Newcastle beat Manchester United to occupy third spot for Premier League

Newcastle vs Manchester United live updates 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Newcastle United yeye Manchester United to dey ahead of Manchester United for di Premier League.

Di Magpies now occupy di third position on di PL table.

Though both teams get 50 points each, e don tey wey Newcastle reach 50 points for Premier League.

Na former Arsenal player Joe Willock open scoring for di host, while Callum Wilson score di second goals towards di end of di match to seal di win.

Manchester United struggle well-well for di game from di first half. Dia talisman, Marcus Rashford no see ball play.

Erik ten Hag make changes by removing im two centre half to strengthen im attack but im strategy no work.

Dis na di first time in 11 years Newcastle dey beat United.

Second Half

Newcastle vs Manchester United 2023

Wia dis foto come from, Getty Images

FULL TIME

90+1mins: 5mins of added time.

Newcastle 2-0 Manchester United

88mins: GOAL! Perfectly taken free kick! Kieran Trippier send a cross in and Callum Wilson convert am.

86mins: Anthony Gordon fail to send a pass into di box as dem cut out im effort.

84mins: Newcastle dey also do dia own SUBSTITUTION. Elliot Anderson enta for Joe Willock.

84mins: SUBSTITUTION. Victor Lindelof enta for Raphael Varane, Facundo Pellistri enta for Lisandro Martinez while Fred replace Scott McTominay.

82mins: Anthony Martial misses a good chance to score. An inch-perfect cross into di box find Anthony Martial wey rise for a header, but send di ball well over di bar.

80mins: SUBSTITUTION. Alexander Isak comot for Callum Wilson to enta.

77mins: Joelinton try to convert a perfectly taken corner kick deep into di box. A wonderful effort by de Gea save Man United again.

76mins: What a save from Nick Pope! Raphael Varane jump high to meet a cross and make a promising header from close range, but di goalkeeper pull off a brilliant stop to keep am out.

73mins: Marcel Sabitzer expertly control di pass inside di penalty area and shoot, but defender block am.

70mins: Newcastle dey play possession football and controlling di game. Dem dey exchange inch-perfect passes from player to player.

68mins: SUBSTITUTION. Joelinton enta for Allan Saint-Maximin. Anthony Gordon replace Jacob Murphy.

Newcastle 1-0 Manchester United

66mins: GOAL! Joe Willock break di jinx courtesy of pass by Allan Saint-Maximin.

65mins: Allan Saint-Maximin fail to find any of im teammates inside di box.

62mins: SUBSTITUTION. Jadon Sancho enta for Antony. Anthony Martial replace Wout Weghorst.

60mins: Allan Saint-Maximin run a pass through di eye of a needle into di box for Alexander Isak.

57mins: Marcus Rashford shoot perfect shot afta pass from Luke Shaw.

55mins: Kieran Trippier put a cross into di box but e fail to achieve wetin e want.

52mins: Bruno Guimaraes and Allan Saint-Maximin dey try to to find each oda wit some accurate passes ever since di match start.

51mins: A perfect long pass by Diogo Dalot find Marcel Sabitzer. E hit di pass and continue im attacking run.

47mins: Diogo Dalot do well to dispossess di attacker wit a slide tackle, but di referee blow im whistle for a foul. Newcastle get free kick

Newcastle 0-0 Manchester United

46mins: Second Half don start

First Half

Joelinton

Wia dis foto come from, Getty Images

Newcastle 0-0 Manchester United

45mins: HALF TIME

44mins: Alexander Isak collect a pass inside di box and unleash a shot wey defender block.

43mins: Antony receive a fine cross inside di box and attempt to score a goal, but e fire blank.

41mins: MISSED CHANCE! Joe Willock fire just over di crossbar from inside di box afta running onto a splendid pass from Allan Saint-Maximin

40mins: Diogo Dalot clip an inviting cross into di box, but nobody dey dia.

39mins: Fine attempt! Sean Longstaff collect pass and manage to hold off di defender, den rifle am but di shot go wide.

37mins: Marcus Rashford find some space and receive a very precise long pass from Marcel Sabitzer

35mins: Isak for don score! Allan Saint-Maximin gather short pass deep inside di box but e take long to release am for Isak.

