South Africa election give ruling ANC big blow with results

Wia dis foto come from, Reuters
Di official election results from South Africa dey set to be announced on Sunday evening, one electoral official tok.
Vote tallying don dey enta di final stages, with results wey don already come in from 98% of di districts.
Mawethu Mosery, di electoral commission deputy CEO, tell eNCA TV say di election joinbody go sit throughout di night on Saturday to deal with objections and appeals.
Di governing African National Congress (ANC) dey set to lose dia three decades of political dominance afta dem record massive drop in support.
Two days afta vote counting, Electoral Commission of South Africa (IEC) don gada 98% of votes wit ANC on di lead wit 40% of di vote.
Di vote of South Africa governing African National Congress (ANC) don collapse from 42% to 40%, since yesterday evening.
Di result dey unfavourable for di party, wey lead to Nelson Mandela resounding victory for 1994, afta di end of apartheid racial system.
Di party don lose majority of im parliamentary seat for di first time, but di loss dey shocking to President Cyril Ramaphosa and im party.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di party go forcefully enta into coalition wit oda party, ushering new era for South African politics.
The Democratic Alliance remain di second-largest party with 22%
The new party, MK, led by ex-President Jacob Zuma, na di third party with 15%
Dis na di latest results
Di current result of di elections wey hold on 29 May
Wit ballots counted from 98% of voting districts, dis na di result of di top five parties currently:
ANC - 40%
DA - 22%
MK - 15%
EFF - 9%
IFP - 4%
Di figures from di electoral commission don change since di last update, wen dem display results from 75% of the voting districts.
Since den, ANC don fall from 42% to 40%, di MK Party don rise up to 15% while EFF remains at 9% of di vote share.
Di ANC don always poll above 50% since di kontri first democratic elections for 1994, wey make Nelson Mandela president.
Support for di ANC don dey drop significantly sake of anger ova high levels of corruption, unemployment and crime.
One woman wey bin vote for di ANC for evri election for 30 years bin switch to DA dis time, and tok say she bin want dem out of power altogether.

Wia dis foto come from, Getty Images/BBC
"Dis result no good. I bin want dem out of goment. We need to give someone else a chance," she tell BBC.
Now, di ANC dey hustle to hold onto power by forming a coalition wit one or more parties.
ANC chairperson, Gwede Mantashe tok say im party dey unlikely to form an alliance wit di centre-right DA, wey currently dey for second place wit 22%.
E tok say "policy alignment" need to dey between parties wey wan form coalition.
For di ANC, dia black empowerment policies - aimed at giving black pipo a stake in di economy afta dia exclusion during di racist apartheid era - "no dey negotiable".
South Africans no dey vote directly for president. Instead, dem dey vote for members of parliament wey go now elect di president.
A record 70 parties and 11 independents bin run for election, as South Africans vote for new parliament and nine provincial legislatures.
Di DA bin sign a pact wit 10 of dem, and agree to form a coalition goment if dem get enough votes to dislodge di ANC from power.
But dis no include di EFF or MK, so e dey unlikely to happun.
As di parties scramble to form alliances, Kenya former President Uhuru Kenyatta, wey dey lead di African Union election observer mission for South Africa, offer some advice for forming coalitions.
E tok say coalition goments need to focus on areas of agreement instead of differences.
"I fit only wish dem well and hope say di leadership go take dis decision by di pipo in a positive frame," e tok.

Wia dis foto come from, AFP
Patient, peaceful but some concerns - observers
Election observers from both di African Union (AU) and di Southern African Development Community (Sadc) say dem see political party tents wey pipo camp inside for front of voting stations, wey dem tok say fit get "intimidated voters”.
Both di AU and Sadc missions don raise concerns say failures and delays wey voter management technology cause during di polls fit don interfere wit di integrity of di election, including disenfranchising voters for some polling stations.
Despite dis challenges, di AU observer mission head Uhuru Kenyatta express optimism about di overall process, e tok say South Africans "bin dey very patient, dem bin dey very understanding, and by extension, very peaceful".
Election observers dey encourage all complainants to formally log dia grievances.

Wia dis foto come from, Getty Images














