Trump wan carry out '100%' Greenland tariff threat, as EU stand to protect dia interest

    • Author, Thomas Mackintosh
    • Author, Tabby Wilson
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Donald Trump don vow say e go '100%' carry out im threat to impose tax on European kontris wey no gree to im demand to take ova Greenland.

European allies don stand gidigba for Greenland sovereignty. Denmark foreign minister don make am clear say US president no fit use threat to claim ownership of di semi-autonomous Danish territory.

UK Foreign Secretary Yvette Cooper tok say di UK position be say di future of Greenland na for 'Greenlanders and di Danes alone' to decide.

On Monday, Trump decline to rule out di use of force, and im dey insist say e go continue wit di threatened tax wey go affect goods arriving from UK and seven oda Nato kontris.

Inside one social media post wey im post ontop Truth Social early on Tuesday morning, di US president tok say im get one "beta telephone call" wit Nato secretary general Mark Rutte, and dem agree make dem meet "for various parties" in Switzerland dis week.

E tok say: "Greenland dey very imperative for National and World Security. No going back — On dat everybody don gree!"

Trump don tok say im go charge Britain 10% tariff "on any and all goods" wey dem send go US from 1 February, e go increase to 25% from 1 June, until dem reach a deal wit Washington to buy Greenland from Denmark.

E tok say di same go apply to Denmark, Norway, Sweden, France, Germany, di Netherlands and Finland - all of dem na members of di defence alliance Nato wey dem start in 1949.

Wen dem ask am if e go follow through on di tariff threat, Trump tell NBC News: "I go do am, 100%."

Wen di outlet ask weda e go use force to take di territory, di president reply "no comment."

Trump add say: "Europe suppose focus on di war wey dey happun wit Russia and Ukraine, you don see wetin e don bring for dem... Na wetin Europe suppose focus on - no be Greenland."

Denmark don warn say if US do military action for Greenland, na im go end Nato.

In recent days, Greenland don get support from European members alliance - some even send small troops go Greenland last week just to show say dem dey dia.

However, Trump follow di deployment to annouce tariffs on di eight Nato allies.

Danish foreign minister Lars Løkke Rasmussen tok say Europe gatz show President Trump say im tariff threat "no be di way forward."

"We get red lines wey no suppose cross," e tell Sky News. "You no fit threaten your way to own Greenland. I no get plan to make dis matta worse."

Germany Chancellor Friedrich Merz tok say di tariffs no benefit anyone, and e hope to meet wit US president during im trip to Davos for World Economic Forum.

E tok say: "We no want dis escalation. We no wan trade fight wit United States of America."

E also add say di Trump administration no go dey surprise say Nato reconnaissance mission ova di weekend, as dem don announce am and agree before.

"No be military action at all," di German chancellor tok.

Di European Union go hold emergency summit for Brussels on Thursday to meet dia leaders discuss how to reply Trump latest threat to take over Greenland.

Kaja Kallas, di EU foreign policy chief, tok say di bloc "no get interest to start fight, but dem go hod dia ground."

"But trade threat no be di way we go about dis," Kallas add. "Sovereignty no fit be for trade."

Dem don release text message wey Trump and Norway prime minister exchange - wey show say on Sunday, US president blame Norway say na dem cause am make e no win Nobel Peace Prize.

For im reply - wey BBC see - Jonas Gahr Støre tok say na independent committee, no be Norway govment, award di prize wey dem give last October but e go to Venezuela opposition leader María Corina Machado.

"Norway position on Greenland dey clear. Greenland na part of Kingdom of Denmark, and Norway dey support Denmark on dis matta," Støre add.

Trump also address di text message for one interview on Monday and say: "Norway dey totally control [di Nobel Prize] no matter wetin dem tok.

"Dem sabi say dem no get anytin to do wit am, but dem get hand for everything wey get to go wit am."

Meanwhile, di North American Aerospace Defense Command (Norad) annouce say multiple aircraft dey come to Pituffik Space Base for Greenland on Monday.

Di joint US-Canada military defence organisation don stress say part of dia routine operation na to "support various long-planned Norad activities," and dem also tok say dem don coordinate am wit Denmark and dem don inform Greenland govment.

Similar Norad operations happun for dat base in 2022, 2023, and last year.