Where Chief of Army Staff dey? Defence Headquarters warn against call for military takeover

Wia dis foto come from, Nigerian Army
Di Defence Headquarters (DHQ) don announce say dem no make any appointment for acting Chief of Army Staff (COAS) for inside di Armed Forces of Nigeria.
Dem tok dis one inside one statement wey di Acting Director of Defence Information, Brig-Gen Tukur Gusau release for Abuja on Monday.
Gusau say dat kain appointment no dey inside di Armed Forces of Nigeria (AFN).
E add say, di Chief of Defence Staff, Gen Christopher Musa bin follow di COAS tok just few minutes bifor dem release dis statement.
Di reaction of di DHQ come sake of rumours say di COAS die of cancer – something wey di Nigerian Army tag as “fakenews”.
Di Chief of Army Staff, Lt-Gen Taoreed Lagbaja neva appear for any public function for sometime now.
Di Defence Headquarters for di statement also condemn di call for military coup, say na treasonable offence under di law.
Dis na afta one video go viral online wia some pipo bin dey ask for military takeover.
Di statement tok say, "di Defence Headquarters (DHQ) wan clarify say dem no announce any senior officer announcement to turn Chief of Army Staff (COAS) wey some media outlets dey claim di appointment. For di record, dat kain appointment no dey for di Armed Forces of Nigeria (AFN)".
Dem further explain how di military dey run even as di COAS don go on leave so say, "di AFN dey professionally manage and all di Service Chiefs dey perform dia duties, di way dem tok am for di Constitution of di FGN. Major General Abdulsalam Bagudu Ibrahim wey be di Chief of Policy and Plans dey regularly download di COAS as na standard for di military procedures."
Dem add say di COAS dey kampe and go soon return im normal duties wen im leave finish.
Dem add on di mata of pipo wey dey ginger for military takeover say, "di AFN tanda gidigba for di preservation and advancement of our democracy and dey lyal to di President Bola Ahmed Tinubu administration. Di relative peace wey we dey enjoy today na bicos of di President support of di military and di dedication of di AFN leadership."
Di statement conclude say, "to dis end, di AFN and relevant security agencies don collect manate to take action wey dey necessary on any individual or group wey dey ginger for any changes for di kontri wey dey against di law."










