Human rights commission clear Nigeria army of forced abortions, mass killing of children for northeast

Wia dis foto come from, Reuters
Di National Human Rights Commission (NHRC) don clear di Nigeria military of allegations of forced abortions on women and mass killing of children for dia counter-insurgency operations for di northeast region of di kontri.
Na one special independent investigative panel wey di NHRC bin set up to chook eye into di allegation wey Reuters bin publish against di Nigeria military for 2022, tok dis one on Friday, 8 November.
Di Reuters report bin allege say di Nigerian military bin force women and girls to do more dan 10,000 abortions since at least 2013.
Di army bin also kill plenty children of suspected Boko Haram members sake of say dem get terrorist blood, di Reuters report bin allege, as dem tok say dem interview more dan 60 pipo including soldiers and victims.
Di seven-man investigative panel wey get members from di judiciary, humanitarian community, health sector and civil society dey headed by Abdu Aboki, a retired Justice of di Supreme Court of Nigeria. E take dem 18 months and 12 weeks of sitting bifor dem finally reach dia final verdict.
"Di panel no find any evidence say Nigerian soldiers bin conduct forced illegal abortions on women and girls for di northeast," Hilary Ogbonna, di General Council of di panel of investigation, tok as e dey read out summary of di report.
"Di structure and operational protocols of di Nigeria military make am difficult for dem to conduct illegal and forced abortions."
On di contrary, Ogbonna say "di panel bin probably based on witness testimony say di NGO Medecin Sans Frontiers (MSF) bin dey engaged in abortions procedures for some years for di northeast thru di medical facilities wey dem dey operate".
End of Di one wey oda users dey read well well
Also, "di panel no find di Nigeria military culpable of di massacre of children for Kukawa, Gasarwa, Alagarno and for many parts of New Marte, but di panel find di military culpable of infanticide and di killing of community members for di village of Abisare for Marte local goment area of Borno State for 16 June, 2016".
During dia investigation, di special panel say dem speak to 199 witnesses wey include 66 military personnel and 23 goment officials. 154 of di witnesses na male and 45 na women.
Di panel also tok say dem no happy as Reuters wey bin publish di allegations no cooperate wit dem during di investigation. "Di ICRC (International Committee of di Red Cross) and MSF also fail to cooperate wit di Panel," oga Ogbonna tok.
"Organisations wey dey hold pipo to account no suppose shy away wen pipo dey also hold dem accountable," e add.
Di Boko Haram insurgency don ravage Nigeria northeast region since 2010 wen di Islamist group begin dia violent attacks. More dan 35,000 pipo don die sake of di insecurity wey Boko Haram cause and millions don dey displaced.
Borno State na di worst affected and e continue to be di centre of di insurgency, but neighbouring states like Adamawa and Yobe also dey heavily impacted.














