Anthony Joshua discharged from hospital afta fatal car crash for Nigeria

    • Author, Chris Graham
  • Read am in 3 mins

Dem don discharge British heavyweight boxer Anthony Joshua from hospital for Nigeria days afta one fatal car accident wey kill two of im close friends.

Di former world champion dey deemed fit to recover for house, di Ogun and Lagos states govment tok for inside one joint statement.

Di statement say e dey "heavy hearted and full of emotions" ova di loss of im friends.

Di 36-year-old na passenger for inside one Lexus SUV wey jam one truck wey dem park for one major expressway for Ogun State, near Lagos, on Monday.

Di two men wey die na Joshua close friends and team members Sina Ghami and Latif "Latz" Ayodele.

Afta e comot for di hospital on Wednesday, 1 January, di Briton and im mother bin visit di funeral home wia dem dey "prepare dia bodies for repatriation to pay dia last respects", di joint statement add.

Earlier, Eddie Hearn, wey dey promote Joshua since e bicom professional afta e win gold for di 2012 Olympics, don pay tribute to Joshua close friends and team members.

"Rest in peace Latz and Sina," Hearn bin post on Instagram.

"Your energy and loyalty among so many oda great qualities go dey deeply missed. Praying for strength and guidance for all dia family, friends and of course AJ during dis very difficult time."

Ghami na Joshua full-time sport and exercise rehabilitation coach and e bin work wit am for more dan 10 years.

Speaking to di BBC on Wednesday, Ogun State police tok-tok pesin Oluseyi Babaseyi say "investigations still dey go on" and e describe di process as "still discreet".

Di Traffic Compliance and Enforcement Agency (TRACE) for Ogun state, wia di accident bin occur say, preliminary investigations show say di vehicle tyre bin burst bifor e crash enta di truck.

Joshua, wey dem born for Watford to Nigerian parents, bin dey on holiday for Nigeria afta im victory ova Jake Paul for Miami on 19 December.

Earlier, Tony Bellew, di retired cruiserweight world champion, posted on X: "Thoughts and prayers to di families of these men. Tragic losses in horrific circumstances!

"I hope (Joshua) go fit process dis wit time bicos no pain for life worse pass grief."

Two-time undisputed heavyweight champion Oleksandr Usyk and British former heavyweight champion Tyson Fury bin also post Instagram stories to offer condolences.