Nigeria no dey friendly wit Ghana as dem sama Black Stars koboko for Morocco

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria sama Ghana 2-1 for Marrakesh, Morocco, on Friday 22 March wen di West African brothers jam for international friendly.
Na Cyriel Dessers score di first goal of di match, while Ademola Lookman top am.
Jordan Ayew of Ghana score di third goal of di match wey record one red card. Na Jerome Opoku referee Jayed Jalal bin send comot for di early stage of di second half.
Di Super Eagles wey host nation Ivory Coast beat for di Afcon final for February bin show superiority ontop field against di Black Stars.
How di match take waka
Second Half
Nigeria 2-1 Ghana
Full-time
98 mins - We dey play over time afta dat late Ghana penalty.
Semenyo’s powerful drive from distance is well held by Nwabali.
End of Di one wey oda users dey read well well
GOAL! Nigeria 2-1 Ghana | Jordan Ayew 95'
95 mins - Jordan Ayew role di ball into di corner and send Nwabali di wrong way.
Abdul Fatawu pick di ball out of di net and sprint back to di halfway line.
Nigeria 2-0 Ghana
90+4 mins: Ghana get late penalty for Marrakesh afta Osayi-Samuel bring down Semenyo.
Ayew step up to take am.
90 mins - Full credit to Ghana, wey still neva give up.
Semenyo head off target from close range from di resulting corner and e hurt imsef sake of dis.
Di Bournemouth man don certainly get im chances for Marrakesh.
Dem don signal five minutes of added time as Ghana prepare anoda couple of late changes.
88 mins - Shey Ghana get anytin left now?
Ayew line up one shot on goal from anoda free-kick and Nwabali tip am behind.
GOAL! Nigeria 2-0 Ghana | Ademola Lookman 84'
84 mins: Nigeria don net anoda goal. Game, set and match!
79 mins: Ayew short free-kick get to Lamptey but Nwabali tip ova di player effort.
The 10 men are far from done here.
Ayew delivers the corner from the right but Nigeria manage to clear their lines.
78 mins: Tanimu of Nigeria don get injury but e look okay to continue for now.
Ghana with a decent free-kick chance after a foul on Ernest Nuamah.
76 mins - One huge chance for di 10 men of Ghana to equalise inside di final 15 minutes for Marrakesh.
Semenyo dey somehow unable to head home Ayew cross from close range.
75 mins: A shout of frustration from Onyemaechi afta dem block im shot.
72 mins: Brave goalkeeping from Nwabali as im cop one painful blow to di head as e wan scata Ayew effort.
Unai Simon and Raphael Onyedika have both been introduced by Nigeria boss Finidi George.
70 mins - Iwobi dey find goal for Nigeria but Lamptey tackle am.
E look like foul, but di referee no shake ignore am.
65 mins - Substitution, Ghana. Kasim Adams don replace Amankwah Forson.
61 mins - Dessers steer one inviting low Onyemaechi cross just wide for Nigeria afta good build-up play wey involve Iwobi.
Hoffenheim’s Kasim Adams is on for Ghana now after the sending off.
Forson Amankwah has been withdrawn.
59 mins - Ghana players and coach Otto Addo dey sad.
Dem now try to recova wit 10 men afta bright start to dis second half sake of di introduction of Lamptey.
They have a mountain to climb now...
57 mins - Confusion reign for Marrakesh as referee Jayed Jalal give Ghana defender Jerome Opoku red card.
55 mins - Lamptey float one cross from di right and Ayew head am on target and Nwabali push am.
53 mins - Iheanacho drive through di middle and past Edmund Addo bifor im send low shot not too far wide of di back post.
Dis na decent tempo to dis second half at di moment.
50 mins - Much better for di opening exchanges of dis second half so far from Ghana, wey dey more determined.
They are moving the ball quicker and asking questions of the Nigeria defence, with much of the spark coming from the introduction of Lamptey down the right flank.
46 mins - Substitution. Tariq Lamptey of Ghana don replace Patrick Kpozo.
First Half
45+3 mins - First half don finish.
Ayew with the chance to deliver another free-kick into the box from the right, but Nigeria get it clear after a spot of pinball and the half-time whistle sounds.
Nigeria 1-0 Ghana
45 mins - Dem don add three minutes of added time as Nigeria come forward again down di right flank, but di cross lack quality.
Ghana then break at pace and end up with another corner.
43 mins - Ghana best chance of di game so far na from Semenyo wey race through
41 mins - Di Super Eagles dey try double dia lead bifor di break for Marrakesh.
GOAL! Nigeria 1-0 Ghana | Cyriel Dessers 38'
37 mins - Cyriel Dessers of Nigeria score di first goal wit penalty as Ghana protest furiously against di referee decision.
34 mins - Nigeria dey up di work rate now, pressing Ghana hard high up di pitch and trying to force more errors in possession.
Nigeria get penalty!
Nigeria 0-0 Ghana
30 mins - Na huge chance for Nigeria on di half-hour mark as Iheanacho clever floated free-kick to di front post almost go beyond Ati-Zigi, wey claim am.
E suppose be 1-0 for di Super Eagles.
27 mins: Both teams dey battle for possession for midfield.
Nigeria still on top, but struggling to create further chances.
23 mins - Di likes of Iwobi and Onyeka dey try to drive Nigeria forward, wit a low shot inside di box wey dey blocked bifor Ghana try to break quickly.
20 mins - Ghana dey inch forward with free-kicks, though dem comot Ayew deep delivery from wide on di right.
The Black Stars quickly come again, but a woeful cross is easily gathered by Stanley Nwabali in the Nigeria goal.
