full although some items swey dem dey import no dey available.












