Why pipo para on top Hamster Kombat payout afta listing drop

For months, some of di most trending video for YouTube na one cartoon Hamster wey dey give pipo advice on money and crypto matters.
If you no look well-well, you go tink say na for pikin but pipo don dey run di parole of tapping on di telegram featured game to get more crypto wey dem hope to turn to money.
Di way Hamster Kombat dey work na say you go tap for one game inside di Telegram app and e go increase di number of di crypto wey you get. Na wetin dem dey call tap to earn game feature.
Di game bin get pass just di tap to earn feature, e also promise additional points for playing mini games inside di main games, watch dia YouTube videos and share tins for your social media to get more points.
No be only Hamster Kombat bin get dis kin tap to earn game feature, odas na Notcoin, Tapswap, Poppo, etc.
But since di Hamster Kombat bin no dey listed wit an Crypto exchange service, pipo bin just dey see wetin dem dey earn witout access to am.
Dis na till Binance announce say dem don list di crypto on 21 September and e go bicome active on 26 September and pipo go fit withdraw am.
Many pipo howeva, wake up to realize say dia payout no match no match di wetin dem dey tink say dem go make sake of how long dem don put into di game.
End of Di one wey oda users dey read well well
Some pipo report for social media say dem no even see up to one dollar from all di tapping dem don dey do ova di past few months.
Pesin bin write say, "money no reach to do screen wey crack during tapping".
Odas bin tok say bicos di money dem get from di tap to earn game too small, dem no fit withdraw am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
One Sabi tech pesin wey don dey di industry for 10 years plus, Ejike Okonkwo, bin follow BBC Pidgin tok for June dey warn pipo about di dangers of dis kain tap to earn crypto games.
E list di dangers as
- Nobodi know who get di plaatform
- Na for only Telegram pesin fit access am
- Pipo fit risk money later on
- Wit di repost or share part of di game, you fit post sometin illegal wey go put you for trouble
- Risk of malwares to get beta location based rewards
How Hamster Kombat take start
According to dia official YouTube page, Hamster Kombat bin start on 26 March, 2024 afta e see di success wey wetin dem call di "CEO simulator" of NotCoin bin dey bring.
Di Hamster Academy announce say no be just tap to earn dem bin put for dia nad di vision behind di creation na to help pipo to fit understand di Crypto currency world.
Dem announce say at di end of di Season 1 of di game dem get 300 million users of di game and about 40 million active daily users wey dey tap dey go.
But even for all dis time, di actual Crypto behind di game, $HMSTR bin neva dey registered for trading.