How day one of Trump hush money trial waka

Donald Trump for court trial day one for im criminal case

Wia dis foto come from, Getty Images

Donald Trump first criminal trial start on Monday, with a full jury wey dem swear in on Thursday.

Mr Trump, 77, dey charged with 34 counts of fraud, related to hush-money wey dem pay to porn star Stormy Daniels before di 2016 election.

E don plead not guilty to 34 counts of falsifying business records and also deny say e get affairs with Daniels.

Ms Daniels allege say she and Mr Trump nack for 2006 - something wey e don deny - and say dem pay her money to stay quiet about am in di lead-up to di 2016 election, wey Mr Trump win.

Di trial dey centred on one reimbursement Mr Trump make to im former personal lawyer and "fixer", Michael Cohen.

Cohen, 57, claim say dem direct am to pay Ms Daniels $130,000 (£104,000) in exchange for her silence about her alleged affair with Mr Trump. Prosecutors don describe am as an attempt to "unlawfully influence" di 2016 election.

Hush money payments no dey illegal. But di Manhattan District Attorney Office allege say Mr Trump commit crime by improperly recording di money wey e use take reimburse Cohen as legal expenses.

In total, dem dey accuse am of 34 counts of falsifying business records in di first degree.

Dis now how di mata waka so far on Day one.

Trump trial updates as e happun on Day one

Di court case wey start even wit di wahala to get di jury wey go run di case, still get some comma.

Justice Merchan postpone di trial time small sake of say one of di jurors bin get emergency dental appointment.

According to di Justice, anoda juror don dey fear sake of di media attention di case get and "no sure if dem wan even dey here today".

Las-las, di juror gree to remain afta small jor-jor for im robe room.

Donald Trump dey raise im fist give camera pipo as im dey waka go court

Wia dis foto come from, Reuters

As Donald Trump bin dey enta court for di first day of di historic trial of a former president, e stilll stop to follow tori pipo tok.

E repeat im belief say di trial na "very unfair" kind of "election interference".

Di Republican nominee also use di opportunity to tok about im recent civil judgement for New York. E complain say state attorney general Letitia James dey "question di bonding company" wey e take put im $175m bond payment.

Dem still get hearing for di bond mata today too. Trump get case for two judges front for Monday morning.

E tok say "I get plenti money to pay" before e call New York "di most unfriendly place to do business".

Before e enta court room, e end di tok-tok say "na very very sad day for America".

Court Drawing of Matthew Colangelo as im dey make im opening statements

Wia dis foto come from, Reuters/ Jane Rosenberg

Wetin we call dis foto, Prosecutor Matthew Colangelo as im dey make im opening statements

Matthew Colangelo from di prosecution na im arrange wetin di state get against Trump.

E tok say before di 2016 election, Trump pay im den lawyer Michael Cohen money to pay am back for di money im bin send to blue feem star Stormy Daniels so she no go tok about di alleged "sexual encounter wit di defendant", Trump.

Colangelo claim say di payment na Trump ask for am so e no go affect im campaign, wey prosecutors call election interference.

Trump tok for im business records say di money na for "legal services wey dey according to a retainer agreement".

Oga Colangelo say dat one na lie.

Colangelo also explain how dem take reach di 34 charges of falsifying business records wey Trump dey currently face take happun.

Na from di different kain alleged false records, wey be three, dem include 11 invoices wey prosecutors say na lie for wetin di Trump payment dey for, 12 allegedly false ledger entries for di Trump Organization system, and 11 cheques wey allegedly falsely tok wetin di payment bin dey for.

Di background of di case according to prosecution na di alleged "catch and kill" scheme wey Donald Trump, di National Enquirer Publisher David Pecker and Cohen bin enta agreement say dem go do beta tori for Trump, yab im rivals and most importantly listen to any tori wey go damage Trump image and stop am to comot.

Michael Cohen dey waka for busy road

Wia dis foto come from, Getty Images

Colangelo come tok about di $130,000 payment to Stormy Daniels and how Cohen take hide am.

Dem say Michael Cohen bin create shell company for di payment.

Dem say Trump bin approve make dem pay Cohen $420,000 ova some time wit some checks, wey include repayment for Stormy Daniels money.

Colangelo also explain how Michael Cohen go serve as key witness for di case.

Dat one get comma sake of im criminal history, and say im don bash Donald Trump publicly since im comot prison but prosecution say dem get evidence for every testimony wey im go give.

Donald Trump wit im lawyer, Todd Blanche

Wia dis foto come from, Getty Images

Donald Trump lawyer wey be former federal prosecutor, Todd Blanche start im opening statement say di election fraud wey prosecutors dey try bring up against Trump no be fraud.

E say, "I get spoiler alert... nothing dey wrong wit trying to influence election. Na democracy dem dey call am."

E also tok about di 34 counts wey dey on trial, e argue say Trump no dey personally involved in all di paper work wey take place for di replacement of Michael Cohen say, wen im sign any cheque give Cohen na sake of say na im be di only signatory or im personal account.

Blanche also try to discredit di prosecutor star witness Michael Cohen say e dey obsessed wit Trump, even as im call am convicted felon and admitted liar.

Blanche say, "E don tok well-well about how e wan see say President Trump go prison, E get obsession wit getting Trump."

E also blast anoda key witness, Stormy Daniels say "although her testimony dey salacious, e no dey important".

Dis na becos she no know about di documents wey be di koko of dis case wey be di allegedly fraudulent invoices of Cohen, how dem bin dey paid or recorded.

David Pecker for 1995

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, David Pecker for 1995

Di prosecutors end di first day of trial wit question for dia first witness David Pecker as dem dey build dia theory on di "catch and kill scheme".

Pecker wey be di former CEO of American Media Inc, give testimony of how im bin dey work.

According to am, na im get final say of weda tori go dey published for any of di tabloids wey America Media Inc (AMI) get.

E also tok about di role wey Dylan Howard wey bin dey work as editor-in-chief of di National enquirer be for di time wen di alleged catch and kill scheme dey happun.

Dis one cause quarrel between di lawyer afta di judge end proceedings for di day. Trump lawyer wan comot wetin Pecker tok about Howard say na hearsay but prosecution say e go explain why Howard no dey testify.

Stormy Daniels

Wia dis foto come from, Reuters

Dis trial, wey go be di first criminal trial for US ex-president, na for business fraud wey connect wit di hush money payment wey dem pay ex porn star Stormy Daniels.

Prosecutors dey allege say Trump make im personal lawyer, Michael Cohen pay di money but den Trump record am fraudulently say im pay di money to Michael Cohen to repay am for legal expenses wen na payback for di hush-money payment. Na wia di alleged offence dey be dat.

Di former president dey face 34 count of fraud under campaign finance laws, e don plead not guilty to all of dem. E also say e no nack Daniels.