34mins: Bruno Fernandes show incredible technical ability by sending di ball into free space and Diogo Dalot no shoot di ball well.

32mins: Bruno Guimaraes send accurate pass to Kieran Trippier, wey control di ball wit a fine first touch.

31mins: Unlucky Newcastle! Joe Willock beautifully control a pass and from di edge of di box drill a shot in on goal, but dem block am

28mins: Antony pass di ball and slow down di tempo

26mins: Marcus Rashford almost get into in a promising position, but di through ball by Diogo Dalot from just inside di box no dey enof.

25mins: Jacob Murphy hold on to a lofted pass on di edge of di penalty box and unleash a volley towards goal.

24mins: Kieran Trippier whip di ball in from long-range free kick, but United man clear am.

23mins: Marcus Rashford find Luke Shaw wit a nice pass so e fit go towards di goal.

22mins: Stuart Attwell blow for a foul afta Dan Burn aggression

20mins: Allan Saint-Maximin produce brutal strike from di edge of di box.

16mins: Joe Willock waste goal scoring opportunity. E pick up di rebound and produce a poor wey Man U goalkeeper save.

15mins: Lisandro Martinez and Bruno Fernandes don try locate dem sef to create accurate passes. Di combination dey make sense.

12mins: Golden chance! Wout Weghorst miss scoring opportunity.

10mins: Poor challenge! Ref caution Lisandro Martinez for tripping

9mins: One Newcastle player commit holding foul and referee blow for foul.

7mins: Kieran Trippier receive a sweet pass inside di box, but dem block im effort on goal.

4mins: Bruno Fernandes release Marcus Rashford, wey try to beat 3 defenders.

2mins: Corner kick for Newcastle.

Newcastle 0-0 Manchester United

1min: KICK OFF

Newcastle vs Manchester United line ups

Newscastle United: Pope, Trippier, Schär, Botman, Burn, S Longstaff, Bruno Guimarães, Willock, Murphy.

Manchester United: de Gea, Dalot, Varane, Li Martínez, Shaw, Sabitzer, McTominay, Antony, Bruno Fernandes, Rashford, Weghorst

Callum Wilson and Allan Saint-Maximin don dey clear to play but Miguel Almiron still dey out sake of im thigh issue.

Manchester United boss Erik ten Hag dey hopeful Marcus Rashford, wey comot di England squad sake of minor injury go dey avalaible.

Anthony Martial dey back for contention afta im heal for hip roblem but e neva clear weda Marcel Sabitzer and Raphael Varane dey fully fit.

As for Christian Eriksen, Alejandro Garnacho and Tom Heaton - dem no go play.

Match facts

Head to Head

  • Manchester United don drop points for four of di last six times dem go St James Park for Premier League.
  • Di Magpies win di October 2019 match for St James Park but na dia only win for di last nine top flight meeting.
  • Di Red Devils don win 14 Premier League matches away for Newcastle, wey pass any oda side.

Newcastle United

  • If dem win, dis go be di first time Magpies don get 50 Premier League Points since di 2011-12 season wen dem enta fifth place wit 50 points.
  • Only Manchester City and Liverpool don win league matches away for Newcastle since Eddie Howe become manager for November 2021.
  • Howe don win two of im 13 matches as manager against Manchester United for all competitions and dem bin dey for house.
  • Nick Pope don fail to keep clean sheet for im last seven Newcastle appearances for all competitions.
  • Alexander Isak wey get six goals for 10 league appearances for Newcastle fit become di third Swede wey go socre for at least three back to back Premier League matches like Freddie Ljungberg and Zlatan Ibrahimovic.

Manchester United

  • Dis fit be di 16th Premier League win for di season wey go match di total matches dem wi last season.
  • Di Reds don chop 27 top flight away goals dis term. Na only Bournemouth, Nottingham Forest and Leicester get worst records.
  • Last month 7-0 beating wey dem collect for Liverpool hand na dia only defeat for 16 league and cup games.
  • Dem dey in danger say dem neva score for three back to back games for di first time since February 2020.
  • Bruno Fernandes na one goal away from 100 career league goals. Na just once im don score for di last 10 Premier League games wey im don play.

Dey refresh dis page for live updates of dis match