Why Hisbah arrest 64 ‘underage’ pipo for Kano hotel

Wia dis foto come from, Getty Images
Islamic police for Kano state north west Nigeria say dem arrest 64 young boys and girl wey go one hotel, carry dem go sharia court.
Hisbah say dem arrest di “underaged” boys and girls on Monday 30 October, carry dem go court on Tuesday morning of 31 October.
Lawal Fagge, di public relations officer of di Kano Islamic police, Hisbah, tell BBC Pidgin say dem arrest di young pipo wey im say be “underaged” afta dem get call from di manager of di hotel and di area pipo.
E tok dis one afta one video begin trend for social media wey show wia some Hisbah officials bin dey push, grab, carry some men and women put dem inside one white pick up van.
Fagge say di young pipo gada for di hotel premises dey smoke shisha, drink hard drug and make noise disturb pipo for di hotel and pipo wey dey live for di area.
E add say some of dem bin dey do sexual act wen dem arrest dem.
Di underaged pipo according to di Hisbah official bin no suppose comot from dia house without dia parents permission, as dis dey unislamic.
“Based on di Islamic religion, e no dey permitted for young pipo to meet up like dat, without di consent of dia parents or any guides.”
End of Di one wey oda users dey read well well
One aspect of di video wey worry na how di Islamic police bin dey torch torch di girls as dem dey carry dem by force enta motor.
According to Islam, e no dey allowed for man wey no get any connection wit woman to touch her in any way.
Wen BBC ask Fagge about dis unislamic behaviour of some of dia officers, im say, although im neva see dis video, for dis kain situation, di tin to do na to check which offence get weight pass – man wey dey torch woman wey im no suppose or woman wey dey smoke shisha, drink hard drug.
“You have to weigh di gravity of wetin dey happun. Na wetin di guys do? Abi na wetin di boys and girls wey mix up togeda do? Im tok.
Hisbah get both men and women officers and di normal tin say men officers go arrest men while di women staff go handle women arrest, but no be so e show for di video.

Wia dis foto come from, Nasihunmalam/Tiktok
E don tey wey Hisbah don dey over do
Hisbah work na to make sure say di pipo of Kano wey dey live under Sharia Law, dey abide by wetin di law tok.
Some of di recent examples of di kain tins wey di group don do, wey dem claim say dem do in di name of Sharia Law include:
For 2021, Hisbah bin harass boutique owners for Kano say make dem no use mannequins wey no get head display dia market because e dey against Islamic law. Tori be say dem even arrest some.
Dis mata make Nigerians para unto say some of dis traders no be Muslims and Sharia Law and dem no get any business wit sharia.
Commander General for Kano Hisbah Sheik Harun Ibn Sina later tell BBC say “Nothing like arrest don happun, we just dey go round dey advise dem on wetin Islam accept on dat issue.”
“Islam forbid use of mannequin wey get head but if head no dey we no get problem wit dat one.”
For December 2021, kasala burst afta 18-year-old Shatu Garko win di number 44 Miss Nigeria beauty pageant.
Hisbah react by inviting her papa and mama to come explain why dem allow dia daughter participate, as par dem come from Kano state.
Hisbah commander Sheik Harun Ibn Sina tell BBC Pidgin say wetin Garko do dey illegal for Islam.
"We go invite di parents to tok to dem about di actions of dia daughter and di fact dat wetin she do dey illegal for Islam in case dem no know so dat she no go continue dat path and also stop oda girls copying her," im tok.
For January 2023 one Hisbah official make one woman to allegedly divorce her husband, marry pesin wey bin wan marry her daughter.
Family of di woman say na Hisbah oga for Rano local goment marry off dia daughter without dia consent.
Sheik Abdullahi Garangamawa, top Islamic preacher for Kano, tok say Hisbah no get right as par say for Islam, parental or guardian consent na di koko for any marriage.













