You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Anthony Joshua driver appear in court afta accident wey kill two pipo
Magistrate court for Sagamu Ogun state don adjourn di trial of di driver wey drive boxer Anthony Joshua SUV wey get accident wit di boxer inside.
Mr Adeniyi Mobolaji Abiodun appear for court Tuesday morning to start him trial.
E dey face charges wey include causing death by dangerous driving, negligent driving, driving without duty of care and driving without valid driver's license.
Dis na after di driver get accident wen e carry international boxer for Sagamu road for December. Two of Joshua personnel die instantly for di location of di accident.
Wetin happun for court
Di prosecutor Richard Ningiwe tell court say him need more to seek legal advice from di officer of di attorney general of di state before e go proceed wit di case.
E say "i don study di case and I go need legal advice to how to proceed wit di case, dis na to make sure justice reach all di parties involved.
E tell court say wen di case start im plan to call 4 witnesses, say three of dose witnesses dey court dat morning.
Counsel to di driver Otumba Abiodun object di request say di prosecutor bin get enough time to prepare for di case, but e wan use dis request to drag di case.
Di magistrate adjourn di case to February 25 2026. She say dis na for best interest of justice.
Kayode bin comot from police custody afta court grant am bail in di sum of five million naira ($3,800) wit two sureties.
Mr Kayode wey dey 46 years bin dey drive wen di fatal accident kill Anthony Joshua personal trainer Latif Ayodele and im strength and conditioning coach, Sina Ghami
Tori be say di driver dey face four count charges wey include dangerous driving wey cause death, reckless and negligent driving, driving without due care and attention, driving without valid national driver's license.
Na December 29, 2025, di accident bin happun along di Lagos-Ibadan Expressway wen e go jam truck wey park for corner of di road wen e bin dey try to overtaking according to police.
Meanwhile, British heavyweight boxer Anthony Joshua don return since to di UK afta dem discharge am from hospital for Nigeria days afta di fatal car accident happun.
Di former world champion dey deemed fit to recover for house, di Ogun and Lagos states govment tok for inside one joint statement.
Di statement say e dey "heavy hearted and full of emotions" ova di loss of im friends.
Di 36-year-old na passenger for inside one Lexus SUV wey jam one truck wey dem park for one major expressway for Ogun State, near Lagos, on Monday.