Like MemeFi like Hamster Kombat, wetin be dangers of dis cryptocurrency

Tap to earn games

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Afta di launch of Hamster Kombat cryptocurrency, plenti odas don join in tap to win gaming raze for inside di app wey dem dey call Telegram.

Memefi na anoda tap to win game but apart from dat e get oda games wey fit win you keys wey you fit exchange for rewards.

And apart from di money wey you go win for di tap to earn game, dem dey also promise say some of di pipo wey dey play for wetin dem call di Grand Draw fit win luxury car, money plus oda tins.

Dis fit be di reason why di new hype game for tap to earn gaming don grow in popularity. But pipo dey fit sabi overlook dis kain tin despite di plenty danger wey dey involved.

Wetin be Memefi

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Memefi no be only tap to earn game, according to dia website, dem describe demselves say dem be "a Web3 Social Tech game wey dey make gaming to dey more interesting by say dem introduce keys wey players fit trade to increase rewards".

E different from regular tap to earn becos e require playing di actual games for inside di app to take make money - wey no sure.

Dem tok say dem get ova 45 million users wey dey use di game.

Also, unlike Hamster Kombat wey launch dia coin afta di end of di phase one of dia game, Memefi announce di date of dia listing while di game still dey up.

But some pipo don dey call di whole project scam, even for di comments of dia social media.

Some pipo call out di fact say to dey part of di Grand Draw wey dem announce dey require some crypto money to dey part of am.

Even di gifts wey dem dey promise dia users, pipo dey sceptical say na members of di team go win di prize.

Dis na even as oda users say dem no want giveaway, say make dem use di money do airdrop.

Even di listing wey dem just announce for 30 Ocotber bin dey pushed from 9 October and na part of wetin dey make pipo fear say abi na scam.

But real dangers dey ground around dis tap to earn games mata.

Wetin be di dangers of tap to earn games

One Sabi tech pesin wey don dey di industry for 10 years plus, Ejike Okonkwo, bin follow BBC Pidgin tok for June dey warn pipo about di dangers of dis kain tap to earn crypto games.

E list di dangers as;

  • Nobodi know who get di platform
  • Na for only Telegram pesin fit access am
  • Pipo fit risk money later on
  • Wit di repost or share part of di game, you fit post sometin illegal wey go put you for trouble
  • Risk of malwares to get beta location based rewards

Wetin e use take resemble Hamster Kombat

Pesin dey tap Hamster Kombat

Less dan a month ago, di tap to earn crypto game wey everybodi bin dey hala about na Hamster Kombat.

And e get some similarities to dis game. One of which na di obvious say e be tap to win game.

Dem also get oda social media sites wey dem dey teach pipo all di tins to know about Cryptocurrency and wetin dey happun for di crypto worlds.

Apart from dat pipo dey fear di kain payout dem go get wen MemeFi finally release dia airdrop and weda e go be like Hamster own.

And di two both of dem establish di game for sometime bifor dem gree to list dia tokens for and CEXes.

But na dia di similarities seem to finish, becos tori up and down tok say dem dey charge dia users in Ton to take do Daily Check ins on di mini games among odas.

Anoda difference na di giveaways, wey di project di promot up and down.

Various users say dem no like am as one user put am, "Make una just launch for christ sake. We no want giveaways, we want airdrops."