First batch of white South Africans don land for US under Trump refugee plan

Woman hold US flag for demonstration

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Some white South African farmers dey show support for President Trump
Read am in 4 mins

Some white South Africans wey comot from dia kontri on Sunday don land for di United States.

Na one private charter plane carry dem afta di US give dem refugee status.

President Trump administration under one new program bin announce for February say dem go give di White Afrikaners refugee status.

Di group of 49 wey include families and small pikin dem, land for Dulles international airport outside Washington DC on Monday.

Dis dey come afta pipo bin dey wonder wen di Afrikaners go relocate go America, even though di South African goment describe di US resettlement scheme as "politically motivated".

Relations between South Africa and di US don get K-leg for months, afta Trump executive order for February.

President Trump bin tok say Afrikaners na victims of "racial discrimination".

Dis pipo na di first Afrikaners set wey be white minority group for South Africa to relocate afta Donald Trump give di executive order.

Tori be say di Trump administration work on dia applications sharp-sharp as dem match brake for oda refugee programs.

Dem put on hold refugees from Afghanistan, Iraq, most of sub-Saharan Africa and oda kontris for a move wey dem dey challenge for court.

Meanwhile, some of di refugee groups dey ask question why di Trump administration dey give white South Africans sharp-sharp treatment while pipo from oda kontris wey dey struggle wit war and natural disasters no get di needed attention.

To get approval for refugee status for di US dey take years.

Di Trump administration say di South African goment dey pursue racism wit dia policies wey no dey favour di-whites for South Africa.

E accuse dem say na through affirmative action laws and one new land law wey dey target di land wey Afrikaners get.

Earlier, di South African goment bin say di claims of di Trump administration dey based on misinformation and notin like racism against Afrikaners and dem neva collect any of dia land.

Di groups wey dey represent di rights of white farmers bin tok say dem dey deliberately kill dem becos dem be white.

For statement on Friday, South Africa foreign ministry say di accuse wey US sama dia goment say dem discriminate against di white minority for di kontri dey "unfounded" and di US relocation scheme na attempt to undermine di kontri" constitutional democracy".

Di statement add say di kontri bin work "tirelessly" to stop discrimination, sake of dia history of racial oppression under apartheid.

Bilateral kasala dey happun between President Trump and South African goment as im order im administration to make plans wey go relocate di Afrikaners - one group wey get mostly Dutch ancestry, to di US.

Elon Musk, wey be top adviser for di Trump administration wey grow up for South Africa during apartheid, dey critical of Pretoria, wia im claim say dey lead for "genocide" against white farmers.

US media bin tok say na around 54 Afrikaners wey go arrive as part of di first group. but na 49 travel.

Na di law wey di South African goment pass dey cause dis criticism for South Africa.

Di South African goment say no justification for dem to relocate but im no go stop dem and im respect dia freedom of choice.

One White South African carry placard wey dem write "Refuge Please" ontop as e stand behine US flag.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Some Afrikaners for South Africa bin come out for public to support di US president and im refugee plan for dem

Who qualify for di US relocation

Bifor you apply, you must be of South African nationality and you must be of Afrikaner ethnicity or be a member of any racial minority for South Africa.

Must also dey able to tok about past experience of persecution or how you dey fear future persecution.

If you meet all dis requirement, you go fill di statement of Interest form.