Black Friday: Wetin e be and e dey really give di best shopping deals?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Fernando Duarte
- Role, BBC World Service
- Read am in 5 mins
Millions of pipo round di world sabi say Black Friday go soon land on 29 November, weda dem wan spend money or not.
Shop windows and email inboxes don full wit "Buy now!" "No miss out!" and "Deals end soon!" messages.
Di period wia shops dey drop dia prices for small time to ginger shoppers to spend money don go from US tradition to worldwide event.
But how Black Friday don turn one of di busiest shopping dates for di year and why no be always good news for consumers?
Wen Black Friday dey happun and how e take start?

Wia dis foto come from, Getty Images
Black Friday dey happun for di fourth week for November wey be di day afta Thanksgiving, wey be United State holiday.
Wia di term come from no get anytin to do wit shopping: di first reference of a Black Friday na for di 1869 financial crisis wey start sake of falling gold prices.
For di mid-20th Century, e mean di American workforce wey no dey go work bicos of di holiday.
Black Friday na also how di police for Philadelphia dey call di rish to do shopping go slow for di city.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di 1980s di term bin dey taken over by marketers into sometin positive.Di date wen dem start to make profit wey for accounting see dia finance to move from red to black.
E come turn to wetin dem dey use tok about huge discounts and crowd wey dey rush for deals for di US. More recently dem come up wit Cyber Monday wey be to promote online shopping on di Monday afta Black Friday.
Black Friday don spread to oda kontris around di world mostly bicos of di internet.
How big Black Friday be?

Wia dis foto come from, Getty Images
Research from American software company Salesforce estimate say global consumers bin spend $70.9bn just online during sales period for 2023 – 8% more dan for 2022.
For di UK, wia di first big Black Friday sale only start for 2010, e don grow pass di kontri original shopping events wey be di Boxing Day sales wey dey start around Christmas time.
Consumers dey expected to spend almost $9bn ova di period according to consultancy firm PwC.
For Africa, di online payment provider PayU report say di amount of transactions wey dem do in one dat for di 24 November, 2023 bin dey 83% higher dan di normal daily amount for Nigeria, South Africa and Kenya.
PayU also report say Argentina even for dia financial kasala bin record 104% increase for e-commerce transactions for dia Black Friday last year.
But Black Friday no be di only big shopping day for November for di world.
French customers dey prepare for dia Vendredi Fou (Crazy Friday).
China get dia own ogbonge shopping event wey dem dey call Singles Day. Singles Dat na shopping bonanza wey dey happun for few weeks but di date wey evritin dey lead up to na 11 November.
Mexicans get El Buen Fin de Semana wey mean di good weekend for Spanish dey around 20 November wey be national jollification holiday.
For di Middle East, dem dey call Black Friday, White Friday for religious reasons as Friday na holy day for Islam.
Black Friday really dey give di best deals?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di ansa no simple like dat.
For di UK, study by di consumer group, Which? for 2022 find out say na only one in seven deals for Black Friday dey give real discount and say most of di promotions na di same price or even cheaper sef ova di last six months.
But MoneySavingExpert wey be leading consumer website torchlight 50 popular search for products, mostly for technology for 2023 and find out say 35 of dem bin cheap pass for Black Friday dan bifor Christmas for 19 December.
For Brazil, some customers hala wn retailers give dem wetin dem call "Black Fraud" wey be wen dem raise prices days bifor Black Friday bifor dem offer dia discount.
Shoppers wey dey find discount dey advised to shine dia eye well-well.
Scams dey rise by a third around Black Friday according to analysis wey Lloyd Bank do wit most of di fraud from cloths side.
Di bank say di amount of scams rise by 29% around Black Friday and Cyber Monday for 2021 for di UK.
Tips for how to shop smart and avoid scams

Wia dis foto come from, Getty Images
Impulse buying dey choke during Black Friday. For UK, retail analyst dey jokingly call 3 December as "Returns Thursday", as more items dey returned dan any oda day for di year, according to di e-commerce trade bodi IMRG.
Consumer rights groups dey warn say flash sales dey make am hard make pipo control dia spending.
Brian Semple wey be tok-tok pesin for di London-based charity Money and Mental Health Policy Institute tell BBC say "e hard pass online wia e dey dey easy pass for retailers to apply pressure on consumers".
Di general advice na for pipo to tink am well bifor dem press mouse or open wallet.
But sabi pipo don recommend some basic steps:
- No panic rush to buy tins
- Find di deals yourself and compare di prices
- Avoid to buy from websites wey you know - if di price look to good to be true, e fit be so
- Find second opinion
- Check if retailers go match di price i.e. price am
- If you dey find reviews, find am for trusted websites so dem no go gba you
- Use card wey be say dem dey give extra protection, if tins no work well and make sure say all payments dey go from di platform wey you dey use.













