Canadian-based Nigerian Amaka Sonnberger chop arrest, charged wit issuing threat

Wia dis foto come from, Abike Dabiri-Erewa/X
Police for Toronto Canada don arrest one woman wey allegedly threaten some members of di Nigerian community for social media.
Police say dem get call wey involve threatening incident on 28 August.
Di woman wey her name na Amaka Sonnberger allegedly post online content dey wit death threats. Sometin wey Nigerian goment quickly react to.
Police arrest di 46-year-old woman on Sunday and say dem go charge her wit uttering threats.
Amaka go appear for Toronto court on Monday.
According to police, di suspect post one online content at about August 25, 2024 wia she dey sama threats to her fellow country pipo.
Police say dem dey threat di case as suspected hate motivated offence.
Criminal code of Canada section 264.1 prohibit utterance of threats to cause death or bodily harm.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di tori been comot last week wen di video begin trend for social media.
Di video get woman voice wey dey issue threat to pipo from di Yoruba and Benin tribes of Nigeria say she go kpai dem.
Some part of di video also show wia di woman dey threaten to poison di food of pipo from dat tribe.
Nigeria goment react to di incident last Thursday.
Di Chairman Nigerians in Diaspora Commission (NiDCOM) Abike Dabiri-Erewa write letter to di Mayor of Brampton, Canada wia Amaka dey live to draw di ear of goment for Canada to di mata.
For di letter, Miss Abike say Amaka na disability support worker for Brampton, Canada.
She request authorities for Canada to investigate di matter as di suspect fit pose a danger to vulnerable pipo for wia she dey work.
Nigeria House of Representatives also chook mouth for di matter. Dem demand for di immediate prosecution of Amaka under criminal code of Canada.
For letter wey di Chairman House of Reps Committee on Diaspora Matters Tochukwu Chinedu Okere sign, di house request di goment of Canada to issue public condemnation to di action of Amaka to show say di country no dey support hate speech.
Members of di Yoruba Council Worldwide also write letter to di Inspector General of Police for Nigeria say make him arrest di suspect.













