Ghana suffer heavy defeat for International Friendly against Japan

Wia dis foto come from, Getty Images
Black Stars suffer dia first defeat under leadership of de new coach Otto Addo who take over from Milovan Rajevac.
De Black Stars play two draws against Nigeria in de World Cup Qualifiers to book dia place in de tournament.
Ghana secure dia first victory under new management by defeating Madagascar by 3 goals to nil.
De next game against Central African Republic however end in draw for de Ghanaian senior National side.
Black Stars lose dia exciting form ahead of de Japan international friendly after most of de top players miss de match over injury, health issues den different personal reasons.
Ghana hope say de game against Japan go help dem prepare well ahead of de 2022 FIFA World Cup where dem go face country like South Korea who dey play like Japan.
First half update
29 mins: Yamane score for Japan to give dem lead against Ghana
39 mins: Jordan Ayew (Ghana) commits foul and Kurt Ams immediately signals free kick
End of Di one wey oda users dey read well well
40 mins: Hiroki Ito chop yellow card for foul
44 mins : Jordan blast hot shot past di goalkeeper to equalise for Ghana.
Japan 1-1 Ghana
45+1 mins: Kaoru Mitoma score anoda goal for Japan
Halftime Japan 2 - 1 Ghana
Second half update
46 mins: Japan win free kick inside Ghana area
55 mins: Japan miss chance at goal
55 mins: Japan miss chance at goal as Mitoma shot deflect
64 mins: Mohammed Kudus win free kick give Ghana in front of de 18 yard box
65: Jordan Ayew free kick miss de net by some few inches
66 mins: Goalkeeper Ati Zigi make crucial save deflecting corner kick by Japan
74 mins: Takefusa Kubo score third goal for Japan
80 mins: Jordan Ayew bin dey find one of his teammates wit a ball from free kick outside di box. De goalkeeper climb high above all de players in de box to intercept de cross and snuff out de opportunity.
83 mins : Daizen Maeda converts im effort and score di fouth goal for Japan
90+3 mins: Japan dey lead Ghana by 4 goals to 1
Full Time: Japan 4 - 1 Ghana
Ghana vs Japan head to head
Ghana on Friday face Japan in de semi-finals of de 2022 Kirin Cup for de Noevir Stadium.
Dis be de first time Ghana dey play in de competition, but de seventh time dem dey face Japan in all competitions.
In de last six games between de two nations, Ghana manage win two wey Japan win four games.
For de Black Stars dis be important friendly match which go prepare dem ahead of de 2022 Fifa World Cup.
Both teams test dema strength out den use dis game as preparations with international teams de World Cup which go start in November.
Dis be de 21st edition of de international friendly football tournament, with de last one taking place in 2016.
Japan line-up
1 Kawashima, 2 Yamane, 22 Yoshida, 3 Taniguchi, 26 Ito, 21 Doan, 6 Endo, 7 Shibasaki, 11 Kubo, 25 Ueda, 15 Mitoma,
Ghana line-up

Wia dis foto come from, Getty Images
12 Zigi, 2 Yiadom, 3 Seidu, 18 Amartey,5 Korsah-Akoumah, 11 Wakaso, 20 Kudus, 15 Antweer , 6 Addo, 9 Ayew, 10 Ayew














