Di president and di porn star: Who be Stormy Daniels, and wetin happun wit Donald Trump?

Collage showing Donald Trump (left) and Stormy Daniels

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Former President Donald Trump deny di accuse of Stormy Daniels
    • Author, Mattea Bubalo & Robin Levinson King
    • Role, BBC News

Donald Trump dey on trial on top charges wey link to di hush money payments wey dem give blue feem actress Stormy Daniels.

E be di first former US president wey go stand for criminal trial - for case wey dey koko becos say im allegedly lie for business records to make di payments.

Ms Daniels claim say she and Oga Trump nack, and say she collect $130,000 from im former lawyer before di 2016 election so she no go tok about wetin happun.

Di lawyer wey be Michael Cohen later go jail for multiple charges.

Since di accuse show face for 2018, di former president don deny say e nack Ms Daniels.

Who be Stormy Daniels

Ms Daniels, 45, wey her real name na Stephanie Clifford, na blue feem star and director wey dem born for Louisiana and don win plenti awards for her feem work.

She don also act for mainstream Hollywood feems, wey include 2000s movies like The 40-Year Old Virgin and Knocked Up.

She also try enta politics and and bin dey call herself Republican wey be di same party as Oga Trump.

Stormy Daniels pose for one 2017 adult entertainment convention.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Stormy Daniels, wey her real name na Stephanie Clifford, tok say she meet Donald Trump for 2006

Daniels affair claim

Ms Daniels bin tok for interviews say she bin meet Oga Trump for one charity golf tournament for July 2006.

She tok say di two of dem nack once for im hotel room for Lake Tahoe wey be resort area wey link California and Nevada. One lawyer for Oga Trump deny dis one dat time.

She tell di interviewer wey bin ask if Oga Trump bin tell am to lock up about dia alleged nackis say, "e bin no look like say im bin dey worry about am. E bin dey kind of proud."

Oga Trump wife, Melania Trump bin no go dat tournament as she just born.

Donald Trump and im wife and youngest child smile for di unveiling of im star on di Hollywood Walk of Fame.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump, Melania Trump and Barron Trump for January 2007

Threats and payments to stay silent

Ms Daniels say oga Cohen pay am $130,000 as "hush-money" so she no go tok about di affair, just days before di 2016 election wey oga Trump win.

She say she collect am becos she bin dey fear for her family safety. Ms Daniels say she bin dey threatened legally and physically make she no tok.

For 2018, Ms Daniels bin remember how one man wey she no know bin come meet am and her baby daughter for Las Vegas parking lot seven years before, and di man tell am make she "leave Trump alone".

She tok say dis one bin happun shortly afta she bin gree to do interview for In Touch magazine about di alleged affair.

She tell CBS 60 Minutes say, di stranger bin tell am say, "dat na fine little girl, e go be shame if sometin do her mama".

Before di episode comot, one shell company wey get link to oga Cohen threaten Ms Daniels wit $20m lawsuit say she bin break dia non-disclosure deal (NDA), or "hush agreement".

Ms Daniels tell di CBS show say she dey risk one million dollar fine say she tok for national television but "e dey very important for me to defend myself".

No be until 2018 wey In Touch release her interview in full. Dis na three months before di 60 Minutes episode.

E dey illegal to pay hush-money?

E no dey illegal to pay someone money as compensation for NDA.

But prosecutors dey focus on di way dem record oga Cohen payback for oga Trump account. Dem dey accuse am say im lie for business records say di payments na for legal fees.

Di wire transfer bin come just before before di presidential election. District Attorney Alvin Bragg allege say oga Trump bin try "to hide crimes wey hide damaging informate from di voting public".

For August 2018, oga Cohen bin gbab prison sentence afta im plead guilty to tax evasion and breaking campaign finance rules, wey dey partially linked to im payment to Ms Daniels and anoda oga Trump alleged lover.

Even though say e don tok before say Trump bin no get hand for di payments, oga Cohen later testify under oath say oga Trump bin direct am to pay di $130,000 hush-money.

E also say di president give am back di money.

Michael Cohen

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Michael Cohen bin go prison for how im participate for di pay-off

Wetin Trump don tok?

Oga Trump don plead not guilty for one Manhattan criminal court to 34 felony counts of lying for business records in di first degree.

E bin dey indicted in relation to di money dem pay Ms Daniels. E bin also dey under investigation sake of pay-offs to one former Playboy model so she no go tok about dia alleged nacks.

Before im trial start, Trump bin yab di judge for im case, wey im call Democrat-led "witch hunt".

Why dis mata dey important?

President Trump supporters, even di religious right, don shake off im past attitude and women accusation against am.

But di Manhattan case dey happun for election year and fit comot di Republican frontrunner for president from campaigning as e suppose last for six weeks.

Oga Trump don promise before say e go go court for day and campaign for night. As criminal defendant, e most to dey court and Justice Juan Merchan don threaten say e go bring arrest warrants for absences and dis fit bring wahala to im campaign plans.

But even if dem criminally convict am, e no go stop Trump to continue im presidential campaign, according to BBC North America tori pesin, Anthony Zurcher.

"In fact, nothing dey for inside US law wey stop candidate wey dey guilty of crime to campaign or to serve as president, even from inside prison."