How PSG & Inter Milan reach Champions League final

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Sean Kearns
- Role, BBC Sport
- Read am in 5 mins
Wen Paris St-Germain and Inter Milan step out for Allianz Arena for Munich on 31 May, e go be di first Champions League final in 21 years wey no go involve Premier League, Bundesliga or La Liga club.
Since Jose Mourinho Porto beat Monaco for 2004 showpiece, at least one English, German or Spanish club don feature for di Champions League final.
Di past 14 winners of di competition don come from one of these three nations, sake of dis record, many supporters most times dey dismiss di quality of oda leagues.
PSG manager Luis Enrique bin address dat mata afta im side win against Arsenal on Wednesday, e say: "Di league of farmers, no? We be di league of farmers!'"
Football fans dey dat word - typically from England - to dismiss domestic leagues wia dey feel say di quality of football no strong reach di Premier League.
PSG and Inter go argue say dat no be di case, both of dem against strong opposition still reach di final.
Wetin dis tell us about dem and di strength of di Premier League?
Dumping di 'Galacticos'

Wia dis foto come from, Getty Images
Only Luis Enrique know if true-true im believe im own words wen im bin say PSG go better without Kylian Mbappe.
Di France captain, di club record scorer, bin just let di public know about im decision to leave for May 2024 wen Luis Enrique say im team go dey better - both in attack and defence.
"PSG go continue to be a great team and we go even get better. We go bring in players wit a strong mentality and players wey go identify wit di club – that na how life dey work," Luis Enrique tok.
Fast-forward 12 months and few pipo go argue against Luis Enrique prediction afta im side win Ligue 1 wit six games to spare and without losing a game.
Di ease wey dem take win dia domestic title - and di shortage of tough opposition – many fit see am as negative tin to build on for success for Europe.
Marseille, for 1993, still remain di only team for France to win di Champions League.
Afta dem finish runners-up for 2020 Champions League, PSG bin reach di semi-finals twice and quarter-finals twice for di following four years.
Wen PSG bin appoint Luis Enrique for 2023, di club bin accept say sometin need to change for dem to win.
Dat summer, forward Lionel Messi leave to join Inter Miami and dem sell Neymar to Saudi Arabian club Al-Hilal.
E mark di start of di end of di 'Galactico' era, wit Mbappe departure 12 months later closing dat chapter.
For dia absence, Luis Enrique build an all-action, high-pressing side wey dey, based on di collective rather dan di individual.
For Europe dis season, PSG bin start poorly and dem finish di group stage for 15th place.
But, wit dia January signing Khvicha Kvaratskhelia ginger, PSG don beat four English clubs - Manchester City, Liverpool, Aston Villa and Arsenal – for di knockout stages.
Experience count for Inter

Wia dis foto come from, Getty Images
Inter semi-final victory against Barcelona go, go down as one of di greatest two-legged contests for Champions League history.
Barcelona, wit 17-year-old Lamine Yamal, lose to di experience and know-how of Simone Inzaghi Inter.
Inzaghi name 10 players wey dey ova di age of 25 for Tuesday starting line-up, while Barcelona bin get six.
Francesco Acerbi, 37, become di second-oldest scorer for Champions League knockout history wen im score a 93rd-minute equaliser to take di tie to extra time for San Siro.
Yan Sommer, 36, bin join Inter for £5m afta Andre Onana £44m move to Manchester United for 2023.
Di Swiss goalkeeper bin make a number of vital stops to keep Inter for di tie bifor Acerbi dramatic goal.
Midfielders Henrikh Mkhitaryan and Hakan Calhanoglu combine age na 67.
Like PSG, Inter bin face dismissive comments from fans wey bin mock di quality of Serie A.
But Inzaghi side knock out Bayern Munich for Champions League quarter-finals and dem finish fourth for di group stage table, losing only one of dia eight matches.
Dem don win Serie A for two of di past four seasons, Inter don win di European Cup three times, most recently for 2010 under Mourinho.
Champions League struggles but Europa League success
Arsenal na di only English side to reach di last four of di Champions League, but di Europa League final fit dey between two familiar enemies from Premier League.
United and Tottenham hold aggregate leads going into dia semi-final second legs of di Europa League on Thursday.
If dem reach di final for Bilbao on 21 May, dem go meet for a fourth time dis season.
Tottenham, wey be two-time winners of di Uefa Cup, dey look to win di Europa League for di first time since 1984, while United last win am for 2017 and finish runners-up four years later.
Tok plenty about dis two Premier League sides wey dey di bottom half of di table for most of dis season and now fit meet for Europa League final.
If Tottenham, wey dey 16th for Premier League, or United, wey dey 15th, win di Europa League, dem go be di lowest-placed winners for di competition history.
For di Conference League, Swedish side Djurgarden must overturn a 4-1 semi-final first-leg deficit for Stamford Bridge on Thursday.
Chelsea, wey be two-time winners of di Champions League, na favourites to win di Conference League.
If dem do am, dem go become di first club to win di Champions League, Europa League and Conference League.







