You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
European military personnel land Greenland as Trump insist say US need di island
- Author, Paul Kirby
- Role, Europe digital editor
- Read am in 5 mins
One small French military contingent don arrive for Greenland capital Nuuk, officials tok, as several European states deploy small numbers in one so-called reconnaissance mission.
Di limited deployment, wey also involve Germany, Sweden, Norway, Finland, di Netherlands and di UK, come as US President Donald Trump continue to press im claim to di Arctic island, wey be semi-autonomous part of Denmark.
French President Emmanuel Macron say di initial contingent go dey reinforced soon wit "land, air, and sea assets".
Senior diplomat Olivier Poivre d'Arvor see di mission as sending a strong political signal: "Dis na di first exercise... we' go show di US say Nato dey present."
Poivre d'Arvor say di initial French deployment involve 15 pipo hours afta Denmark and Greenland foreign ministers bin travel to Washington for one meeting wit di US Vice-President JD Vance on Wednesday.
Following di meeting, Danish Foreign Minister Lars Lokke Rasmussen say while di tok-tok dey constructive, one "fundamental disagreement" still dey between di two sides and later dem criticise Trump bid to buy Greenland.
Trump, meanwhile, double down on im bid to bring Greenland under US control, e tell reporters for di Oval Office say, "we need Greenland for national security". Although im bin no rule out di use of force, im tok late on Wednesday say im tink say dem fit do sometin wey fit work out wit Denmark.
"Di problem, e no get anytin wey Denmark fit do about am if Russia or China want to occupy Greenland, but we fit do evritin wey we fit do. You see am last week wit Venezuela."
Polish Prime Minister Donald Tusk say Poland no get any plan to join di European military deployment to Greenland, but warn say any US military intervention there "go be political disaster".
"A conflict or attempt to cut-off di territory of a Nato member by anoda Nato member go be di end of di world as we know am - and which for many years guarantee our security," im tell tori pipo.
Meanwhile, Russia embassy for Belgium dey express "serious concern" sake of wetin dey hapun for di Arctic, accusing Nato say dem dey build up military presence there "under di false pretext of growing threat from Moscow and Beijing".
However, di European Nato deployment consists of only few dozen personnel as part of Danish-led joint exercises wey dem call Operation Arctic Endurance. While e get heavy symbolism, e bin no dey immediately clear how long dem go stay.
Germany bin send one A400M transport plane to Nuuk on Thursday wit a contingent of 13 soldiers, although officials say dem go stay for Greenland only until Saturday.
Danish defence officials say dem don decide wit di government of Greenland say military presence go increase around Greenland in di coming period to boost Nato "footprint for di Arctic for di benefit of both European and transatlantic security".
Macron, for im new year address to France armed forces, say Europeans bin get special responsibility to Greenland "because dis territory belong to di European Union and na also one of our Nato allies".
Di US already get military base for Greenland, wey get up to 150 pipo as staff, and e get di option of bringing in far greater numbers under existing agreements wit Copenhagen. But e be like say di Danish-led initiative dey signal di Trump administration say dia European allies also get stake for security for di Arctic and North Atlantic.
Sweden prime minister say dem bin don send Swedish army officers to Nuuk on Wednesday. Two Norwegian sojas, two Finnish liaison officers, one British military officer and one Dutch naval officer also go there.
Downing Street say di UK bin share President Trump concern about "di security of di High North", and say di deployment bin involve "stepping up wit stronger exercising, to stop di Russian aggression and di Chinese activity."
Danish Prime Minister Mette Frederiksen tok on Thursday say defence and protection of Greenland na common concern for di entire Nato alliance.
Danish Defence Minister Troels Lund Poulsen say di intention na to get military presence "in rotation", wit di aim of having more permanent military presence for di island wey foreign allies go take part for di exercise and training activities too.
Copenhagen don argue wit Trump justification why im wan control Greenland. Rasmussen, dia foreign minister, tok on Wednesday say no "instant threat" from China or Russia wey Denmark and Greenland no go fit accommodate, although im bin share American security concerns to some extent.
One Democratic-led US delegation dey due to visit Denmark on Friday for tok-tok wit Danish MPs.
Rasmussen bin tok alongside Greenland foreign minister afta tok-tok wit Vance and US Secretary of State Marco Rubio on Wednesday.
"Di president ambition dey on top di table," di Danish diplomat tell Fox News. "Of course we get our red lines. Dis na 2026, you trade wit pipo but you no go trade pipo."
Greenland Prime Minister, Jens-Frederik Nielsen, tok say dis week, di territory bin dey in di middle of geopolitical crisis, and say if dem bin ask im pipo to make a choice dem go choose Denmark over di US.
"Greenland no want di United States to claim dem. Greenland no want di United States to govern dem. Greenland no want to be part of di United States," im add..