China, Mexico warn say trade war fit happun afta Trump increase tarrif on imported products

Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Di decision by US president-elect to increase money on top imported product don make some partner kontris begin para.

Di head of Mexico Senate quickly hit back, asking wetin Mexico go also impose on di US to make dem stop to dey consume drugs and stop illegal export weapons to dia southern neighbour.

China on dia saide don warn say nobodi go win for trade war afta President-elect Donald Trump announcement.

Trump bin announce say e go introduce 25% tariffs on goods wey dey enta di US from Canada and Mexico, and also increase existing tariffs from China by 10% as soon as e enta office for January.

For im Monday night post for Truth Social, e tok say di tariffs go dey ground until Mexico and Canada block di drugs and illegal migrants wey dey cross dia borders.

For China, di 10% extra tariff wey e wan sama dem dey lower dan di 60% wey im promise for campaign ground. E say dat one na till di Chinese goment close di fentanyl wey dem dey smuggle from di kontri.

Tariffs na type of tax and e don be di koko of Trump economic vision.

Infact, na wetin e bin dey promise bifor dem elect am but now more informate dey drop on wetin e dey plan gan-gan.

Fears don come say dis tariff threats fit violate di terms of di United States-Mexico-Canada Agreement - or USMCA wey e carry im own hand sign for 2020.

Reactions don dey flow in from di different regions wey be say don collect di threat of tariffs for all dia products.

Doug Ford wey be di premier of Ontario, wey be Canada most populous province tok say if America impose di tariff, e go dey "devastating to workers and jobs for both Canada and di US".

E tok for X say make Justin Trudeau call urgent meeting wit all premiers sake of say "We need Team Canada approach and response and we need am now."

Di head of Quebec wey be Canada second biggest province, François Legault tok say di tariff, "get ogbonge risk to di Quebec and Canadian authorities."

Di premier of British Columbia say di tariff go "hurt Canadians and Americans" and Alberta premier Danielle Smith tok say, federal goment must to resolve di mata wey dey give Trump stress about "illegal activities for our shared border" so e go fit avoid "any unnecessary tariffs for Canada exports go di US".

Meanwhile Canada Prime Minister, Justin Trudeau don follow Trump tok for phone, na wetin one Canadian goment official tell di BBC.

Trudeau confam say di call happun and dem use am tok abut di "intense and effective" connections wey di US and Canada get togeda.

E don alreadi arrange first ministers meeting "to tok about di United States" on Wednesday.

Justin Trudeau and Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

China say di threat on dia products by di US dey irresponsible.

China don warn Washington say nobody go win for di trade war.

Liu Pengyu wey be tok-tok pesin for Chinese embassy for Washington tok say, "China believe say di China-US economic and trade cooperation dey mutually beneficial in nature".

Some pipo dey worry say dis no go be di end and more tariffs go follow dis one for back.

Ontop di reason wey Trump give for di new tariffs, China foreign ministry tok-tok pesin, tok say, “China na one of di kontris wey get di strictest and most thorough drug policy for di world. Fentanyl na di United States wahala.”

For Trump first term, e sama tariffs on China to cut trade deficit, wey be di gap between how much US dey buy from China and wetin dem sell give China.

Wen Trump introduce di tariffs for 2018, US bin buy $418bn of goods from China pass wetin dem sell to dem.

Trump see am as drain on US economy and for January 2020 gree to deal wey make China buy $200bn more goods but e don dey hard to do.

But last year di deficit wey don dey dance alingo drop to di lowest wey e don be since 2010 wey be $279bn.

Mexican President Claudia Sheinbaum

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mexican President Claudia Sheinbaum

While Mexico don sama Trump threat back from plenti angles, Di head of Mexico Senate sama for X say which kain tariffs make Mexico give US so dem go stop to dey take drugs and illegally export weapons give im southern neighbour.

Di finance minister don warn bifor say any tax wey dem sama Mexico goods go make dem do dia own back.

Mexican President Claudia Sheinbaum don ansa di threat of tariffs say no be wetin go stop di migration mata or drug wahala for di US. She warn say if US do dis tariff tin, she go do her own back and dat go "put common enterprises at risk".

Germany vice-chancellor, Robert Habeck don chook mouth inside say las-las everibodi go loose.

According to Reuters, e tok say di European Union must to “respond united no be say e go come tear imself into two or three blocs of kontris but e must to speak as unted Europe”.

E add say, “we must to clear am say las-las na evriboi go loose, weda na di United States o, di United States economic area o, abi na Europe”.

Donald Trump announcement don cause gbege for di currency markets as traders dey run upandan to understand di move.

At first, di US dollar bin jump in value as opposed to di currency of di kontris wey di tariffs dey tarket. E rise by ova 2% agains di Mexican peso and hit di highest level e don hit for four and half years against di Canadian dollar.

Di US dollar also strong against oda currencies, even though e don lose some of di gains e get bifo. As for share prices for Europe, dem fall as investors dey worry about wetin fit be di impact.