17 mins - Ghana are dey cut apart and Iheanacho unleash one powerful half-volley Ati-Zigi tip ova.
Di Super Eagles scream for penalty for handball inside di box, but di referee wave am away.
14 mins - You fit hear evri shout from di players and coaches from di stadium for Marrakech.
Ati-Zigi with another low save bifor Semenyo goes down injured for Ghana.
He’s quickly back on his feet, however.
Nigeria 0-0 Ghana
12 mins- Ghana dey rush. E dey understandable sake of di experimental nature of dia side and number of players wey dey eager to impress.
Nigeria break forward with menace again, but Ati-Zigi smothers a loose ball.
10 mins - Chance for Nigeria!
Kelechi Iheanacho create di space for one decent curling strike wey Ati-Zigi beat away.
The Super Eagles have a couple of corners in quick succession, but nothing comes of them and they end up giving away a free-kick.
8 mins - No real ginger from both teams for dis early stage of di match.
A long ball sent forward by Ghana’s Baba Iddrisu intended for the run of Antoine Semenyo is shielded behind for a goal kick.
A fast ball into the box for Jordan Ayew also ends up going behind.
5 mins - Both sides dey give possession away including for dangerous defensive areas.
No further chances to speak of as yet.
3 mins - Nigeria dey mount early pressure on Ghana. Lawrence Ati-Zigi don save one ball for di Black Stars.
1 min - Match don start! Na Ghana kick off to start di match. Nigeria wear white while Ghana wear red.
Nigeria go jam Ghana for international friendly match on Friday 22 March.
Dis na di first time wey di two kontris go play afta di African Cup of Nations wey Ivory Coast host and win.
Super Eagles lose di final to di host Ivory Coast, while di Black Stars comot for di group stage.
Na afta di Black Stars comot dem sack dia manager Chris Hughton and replace am wit Otto Addo on interim basis.
Finidi George go oversee mata for Nigeria afta Jose Peseiro resign.
Dis na evritin you need to know about di international friendly game.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen be Nigeria vs Ghana friendly match?
Kick off time for Nigeria vs Ghana na 5:00pm West African time on Friday 22 March.
Di venue of di match na di Grand de Stade Marrakech, for Morocco.
Nigeria vs Ghana team news
Nigeria get some injury problems, di likes of Victor Osimhen, Taiwo Awoniyi, Tyronne Ebuehi and Gabriel Osho go miss dis game.
Ghana also dey witout one key player, Arsenal midfielder Thomas Partey.
Partey no dey available as im dey try to build up im fitness wit di Gunners.
Nigeria team news
Goalkeepers: Stanley Nwabali, Francis Uzoho, Ojo Olorunleke
Defenders: Chidozie Awaziem, Bright Osayi-Samuel, Bruno Onyemaechi, Kenneth Omeruo, Oluwasemilogo Ajayi, Calvin Bassey, Jamilu Collins, Benjamin Tianimu
Midfielders: Wilfred Ndidi, Raphael Onyedika, Alhassan Yusuf, Frank Onyeka, Alex Iwobi
Forwards: Nathan Tella, Kelechi Iheanacho, Sadiq Umar, Moses Simon, Ademola Lookman, Fisayo Dele-Bashiru, Cyriel Dessers
Ghana team news
Goalkeepers:Lawrence Ati-Zigi, Joseph Wollacott, Frederick Asare, David Akologo
Defenders: Alidi Seidu, Tariq Lamptey, Gideon Mensah, Patrick Kpozo, Denis Odoi, Daniel Amartey, Alexander Djiku, Nathaniel Adiei, Mohammed Salisu,
Midfielders: Elisha Owusu, Mohammed Diomande, Samed Abdul Salis, Andre Ayew, Mohammed Kudus, Baba Iddrisu, Edmund Addo,
Wingers: Ernest Nuamah, Osman Bukari, Fatawu Issahaku, Ibrahim Osman
Forwards: Jordan Ayew, Antoine Semenyo
Line-ups
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Finidi George profile
Former Nigeria forward Finidi George go dey Super Eagles dugout wen dem face dia arch-rivals Ghana.
Finidi wey be 52-years na former Ajax Amsterdam and Real Betis player.
Im bin play im first match for Nigeria wia e score, for dia Africa Cup of Nations qualifying game against Burkina Faso for National Stadium, Lagos on 27 July 1991.
Na key player for Nigeria 1994 World Cup squad wey include di likes of Rashidi Yekini.
George wey come from Rivers State, also play for Calabar Rovers and Sharks FC for local league bifor im move go Europe.
Afta Jose Peseiro resign, Nigeria football federation announce say im go take charge for di friendly games against Ghana and Mali.
Nigeria vs Ghana head to head record

Wia dis foto come from, Getty Images
Di last time wey dis two sides jam each for competitive match na for di 2022 World Cup qualifiers for Qatar.
Ghana win di tie 1-1 on di away goals rule to qualify.
Dem play 1-1 draw for Abuja for di Moshood Abiola stadium.
Ghana get upper hand for dia head to head record against Nigeria.
Di Black Stars get 22 wins while Super Eagles get 11 wins and 20 draws.
See oda match result between Ghana and Nigeria
2011/10/11: Ghana 0-0 Nigeria - International Friendly
2010/01/28: Ghana 1-0 Nigeria - Caf Africa Cup of Nations
2008/02/03: Ghana 2-1 Nigeria - Caf Africa Cup of Nations
2007/02/06: Ghana 4-1 Nigeria - International Club Friendly
2006/01/23: Nigeria 1-0 Ghana - Caf Africa Cup of Nations














