You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Iran warn say dem go revenge if US attack dem, as hundreds die for protests
- Author, Shayan Sardarizadeh
- Author, Richard Irvine-Brown
- Role, BBC Verify
- Author, Ghoncheh Habibiazad
- Author, Sarah Namjoo
- Role, BBC Persian
- Read am in 6 mins
Iran don warn say dem go retaliate if US attack dem, BBC sources and activists dey report say hundreds of protesters don die now as govment crackdown dey increase.
"One source for Tehran tok for Sunday say, 'Tins for hia don really bad well well. Plenty of our friends don die. Dem dey shoot live bullets. E be like war zone, streets full of blood. Dem dey carry deadi body dem comot wit truck.'"
BBC count about 180 bodi bags for video wey come from one mortuary near Tehran. Human Rights Activist News Agency wey dey US say dem don confam death of 495 protesters and 48 security personnel across di kontri.
Di agency still tok say anoda 10,600 pipo don dey detained within di two weeks of di unrest.
Di US don threaten say dem fit intervene for Iran becos of di killing of protesters, but for Sunday, US President Donald Trump tok say Iranian leaders don call am and say "dem wan negotiate".
But e den add say US "fit need to act bifor any meeting happun".
Trump no explain exactly wetin US dey plan, but for Sunday e tok say "we dey look some very strong options". One official tell BBC US partner CBS say Trump don dey briefed on options for military strike against Iran.
Oda options fit include boosting anti-govment voices online, using cyber-weapons against Iran military, or putting more sanctions, officials tell Wall Street Journal.
Speaker of Iran parliament warn say if US attack dem, both Israel and US military bases and ships for di region go bicom legit targets.
Di protests wey start sake of high cost of living don now turn to calls to end di clerical rule of Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei.
Iran attorney general tok say anybodi wey protest go be seen as "enemy of God" – offence wey fit lead to death sentence – while Khamenei don dismiss protesters as "group of vandals" wey dey try to "please" Trump.
For Sunday, di kontri announce three days of mourning for wetin dem call "martyrs wey die for Iran national battle against di US and Israel".
Staff for several hospitals tell BBC say dem don dey overwhelmed with dead and injured protesters for recent days.
BBC Persian confirm say 70 bodies reach one hospital for Rasht city for Friday night, while one health worker for Tehran hospital tell BBC say:
"Around 38 pipo die. Many die immediately dem reach emergency bed… direct gunshots to di head of young pipo, even to dia hearts. Plenty of dem no even reach hospital."
BBC and most international media no fit report from inside Iran bicos Iranian govment don impose internet shutdown since Thursday, wey dey make am hard to get and verify information.
Some videos don come out, including one wey show rows of bodi bags for Forensic Diagnostic and Laboratory Center of Tehran Province – one mortuary for Kahrizak.
For one of di videos, about 180 bodies wey don cover or wrap dey visible, most of dem dey lie outside. Pipo dey shout and cry as dem dey look for dia loved ones.
Di videos don blur faces to protect di identity of pipo wey still alive, bicos dem fit face more persecution from authorities.
Several videos wey BBC Verify confam say dem be recent show clash between protesters and security forces for Mashhad, Iran second-biggest city.
For di videos, masked protesters dey hide behind dustbins and bonfire, while line of security forces dey far front. One vehicle wey look like bus don catch fire.
Plenty gunshots dey sound, plus noise wey sound like pipo dey knock pot and pan.
One person wey stand for nearby bridge dey fire several gunshots for different directions as some pipo dey take cover behind fence.
For Tehran, one verified video from Saturday night show protesters don take over streets for Gisha area, sound of pot knocking for Punak Square, and crowd dey march and shout make clerical rule end for Heravi area.
Iran President Masoud Pezeshkian don blame di US and Israel for di wahala.
E say: "Dem train some pipo inside di kontri and outside, bring terrorists enter Iran from outside, burn mosques, and attack markets and trade groups for Rasht, even set di market on fire," but e no bring any proof.
But video wey BBC Persian and BBC Verify don confirm show say Iran security officers don dey shoot at gatherings of protesters for different areas. Dem places include Tehran, western Kermanshah province, and southern Bushehr region.
Plenty verified videos wey dem record for di centre of di western city Ilam last weekend still show security forces dey fire gun towards Imam Khomeini Hospital, where protesters gather do rally.
Internet access for Iran don reduce well-well to only local network, wit very small connection to outside world. But during dis current protest, authorities don for di first time lock am down even more seriously.
One expert tell BBC Persian say dis shutdown bad pass wetin happun during di "Women, Life, Freedom" protest for 2022.
Alireza Manafi, wey be internet researcher, say di only way wey fit connect to outside world na through Starlink satellite, but e warn say pipo suppose careful becos govment fit still trace such connection.
Shah pikin tell protesters say: 'I know say I go soon dey wit una'
On Sunday, Reza Pahlavi, di son of Iran last shah wey dey exile and dey live for US, wey protesters dey call make e come back, tell demonstrators say Trump don "watch una courage well-well" for one message wey e post for social media.
E write say "Una pipo all over di world dey proudly shout una voice," and e promise say "I know say I go soon dey wit una."
Pahlavi claim say di Islamic Republic don dey face "serious shortage of mercenaries" and say "plenty armed and security forces don leave dia duty posts or refuse to follow order to suppress di pipo". BBC no fit independently confirm dis claims.
E encourage pipo make dem kontinu to protest Sunday evening, but advise dem make dem stay in groups or crowds and no "put una lives for danger".
For UK, videos wey pipo share for social media seem to show protesters dey remove Iran flag from balcony of Iran embassy for London both Saturday and Sunday.
Iran don call di UK ambassador for Tehran afta di incidents, according to Iran state media.
Di protests na di most widespread since di 2022 uprising wey start afta Mahsa Amini die for police custody. Mahsa Amini na young Kurdish woman wey morality police arrest bicos dem say she no wear her hijab well.
According to human rights groups, more dan 550 pipo die and about 20,000 pipo arrest by security forces within several months.