Peter Obi dump Labour Party for ADC

Read am in 4 mins

Di presidential candidate of di Labour Party for di 2023 presidential election for Nigeria, Peter Obi, don officially declare membership for di new join-bodi opposition party wey be African Democratic Congress (ADC).

Obi make di declaration dis Wednesday for one ogbonge political gathering for Enugu State.

Also, many of di remaining LP lawmakers for di National Assembly, like Senator Ireti Kingigbe of di Federal Capital Territory, Senator Tony Nwoye of Anambra North, and Senator Victor Umeh of Anambra Central also follow Obi comot from LP to ADC.

Former Deputy Speaker of di House of Representatives Emeka Ihedioha also dey for di gathering, and even pipo like Enyinnaya Abaribe, who bin win Abia South Senatorial seat wit di All Progressives Grand Alliance (APGA) for 2023, also declare say e don join ADC.

Remember say Obi bin dey for di event for July dis year, wia top top oga dem for Nigeria politics from various parties including di ruling All Progressives Congress, officially adopt ADC as di vehicle wey go carry di new opposition political joinbodi for Nigeria, but di former Anambra State guvnor bin no officially tok dat time say e dey leave Labour Party, e just say e attend di event as one of di opposition leaders for di kontri.

However, for di Enugu event dis Wednesday, Obi tok say "today na di last day of 2025, so we dey end dis year wit hope say for 2026, we go start di journey of di rescue of our kontri for proper socio-economic development wey go dey unifying and inclusive".

"Dis decision (to join ADC) dey guided solely by patriotism and national interest. I now respectfully call on my political associates, di Obidient Movement and opposition leaders across di kontri to join dis broad national coalition under di African Democratic Congress. History no go forgive silence in moments of national peril," e tok.

Obi tok say im follow for di coalition from day one, from wen dem still dey discuss am to wen dem launch officially, so e no be like say e dey join already made party.

Popular rights activist Aisha Yesufu also attend di event for Enugu and she tok say she neva be memba of any political party for her life, but now she go bicom card-carrying member of ADC.

Fourth time lucky?

Dis go be di fourth political party wey Peter Obi dey belong to since e join politics.

Di first na APGA wia e win di Anambra State govnorship election for 2023 and e do two terms of four years each.

Afta im tenure as guvnor, Obi join di Peoples Democratic Party (PDP) sake of say e fall out wit im successor Willie Obiano.

For di 2019 general election, Obi even run for di office of Vice President of Nigeria wit former Vice President Atiku Abubakar as President on top PDP, but dem lose to Muhammadu Buhari and Yemi Osinbajo.

Den bifor di 2023 general elections, as Obi calculate say e fit no win di PDP presidential primary elections, e decamp to di Labour Party wia e get di presidential ticket but come third for di election proper behind President Bola Tinubu and Atiku Abubakar.

Wit dis recent development of Obi joining di ADC, e neva clear weda e go get wetin e dey look for.

Obi back wit Atiku

Peter Obi don go back to familiar foes, abi na friends for di ADC, especially im former principal Atiku Abubakar who bin pick am as running mate for 2019, even though dem later part ways by di 2023 general election.

Even now, tori be say Atiku still dey nurse ambition and e bin tok for one gathering say e no go step down for anibodi for 2027.

As e dey tok on Wednesday, Obi call for unity among di opposition members so dat dem go fit achieve dia aim of Nigeria wey go beta for evribodi.